Jehovah—The Person Wey Dey Mold Us
‘Jehovah, na you mold us; all of us na your hand work.’—ISA. 64:8.
SONG: 89, 26
1. Why e be sey nobody sabi mold reach Jehovah?
FOR November 2010 for London, England, the prize wey dem put for one olden days Chinese pot wey dem use sand sand make na 70 million dollar. This one show sey person wey dey mold things fit use ordinary sand sand take make something wey fine and wey cost well well. But nobody sabi mold reach Jehovah. For the sixth day, Jehovah use ‘sand sand [clay] from ground’ make man. God make man so that man go fit copy im character. (Gen. 2:7) This man, Adam, wey God use sand sand make no get sin, na im make dem call am ‘God pikin.’—Luke 3:38.
2, 3. How we go take copy the character of Israel people wey repent?
2 But when Adam sin, e no come be God pikin again. Even though sey that one happen, as time dey go, plenty of Adam pikin don show sey na Jehovah be their King. (Heb. 12:1) Dem carry theirself down for God. This one make dem fit do wetin God want. And e show sey na God dem want as Papa and as Person wey dey mold dem, no be Satan. (John 8:44) Because dem no leave God, e make us remember wetin Isaiah talk about Israel people wey repent. E talk sey: ‘Jehovah, na you be our Papa. We be clay, and na you mold us; all of us na your hand work.’—Isa. 64:8.
3 For our time, everybody wey dey serve Jehovah well, dey try to do wetin e want and dem no dey carry body up. Dem don see am sey even though dem no reach, dem fit call Jehovah their Papa and let am mold dem. You go gree make Jehovah mold you to something wey e like? You dey see brothers and sisters for congregation as people wey God still dey mold? Make we learn three things wey go help us sabi how Jehovah take dey do this work: (1) How e dey choose who e go mold, (2) why e dey mold people and (3) how e dey mold dem.
NA JEHOVAH DEY CHOOSE WHO E GO MOLD
4. How Jehovah take dey select who e go draw near imself? Give example.
4 No be face Jehovah dey look but na wetin dey person mind, who the person really be. (Read 1 Samuel 16:7b.) We see sey this one na true when God form congregation for apostle dem time. The people wey God draw near imself and im pikin, na people wey no be anything for human being eye. (John 6:44) One of dem na one Pharisee wey im name na Saul—one man wey ‘dey talk bad things about God, dey suffer God people and wey no get respect.’ (1 Tim. 1:13) Jehovah wey ‘dey see wetin dey mind,’ no see Saul as clay wey don useless. (Prov. 17:3) But God see sey e fit mold am to better thing—something wey God don select to ‘go meet people for plenty country, plenty king and people for Israel.’ (Acts 9:15) God still see other people wey dey thief, drink too much and wey dey live anyhow life before, as people wey e fit use take do better thing. (Rom. 9:21; 1 Cor. 6:9-11) As dem come learn the correct things from Bible, dem come get faith. Dem let God mold dem.
5, 6. If we believe sey Jehovah know wetin dey people mind how e go help us see (a) the people wey we dey preach to? (b) our brothers and sisters for congregation?
5 How the things wey we don talk about fit help us? We believe sey Jehovah fit know wetin dey people mind and choose the people wey e go draw near body. This one go help us make we no dey judge the people wey we meet for preaching and our brothers and sisters for congregation. Make we see the example of one man wey im name na Michael. E talk sey: “When Jehovah Witness come my house, I no dey give dem face, I go do like sey I no see dem. I no dey respect dem at all! Later for another place, I come meet one family wey I like because of their better character. Wetin come surprise me about dem be sey dem be Jehovah Witness. The way dem dey do things come make me dey ask myself why I no like dem. Na that time I come see sey I no really sabi dem but na ‘dem sey dem sey’ make me no like dem.” Because of this one, Michael come start to dey study Bible with Jehovah Witness people. E later be Jehovah Witness and e come dey pioneer.
6 If we let Jehovah mold us, e go help us follow our brothers and sisters serve Jehovah well. Na the eye wey God take dey look brothers and sisters for congregation you take dey look dem? You dey see dem as people wey Jehovah never mold finish? Because Jehovah fit see wetin dey person mind, e know the kind person wey we go be as e dey mold us. Na im make Jehovah dey use better eye look people, e no dey put eye for their mistake. (Ps. 130:3) If we dey use better eye look brothers and sisters for congregation, we dey copy Jehovah example. The truth be sey we fit follow Jehovah dey help our brothers and sisters get better character. (1 Thess. 5:14, 15) Elders for congregation suppose try well well to dey show example for this area.—Eph. 4:8, 11-13.
WHY JEHOVAH DEY MOLD US?
7. Why you happy sey Jehovah dey correct you?
7 You fit don hear person talk sey: ‘Na now wey I don get my own pikin I come know sey na better thing my papa and mama do for me when I small.’ As we dey grow, we go come dey see things as Jehovah dey see am—sey na love dey make person correct us. (Read Hebrews 12:5, 6, 11.) Our Papa, Jehovah, dey sofri mold us because e love us. E want make we get sense, make we dey happy and make we love am back. (Prov. 23:15) E no dey happy if we dey suffer, and e no want make we join for ‘pikin wey suppose die,’ because of the sin wey we get from Adam.—Eph. 2:2, 3.
8, 9. How Jehovah take dey mold us now, and how e go continue to mold us for paradise?
8 Before before, we be ‘pikin wey suppose die’ and we get many bad character wey God no like, some even dey do like wicked animal! Now we thank Jehovah sey e mold us, and we don change; we come be like sheep. (Isa. 11:6-8; Col. 3:9, 10) So, Jehovah dey use wetin we dey learn from im organization dey mold us today. For there, we dey enjoy peace and love with our brothers and sisters even though sey we dey this wicked world. Even self, some of our brothers wey come from family wey quarrel full don dey enjoy love now for congregation. (John 13:35) And we don learn to love other people. The one wey better pass be sey, we don know Jehovah and e dey treat us as im pikin.—Jas. 4:8.
9 God Kingdom go turn the whole world to paradise. For that paradise, we go enjoy peace and love reach ground. That time, Jehovah go still dey mold us and dey teach us well well. (Isa. 11:9) God go still comot the sin wey dey our body and mind. This one go help us fit learn all the things wey Jehovah go teach us, and to do wetin e want without mistake. Since e be sey Jehovah love us, make we no stop to dey let am mold us.—Prov. 3:11, 12.
HOW JEHOVAH DEY MOLD US?
10. How Jesus take show sey e sabi mold like im Papa?
10 Like person wey sabi mold well well, Jehovah know how the clay wey e want use be and e dey carry this one for mind as e dey mold. (Read Psalm 103:10-14.) The truth be sey, Jehovah dey handle us one one. E know wetin we fit do and wetin we no fit do and whether we dey do well as we dey serve am. Jesus show us how Jehovah dey feel about us. Make we learn how Jesus handle im apostle mistake, especially when dem dey drag who big pass. If to sey you dey where Jesus apostle dey drag, you go gree sey dem gentle and sey dem be like soft clay? But no be so Jesus see dem. Jesus know sey Jehovah go fit mold im apostle if dem dey do like am and put ear as e dey sofri advice dem. (Mark 9:33-37; 10:37, 41-45; Luke 22:24-27) Jesus give im apostle dem holy spirit after God resurrect am. Na the work wey Jesus give dem come dey their mind no be who big pass.—Acts 5:42.
11. How David take show sey e be like soft clay and wetin we learn?
11 For our time, na Bible, holy spirit, and the congregation be the main things wey Jehovah take dey mold im people. How Jehovah take dey use Bible mold us today? We go read am, think about wetin we read, come pray make Jehovah help us fit do wetin we learn. David write for Bible sey: ‘I dey remember you when I dey my bed; I dey think about you for night.’ (Ps. 63:6) E still write sey: ‘I go praise Jehovah, the person wey don advise me. Even for night, my mind dey correct me.’ (Ps. 16:7) True true, David let Jehovah correct am even if the correction be like bitter leaf for im mouth. E let wetin Jehovah tell am mold how e dey think and how e dey feel. The correction really enter im body well. (2 Sam. 12:1-13) Wetin David example teach us? We learn sey make we no dey carry body up and make we ready to do wetin Jehovah tell us. So make you ask yourself: ‘You dey think about wetin you read for Bible? You dey let am reach your mind? You go need to try pass before?’—Ps. 1:2, 3.
12, 13. How Jehovah take dey use holy spirit and elder for congregation mold us?
12 Na different different way Jehovah dey use holy spirit mold us. For example, e fit help us get the kind character wey Jesus get, wey show sey e get God spirit. (Gal. 5:22, 23) One of dem na love. We love God and we want do wetin e tell us, because wetin e tell us no be heavy load. Holy spirit fit still give us power so that this world no go mold us. (Eph. 2:2) Before apostle Paul turn Christian, e dey carry body up and na from Pharisee people e learn am. But holy spirit help am change. Na im make e come later write sey: ‘For everything I dey get power from the person wey dey give me power.’ (Phil. 4:13) So make we no stop to dey beg for holy spirit like Paul. Jehovah go answer that kind prayer.—Ps. 10:17.
Jehovah dey use elders for congregation mold us, but na we go choose whether we go do wetin dem talk (Check paragraph 12, 13)
13 Jehovah dey use elder for congregation mold us one one. For example, if elders see am sey we no dey do well for Jehovah work like before, dem go try help us. The advice wey dem go give no be their own. (Gal. 6:1) But dem go beg God make e give dem sense to fit sabi the matter well. As the matter dey their mind, dem go follow wetin dem pray about, use Bible and our book dem take find answer for the matter. This one go help dem talk wetin go enter person mind. If elder advise you, maybe about the style of your dress, you go take their advice as wetin God take dey show sey e love you? If your answer na yes, e mean sey you be like soft clay for Jehovah hand, and you go gain as e dey mold you.
14. Wetin show sey Jehovah no dey force us do wetin e want, even if e get the power to do am?
14 If we really sabi how Jehovah take dey mold us, e go help us use better mind follow brothers and sisters for congregation. E go still help us get better mind for people wey we dey preach to, and our Bible student. For Bible time, person wey dey mold things no go just gather clay come begin mold. E go first comot the stone and other dirty wey fit dey inside. Na the same thing Jehovah dey do for people wey want make e mold dem. E no dey force dem to change. E dey give dem im law wey go make their life better, but na dem go choose whether dem go do am.
15, 16. How our Bible student go take show sey dem want make Jehovah mold dem? Give example.
15 Make we see the example of one sister for Australia wey im name na Tessie. The sister wey teach am Bible, talk sey: “E no hard Tessie to learn wetin dey Bible, but e no do wetin e dey learn—even congregation meeting e no dey come! I don think am well well, come pray about am, I come talk sey I go stop the study. Wetin come happen surprise me. For the study wey I think sey na the last one, e come tell me wetin dey im mind. Tessie talk sey e dey do am like sey im na wayo person because e like to dey gamble well well. But e talk sey e go change.”
16 E no tey, Tessie start to go congregation meeting and dey behave like Christian—even though sey im friends dey laugh am. The sister still talk sey: “Later, Tessie come baptize come even be regular pioneer, even when im pikin dem still small.” Na true sey if Bible student begin live better life so that God go happy, e go draw dem near body, come mold dem to better thing wey fine well well.
17. (a) Why e sweet you sey Jehovah na the person wey dey mold you? (b) Wetin we go learn for the next topic?
17 Till today, some people still dey use hand mold things. Dem dey sofri mold am. Na so Jehovah dey do; e dey sofri mold us. E dey use im advice mold us, and dey look wetin we go do. (Read Psalm 32:8.) You think sey Jehovah get you for mind? You dey see yourself as person wey Jehovah dey mold? If na so, wetin go help you continue to be like soft clay for Jehovah hand? Which kind bad character you go run from make you no come be like clay wey don dry? And how papa and mama fit follow Jehovah work to fit mold their pikin dem? We go answer this question for the next topic.