Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • sjj song 97
  • God Word Dey Help Us Live

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • God Word Dey Help Us Live
  • “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Similar Material
  • Choose to Serve Jehovah
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Life for Paradise No Go End
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • The Truth Go Save Their Life
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Life Wey No Go End Dey Come
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
“Use All Your Heart Sing” to Jehovah
sjj song 97

SONG 97

God Word Dey Help Us Live

(Matthew 4:4)

  1. 1. All the things wey Jehovah talk,

    Wey e write for im Word.

    Na the things wey go help us live

    Life wey food no fit give.

    Now we get joy and peace of mind,

    And better hope for front.

    (CHORUS)

    Bible fit help us ev’ryday,

    God Word na im we need.

    Only food no fit give us life,

    Make we dey read Bible.

  2. 2. All the story wey dey Bible,

    Na to help us dey learn.

    And dem teach us about people,

    Those wey get better faith.

    Oh, e sweet to dey learn from dem.

    We dey follow their faith.

    (CHORUS)

    Bible fit help us ev’ryday,

    God Word na im we need.

    Only food no fit give us life,

    Make we dey read Bible.

  3. 3. As we read Bible ev’ryday,

    We dey get joy and peace.

    Even when problem no gree stop,

    Bible still dey help us.

    Make we use all our heart and mind

    Read God Word and obey.

    (CHORUS)

    Bible fit help us ev’ryday,

    God Word na im we need.

    Only food no fit give us life,

    Make we dey read Bible.

(Still check Josh. 1:8; Rom. 15:4.)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share