CHAPTER SEVENTEEN
Prayer Na Gift From Jehovah
‘Jehovah, wey make heaven and earth’ want make we dey pray to am.—Psalm 115:15
1, 2. Why you think sey prayer na special gift from God, and why e good make we know wetin Bible talk about prayer?
IF YOU look everything wey Jehovah make, you go see sey this earth really small. For Jehovah eye, this earth and everybody wey dey inside be like small drop of water from bucket. (Psalm 115:15; Isaiah 40:15) Na true sey we small well well for inside all the things wey Jehovah make, but Psalm 145:18, 19 talk sey: ‘Jehovah no far from anybody wey dey call am. E near anybody wey dey call am with clean mind. E dey give people wey dey fear am wetin dem want; e dey hear as dem dey beg am make e help dem, and e go help dem.’ This one no be better thing? Yes o! Prayer na really big favor, and na special gift wey Jehovah don give all of us.
2 But the only thing wey go make Jehovah answer our prayer na, if we dey pray to am the way e want. How we go take do this one? Make we see wetin Bible talk about this matter.
WHY E GOOD MAKE WE DEY PRAY TO JEHOVAH?
3. Why e good make you dey pray to Jehovah?
3 Jehovah want make you dey pray to am. How we take know? Just think about am, na Jehovah be the King of heaven and earth. E really love you and e want make you dey tell am your problem and how e dey do you for body. Abeg read Philippians 4:6, 7.
4. If we dey pray to Jehovah every time, how e go take help us be im tight friend?
4 Prayer dey make us be Jehovah tight friend. When two people wey be friend, dey always talk to theirself and tell theirself wetin dey their mind, dem go come be tight friend. Na so e go still be if we dey pray to Jehovah. Jehovah dey use Bible tell you wetin dey im mind, and how e dey feel about you. And e don tell you wetin e go do for front. When you dey pray to am everytime, you fit tell am wetin you no fit tell another person. This one go make you and Jehovah be tight friend.—James 4:8.
WETIN WE GO DO SO THAT GOD GO ANSWER OUR PRAYER?
5. How we take know sey no be all prayer Jehovah dey answer?
5 Na all prayer Jehovah dey answer? No! For prophet Isaiah time, Jehovah tell Israel people sey: ‘No matter how una pray reach, I no go hear; because una hand no clean.’ (Isaiah 1:15) So make we no do anything wey go make Jehovah no answer our prayer.
6. Why faith dey important? How you go take show sey you get faith?
6 If we want make Jehovah answer our prayer, we must get faith. (Mark 11:24) Apostle Paul talk sey: ‘Person wey no get faith no go fit do wetin go make God happy, because anybody wey want near God must believe sey e dey, and sey na im dey pay the people wey dey try use all their mind find am.’ (Hebrews 11:6) No be just to talk sey we get faith. But to show sey we really get faith, we need to dey do wetin Jehovah talk everyday.—Read James 2:26.
7. (a) When we dey pray, why e good make we dey show sey we carry ourself down, and sey we dey respect Jehovah? (b) How we go take show sey wetin we dey pray for really come from our mind?
7 If we dey pray to Jehovah, make we dey carry ourself down and show sey we dey respect am. Why? Think am sey you want talk to king or president, how you go take talk to am? You no go talk to am with respect? Remember, na Jehovah get power pass, so when we dey pray to am, we suppose carry ourself down, and show sey we respect am well well. (Genesis 17:1; Psalm 138:6) Make we dey pray to Jehovah from our mind. E no good make we dey talk the same thing plenty times for inside one prayer.—Matthew 6:7, 8.
8. If we pray about something, wetin we suppose do?
8 Another thing wey we go get for mind be sey, when we pray for something, we need to work for wetin we dey pray for. For example, if we pray sey make Jehovah give us wetin we need to take live our life, we no go just sitdown fold hand make Jehovah throw wetin we need come down from heaven. We need to go look for work wey we know sey we go fit do. (Matthew 6:11; 2 Thessalonians 3:10) Or, if we pray make Jehovah help us make we stop some things wey we dey do wey no good, we must run from anything wey go make us go do am again. (Colossians 3:5) Make we come answer some question about prayer.
SOME QUESTION ABOUT PRAYER
9. Who we suppose dey pray to? Wetin John 14:6 teach us about prayer?
9 Who we suppose dey pray to? Jesus teach im people sey make dem dey pray to ‘our Father wey dey heaven.’ (Matthew 6:9) E still talk sey: ‘Na me be the road, the truth, and the life. Nobody fit come meet my Father unless I show am the road.’ (John 14:6) So make we dey pray only to Jehovah, through Jesus name. Wetin e mean to pray through Jesus name? If we want make Jehovah answer our prayer, we need to show sey we value the work wey Jehovah put for Jesus hand. As we don learn before, Jesus come save us from sin and death. (John 3:16; Romans 5:12) Now Jehovah don make am High Priest and Judge.—John 5:22; Hebrews 6:20.
You fit pray anytime
10. E get any special way we suppose stay when we dey pray? Explain.
10 E get any special way we suppose stay when we dey pray? No, Jehovah no sey make we kneel down, sitdown, or stand when we dey pray. Bible teach us sey we fit pray to God no matter how we stay, but make e show sey we respect am. (1 Chronicles 17:16; Nehemiah 8:6; Daniel 6:10; Mark 11:25) Wetin matter to Jehovah no be how we take stay when we dey pray, but sey make we show sey we dey respect am when we dey pray to am. We fit pray come out, and we fit still pray for inside mind. We fit pray for day time or for night. If we dey pray to only Jehovah, we dey sure sey e go answer us.—Nehemiah 2:1-6.
11. Wetin be some of the things wey we fit tell Jehovah?
11 Wetin we fit pray for? We fit pray for anything wey Jehovah agree with. Bible talk sey anything wey we beg am make e do for us wey agree with wetin e want, e go hear us. (1 John 5:14) We fit pray about our own matter? Yes o! Make we dey talk to Jehovah like sey we dey talk to our tight friend. Make we dey tell Jehovah anything wey dey our mind. (Psalm 62:8) We fit beg am make e give us im holy spirit so that we go fit do the right thing. (Luke 11:13) Make we dey beg Jehovah make e give us sense to choose the correct thing wey we go do and we fit still pray make e give us power when we dey wahala. (James 1:5) Make we dey beg Jehovah make e forgive us. (Ephesians 1:3, 7) Make we dey pray for other people, like people for our family and brothers and sisters for congregation.—Acts 12:5; Colossians 4:12.
12. Wetin be the first thing wey we suppose pray for?
12 Wetin be the first thing wey we suppose pray for? Na to dey pray make the things wey Jehovah want for this earth happen. Make we dey use all our mind thank am for all the things wey e don do for us. (1 Chronicles 29:10-13) When Jesus dey teach im disciples how to pray, e tell dem sey make dem first pray make God name dey holy. E come talk sey make dem pray make God Kingdom come, and sey make wetin Jehovah want for this earth happen the way e want am. Na after e don teach dem to pray for all this better better things, e come talk sey make dem pray for wetin dem need. (Read Matthew 6:9-13.) Make we dey first pray sey make wetin Jehovah want happen, before we pray for wetin we need. This one go show wetin dey important pass to us.
13. How our prayer suppose long reach?
13 How our prayer suppose long reach? Bible no tell us how our prayer suppose long reach. We fit pray long prayer or short one. For example, we fit pray short prayer when we want chop, but we fit pray long prayer when we dey thank God for wetin e don do for us or when we dey tell am our problem. (1 Samuel 1:12, 15) Make we no start to dey pray long prayer because we want make people dey praise us. Some people for Jesus time do like that. (Luke 20:46, 47) Jehovah no like prayer wey dey make people put eye for our body. But e dey value am when we pray from our mind.
14. How many times we suppose pray everyday, and wetin this one teach us about Jehovah?
14 How many times we suppose dey pray everyday? Bible help us know sey Jehovah want make we dey pray to am every time. Bible tell us sey make we dey always pray, make we ‘no tire to dey pray,’ and make we dey pray all the time. (Matthew 26:41; Romans 12:12; 1 Thessalonians 5:17) Jehovah no dey tire to hear our prayer. We fit thank am everyday for the better way wey e take dey care for us and dey give us wetin we need. We fit still beg am sey make e dey direct us, make e give us power, and to make our mind come down. If we really value the gift wey God give us to dey pray to am, we go dey pray everytime.
15. Why we dey sey “amen” after prayer?
15 Why we dey sey “amen” after prayer? “Amen” mean sey “I agree,” or make wetin we pray for, happen as we take pray. We dey talk am to show sey wetin we pray for really come from our mind. (Psalm 41:13) Bible still teach us sey we fit talk “amen” come out, or talk am for our mind when one person dey pray to God for everybody.—1 Chronicles 16:36; 1 Corinthians 14:16.
HOW GOD TAKE DEY ANSWER OUR PRAYER?
16. Jehovah dey really answer prayer? Explain.
16 Jehovah dey really answer prayer? Yes o! Bible call Jehovah the God wey dey answer prayer. (Psalm 65:2) Jehovah dey hear the prayer of plenty plenty people wey dey pray to am with all their mind and e dey answer dem. But na different different way e take dey answer prayer.
17. How Jehovah take dey use angels and im servant for this earth dey answer our prayer?
17 Jehovah dey use im angels, and im servant for this earth answer our prayer. (Hebrews 1:13, 14) Many people dey, wey pray sey make God help dem understand wetin Bible dey teach. As dem pray finish, e no tey before Jehovah Witness people come meet dem and preach to dem. This one show sey angels dey direct this preaching work wey we dey do. Bible talk sey angels get hand for this ‘good news’ wey we dey preach for the whole earth. (Read Revelation 14:6.) Many of us don still pray to Jehovah about something wey we need, Jehovah come use brother or sister for congregation help us.—Proverbs 12:25; James 2:16.
Jehovah fit use our brothers and sisters for congregation answer our prayer
18. How Jehovah take dey use im holy spirit and Bible answer our prayer?
18 Jehovah dey use im holy spirit answer our prayer. When we get problem, we come pray make Jehovah help us, e fit use im holy spirit direct us or give us power to fit bear the problem. (2 Corinthians 4:7) Jehovah still dey use Bible answer our prayer, and help us fit choose the correct thing wey we go do. When we dey read Bible, we fit see some Bible verse wey go help us. Jehovah fit use person wey answer question for meeting, talk wetin fit help us. E fit still use elder for congregation show us something for Bible wey go help us.—Galatians 6:1.
19. Sometimes why e dey be like sey Jehovah never answer our prayer?
19 But sometimes we fit dey ask ourself sey: ‘Why God never still answer my prayer?’ No forget sey Jehovah know how e go take answer our prayer, and the right time to answer am. E know wetin we need. If we no stop to dey pray, e go show sey we really serious for wetin we dey pray for. And e go still show sey we get faith sey e go do am for us. (Luke 11:5-10) Sometimes, no be the way we want make Jehovah answer our prayer, e take dey answer am. For example, when we get serious problem, we fit dey pray make e comot the problem. E fit no comot am, but e go give us the power wey we need to take bear am.—Read Philippians 4:13.
20. Why e good make we dey pray to Jehovah all the time?
20 Prayer na really special gift from Jehovah! We dey sure sey if we pray to am, e go answer us. (Psalm 145:18) And the more we dey pray to am from our mind, the more we and am go be tight friend.