SONG 96
Bible Na Better Book From God
(Proverbs 2:1)
1. E get one book wey God dey take dey guide us,
To give us hope and peace of mind today.
This book go fit help people get better life,
E fit help people change if dem obey.
The name of this book na the Holy Bible.
Jehovah use good people write the book.
Wetin dem write show sey dem love Jehovah
Wey use im spirit help dem write this book.
2. This book dey help us learn about Jehovah,
And how e take make heaven and the earth.
This book still show how life for Paradise be,
And wetin come make this world be like this.
Na Bible tell us how wahala take start,
When Satan come talk sey our God dey lie.
Na this challenge cause trouble and this suffer,
But Bible talk sey na small time remain.
3. The time don reach to sing and praise Jehovah,
For heaven Jesus don dey rule as king.
So make we preach and teach about the Kingdom,
And all the blessing Paradise go bring.
Plenty things dey wey we go gain from Bible,
Na this better things wey we really need.
Things wey go fit help us dey serve Jehovah.
Bible na better book wey we go read.
(Still check 2 Tim. 3:16; 2 Pet. 1:21.)