MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Help Your Family Put Jehovah for Mind
Jehovah tell Jeremiah sey make e warn Jew people sey e go soon destroy dem as e be sey dem don forget am. (Jer 13:25) Wetin make Israel people comot from Jehovah side like this? Because Israel people don forget Jehovah. E clear sey family head no come dey do wetin Jehovah talk for Deuteronomy 6:5-7.
For our time, family wey dey serve Jehovah together dey make congregation strong well well. If family head dey do Family Worship wey make sense with im family every week, e go help dem dey put Jehovah for mind. (Ps 22:27) After una watch this video wey be ‘Put All This Things for Your Mind’—Wetin Some Family Talk, make una answer all this question:
How some family don take continue to dey do their Family Worship, even though sey e no easy?
Wetin we go gain if we dey do better Family Worship every week?
Which problem I dey get if I want do my family worship, and wetin I plan to do about am?