BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | JEREMIAH 12-16
Israel People Forget Jehovah
The work wey Jehovah give Jeremiah no easy at all. Jehovah use the work show sey e don ready to destroy Judah and Jerusalem because the people get strong head.
Jeremiah buy linen belt
13:1, 2
The way belt dey be when person tie am for waist show how Jehovah and Israel people take be tight friend
Jeremiah carry the belt go Euphrates River
13:3-5
Jeremiah go hide the belt for inside rock. E leave am for there, come go back to Jerusalem
Jeremiah go collect the belt from Euphrates River
13:6, 7
The belt don spoil
After Jeremiah don do the work, Jehovah come explain wetin the work mean
13:8-11
Jeremiah use all im mind do the work wey people fit see as yeye work, and Jehovah use am teach the people better lesson