PART 3
How Life First Be for Paradise?
Jehovah give Adam and Eve many good good things. Genesis 1:28
The first woman wey Jehovah make na Eve. E come carry am give Adam make e be im wife.—Genesis 2:21, 22.
As e take make dem, dem no dey sick, dem no dey die, and dem no dey do bad thing.
E come put dem for Paradise wey be garden of Eden—that place fine well well. E get river, e get many tree, even different different animal dey inside.
Jehovah dey follow dem talk and e dey teach dem. If dem do wetin e tell dem, dem no go comot for that Paradise.
Na only one tree God sey make dem no chop the fruit. Genesis 2:16, 17
Jehovah show Adam and Eve one tree for that garden, come tell dem sey make dem no chop the fruit, sey if dem chop am dem go die.
One angel no come dey do wetin God talk again. That bad angel na Satan.
Satan no want make Adam and Eve do wetin Jehovah talk. Na im make am use snake tell Eve sey if e chop the fruit wey dey for that tree, e no go die, e go be like God. But wetin Satan talk na big lie.—Genesis 3:1-5.