BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | PSALMS 69-73
Jehovah People Dey Use All Their Mind Serve Am for the Correct Way
Make people see sey we dey use all our mind serve God for the correct way
69:9
Till David die, e show sey e dey use all im mind serve Jehovah
David no dey gree for anybody wey dey use God name play or people we dey spoil Jehovah name
People wey don serve God tey tey fit help young people make dem use all their mind serve God
71:17, 18
The person wey write this psalm wey fit be David, show sey im go like encourage the people wey dem go born after im time
Papa and mama and people wey don dey serve Jehovah tey tey fit train young people
If we dey use all our mind serve God, that one go move us to tell other people wetin God kingdom go do for everybody
72:3, 12, 14, 16-19
Verse 3—Everybody go get peace
Verse 12—God go help poor people
Verse 14—People no go dey fight again
Verse 16—Food go plenty for everybody