Book to Take Prepare Life and Preaching Meeting
APRIL 2-8
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 26
“Passover and Memorial—How Dem Take Resemble and How Dem Take Different”
(Matthew 26:17-20) For the first day of the festival of Bread Wey No Get Yeast, Jesus disciples come meet am, ask am sey: “Where you want make we arrange for you to stay chop the Passover?” 18 E talk sey: “Enter inside the city, go meet So-so person and tell am sey, ‘The Teacher sey: “My time don near, I go celebrate the Passover with my disciples for your house.”’” 19 So the disciples do as Jesus direct dem and arrange for the Passover. 20 When evening reach, e come dey chop for table with the 12 disciples.
nwtsty media
Things Wey Dem Dey Use Do Passover
The things wey dem need to do Passover na: (1) lamb [small sheep] wey dem roast (dem no go break any of im bone); (2) bread wey no get yeast; and (3) leaf wey dey bitter. (Ex 12:5, 8; Nu 9:11) One law book wey dem dey call Mishnah, talk sey this leaf fit be lettuce, chicory, pepperwort, endive, or dandelion. As the leaf dey bitter, e help Israel people remember the kind suffer wey dem suffer for Egypt. The bread wey no get yeast wey Jesus use, stand for im body wey no get sin. (Mt 26:26) Apostle Paul even call Jesus “our Passover lamb.” (1Co 5:7) (4) Another thing wey people for the apostles time use do Passover na wine. The wine wey Jesus use mean im blood wey e sacrifice.—Mt 26:27, 28.
(Matthew 26:26) As dem dey chop, Jesus collect bread, and after e pray, e break am. As e dey give im disciples, e talk sey: “Make una take, chop. This one mean my body.”
nwtsty study note for Mt 26:26
mean: The Greek word e·stinʹ mean, “na.” But the meaning wey e get for this verse na “stand for, represent, or sign of.” And the meaning clear for the apostles because (1) that time Jesus dey there with dem; and (2) the bread wey no get yeast wey dem want chop, dey their front. So, e clear sey the bread no be Jesus real body. E good make we know sey dem still use this same Greek word for Mt 12:7 and many Bible translate am as “mean.”
(Matthew 26:27, 28) E still collect cup, come pray, and give am to dem. E sey: “Make all of una drink from am, 28 because this one mean my ‘blood of the covenant,’ wey dem go pour because of many people to forgive their sin.
nwtsty study note for Mt 26:28
blood of the covenant: Na Jesus sacrifice make the new covenant wey Jehovah get with anointed Christians start to work. (Heb 8:10) This word wey Jesus use for here, na im Moses still use when e give Israel people Jehovah law for Mount Sinai. (Ex 24:8; Heb 9:19-21) As the blood of bull and goat take make the Law covenant wey Jehovah get with Israel people start to work, na so Jesus blood make the new covenant wey Jehovah get with anointed Christians work. And na Pentecost 33 C.E. this new covenant, start to work.—Heb 9:14, 15.
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well
(Matthew 26:17) For the first day of the Festival of Bread Wey No Get Yeast, Jesus disciples come meet am, ask am sey: “Where you want make we arrange for you to chop the Passover?”
nwtsty study note for Mt 26:17
For the first day of the Festival of Bread Wey No Get Yeast: Passover day na Nisan 14. But the day wey the Festival of Bread Wey No Get Yeast dey start na Nisan 15 wey be the day after Passover. Na seven days dem dey use celebrate this festival. (See App. B15.) But for Jesus time, people don dey celebrate Passover and this festival together. So this one come make the festival be eight days. And sometimes dem dey call the whole celebration “the Festival of Bread Wey No Get Yeast.” (Lu 22:1) For this verse, the way dem use “for the first day” fit still mean “the day before.” (Check wetin dey Joh 1:15, 30. For there, dem translate the Greek word for “first” [proʹtos] as “before.” The way dem take use am for the verse come be, “e don dey even before [proʹtos] dem born me.”) So the original Greek word, and wetin Jew people dey do that time, fit make person talk sey na Nisan 13, Jesus disciples ask am the question wey dey this verse. The disciples use the day time of Nisan 13 prepare for the Passover. Dem come celebrate am “when evening reach.” Na that evening time be the beginning of Nisan 14.—Mr 14:16, 17.
(Matthew 26:39) And as e go front small, e fall down come face ground dey pray sey: “My Father, if e dey possible, make this cup pass comot for my front. But no be as I want, make e be as you want.”
nwtsty study note for Mt 26:39
make this cup pass comot: Many times when Bible use the word “cup,” e stand for wetin God want or “work wey dem don give person.” (Go check study note for Mt 20:22.) Jesus know sey before dem kill am, dem go call am person wey dey curse God and wey dey fight government. This thing really worry Jesus because e go make people talk bad about God. Na im make Jesus come pray sey make this “cup” pass comot for im front.
Bible Reading
(Matthew 26:1-19) Now, when Jesus don talk all this things finish, e tell im disciples sey: 2 “Una know sey two days from now go be Passover festival, and people go carry the Son of man give im enemy so that dem go nail am for pole to kill am.” 3 Then the chief priests and the elders wey dey lead the people come gather for the courtyard of the high priest, wey im name na Caiaphas, 4 and dem come plan for secret to use wayo catch Jesus and kill am. 5 But dem come dey talk sey: “Make e no be for the festival, so that the people no go cause riot.” 6 When Jesus dey Bethany for the house of Simon wey be leper, 7 one woman carry one alabaster container of oil wey get better scent, come meet am. The oil cost well well, and the woman come dey pour am for im head as e dey chop for table. 8 As im disciples see am, dem come vex well well talk sey: “Why you dey waste this oil? 9 Because dem for sell this oil for better money, come carry am give poor people.” 10 When Jesus hear wetin dem talk, e come ask dem sey: “Why una want cause trouble for this woman? Na better thing e do for me. 11 Because poor people go always dey with una, but I no go always dey with una. 12 When e pour this oil wey get better scent for my body, e do am to prepare me for burial. 13 I dey tell una true sey, anywhere wey dem go preach this good news for the whole world, dem go still talk about wetin this woman do to remember am.” 14 Then one of the twelve disciples wey dem dey call Judas Iscariot, go meet the chief priests 15 come talk sey: “Wetin una go give me if I betray am to una?” Dem come agree sey dem go give am 30 silver coins. 16 So from that time, e come dey find better chance to take betray am. 17 For the first day of the Festival of Bread Wey No Get Yeast, Jesus disciples come meet am, ask am sey: “Where you want make we arrange for you to stay chop the Passover?” 18 E talk sey: “Enter inside the city, go meet So-so person and tell am sey, ‘The Teacher sey: “My time don near, I go celebrate the Passover with my disciples for your house.”’” 19 So the disciples do as Jesus direct dem and arrange for the Passover.
APRIL 9-15
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MATTHEW 27-28
“Go Make People My Disciple—Why, Where, and How?”
(Matthew 28:18) Jesus come meet dem and tell dem, sey: “Dem don give me all the power for heaven and earth.
w04 7/1 8 ¶4
“Go Make People My Disciple”
4 Na Jesus dey control im congregation. And na since 1914 e become King of God Kingdom for heaven. (Colossians 1:13; Revelation 11:15) Na im be the leader of all the angels wey plenty reach hundreds of millions. (1 Thessalonians 4:16; 1 Peter 3:22; Revelation 19:14-16) Jehovah don give Jesus the power to destroy anybody and all government wey no gree support wetin God want. (1 Corinthians 15:24-26; Ephesians 1:20-23) God don still give Jesus the power to judge ‘people wey dey alive and even people wey don die.’ And e still get the power to resurrect people wey don die. (Acts 10:42; John 5:26-28) As Jehovah don give Jesus this kind power, no be better thing to obey im command? So, make we use all our heart obey wetin Jesus command us, when e sey: “Go make people my disciple.”
(Matthew 28:19) So make una go make people my disciple for the whole world. Dey baptize dem in the name of the Father, the Son and the holy spirit,
nwtsty study note for Mt 28:19
make people my disciple: Dem fit translate the Greek word ma·the·teuʹo to mean “to teach person” so that e go be disciple. (Check Mt 13:52, where this word mean “person wey dem don teach.”) To make people Jesus disciple, we must “baptize” and “teach” dem.
people . . . for the whole world: For Greek language, this statement mean “the whole world.” But as the verse talk “dem” when e sey, “dey baptize dem,” e show sey na the people for this world, the verse dey talk about. This command to preach to ‘people for the whole world’ na new one. Before Jesus start to preach, Bible show sey Israel people dey welcome stranger wey come join dem serve Jehovah. (1Ki 8:41-43) But this command wey Jesus give im disciples, show sey dem go do this preaching work so that people for the whole world, go hear.—Mt 10:1, 5-7; Re 7:9; check study note for Mt 24:14.
(Matthew 28:20) dey teach dem to do everything wey I don command una. And see! I dey with una everytime until the ending of this system of things.”
nwtsty study note for Mt 28:20
dey teach dem: The Greek word wey dem translate as “to teach” mean to train, explain, and give example wey go make person believe wetin you dey talk. (Go check study note for Mt 3:1; 4:23.) To teach person to do everything wey Jesus talk no be one day work. We must continue to teach am how to use the things wey Jesus teach, for im life.—Joh 13:17; Eph 4:21; 1Pe 2:21.
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well:
(Matthew 27:51) And see! the curtain wey dey the sanctuary come tear into two, from up to down, and ground come dey shake, and rocks come break.
nwtsty study note for Mt 27:51
curtain: This na the curtain wey separate the Most Holy from the Holy for the temple. This curtain get better design wey make am fine well well. Jew people talk sey this curtain heavy and e long reach 18 m (60 ft), wide reach 9 m (30 ft), and thick reach 7.4 cm (2.9 in.). As the curtain tear into two, e show sey Jehovah vex well well for the people wey kill im Son. E still show sey now, Jehovah don open road for people to join Jesus rule for heaven.—Heb 10:19, 20; check Glossary.
sanctuary: The Greek word for sanctuary na na·osʹ, e mean the temple where the Holy and Most Holy dey.
(Matthew 28:7) So, make una go quick quick, go tell im disciples sey e don rise up from grave, and see! e dey go wait for una for Galilee. Una go see am for there. See! I don tell una.”
nwtsty study note for Mt 28:7
tell im disciples sey e don rise up from grave: Na this women be the first to hear sey Jesus don resurrect and na dem the angel still send to tell other disciples. (Mt 28:2, 5, 7) Even though sey God want make dem dey treat women well, Jew people no dey gree make woman be witness for court. But the angel no do like dem. E show sey e respect this women because e give dem this better work wey make dem happy.
Bible Reading
(Matthew 27:38-54) Dem still nail two robbers near am, one for im right side and one for im left. 39 And people come dey take am do yeye, dey shake their head as dem dey pass 40 dey talk sey: “You wey sey you go scatter the temple come use three days build am back, save yourself! If you be God son, come down from the pole wey dem nail you!” 41 Like this people, the chief priests, the scribes and the elders come dey take am do yeye, dey talk sey: 42 “E save other people but e no fit save imself! Im na King of Israel; make e come down now from the pole wey dem nail am, and we go believe am. 43 E trust God; make e come save am now if e want am, because e talk sey, ‘I be God Son.’” 44 Even the robbers wey dem nail near am, come join dey laugh am. 45 Darkness come cover the whole land, from the sixth hour go reach the ninth hour. 46 Around the ninth hour, Jesus come shout sey: “E′li, E′li, la′ma sa·bach·tha′ni?” wey mean, “My God, my God, why you abandon me?” 47 When some of the people wey stand there hear am, dem come dey talk sey: “This man dey call Elijah.” 48 At once, one of dem come run carry sponge, soak am for wine wey don sour, come put am for stick and give am to drink. 49 But the other people come talk sey: “Leave am! Make we see whether Elijah go come save am.” 50 Jesus come shout again and stop to breath. 51 And see! the curtain wey dey the sanctuary come tear into two, from up to down, and ground come dey shake, and rocks come break scatter. 52 And graves come open, and many of the holy people dead body come rise up 53 (and people wey dey come out from the grave after e don rise up come enter the holy city), and many people see dem. 54 But when the army officer and people wey dey follow am watch Jesus body see how ground dey shake and other things wey dey happen, dem really fear come talk sey: “True true, this person na God Son.”
APRIL 16-22
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MARK 1-2
“I Don Forgive Your Sin”
(Mark 2:3-5) “And four men carry person wey paralyze come meet am. 4 But because people many, dem no fit carry am reach where Jesus dey. So dem remove the roof of the place wey Jesus dey, and after dem put hole, dem come sofri carry the bed wey the paralyze person lie down ontop, come down. 5 As Jesus see the kind faith wey dem get, e tell the paralyze person sey: “My pikin, I don forgive your sin.”
“I Don Forgive Your Sin”
As Jesus dey teach for one room wey plenty people dey, four men carry one man for bed come, the man paralyze. Dem want make Jesus heal their friend. But because people plenty, dem no fit carry am ‘reach where e dey.’ (Mark 2:4) So, wetin dem go do now? Dem climb the roof of the house, open one place, come from there sofri carry the paralyze man, come down.
Jesus vex for dem sey dem disturb am as e dey teach people? No o! The strong faith wey dem show, really touch Jesus and e come tell the paralyze man sey: “I don forgive your sin” (Matthew 9:2) But, Jesus really get the power to forgive sin? Wetin Jesus talk vex the scribes and the Pharisees. Dem come dey reason sey: “Why this man dey talk like this? This na insult to God, who fit forgive sin apart from God?”—Mark 2:7.
Because Jesus know wetin dem dey think, e ask dem sey: “Why una dey reason like this for una heart? Which one easy pass to tell the paralyze person, ‘I don forgive your sin,’ or to talk sey, ‘Stand up, carry your bed and make you waka’?” (Mark 2:8, 9) The truth be sey, because of the sacrifice wey Jesus go do, e fit forgive the man sin.
(Mark 2:6-12) But some of the scribes wey dey there come dey reason for your their heart sey: 7 “Why this man dey talk like this? This na insult to God, who fit forgive sin apart from God?” 8 But at once, Jesus mind come tell am wetin dem dey reason among theirself, so e come ask dem sey: “Why una dey reason like this for una heart? 9 Which one easy pass to tell the paralyze person, ‘I don forgive your sins,’ or to talk sey, ‘Stand up, carry your bed and make you waka’? 10 But so that una go know sey the Son of man get the power to forgive sin for this earth—” e come tell the paralyze person sey: 11 “I dey tell you, Stand up, carry your bed, and make you go your house.” 12 At once, e stand up, carry im bed waka comot from their front. So all of dem come surprise well well, and dem come dey praise God, dey talk sey: “We never see this kind thing before.”
nwtsty study note for Mr 2:9
Which one easy pass: E easy for Jesus to talk sey e fit forgive sin because e no get wetin person go use know whether e forgive the sin or e no forgive. But to talk sey, Stand up . . . and make you waka, mean sey Jesus go do miracle wey people go see, and know sey e fit forgive sin. This Bible verse and Isa 33:24 show sey na sin dey make us sick.
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well
(Mark 1:11) And one voice from heaven come talk sey: “You be my Son, wey I love; you dey make me happy well well.”
nwtsty study note for Mr 1:11
one voice from heaven come talk sey: Na three times the four Gospel book talk about when God talk from heaven. But na the first one, dey this verse.—Go check study note for Mr 9:7 and Joh 12:28.
You be my Son: Before Jesus come this earth, na God special Son e be. (Joh 3:16) From when dem born am for this earth, e come be God pikin the way Adam take be God pikin. (Lu 1:35; 3:38) But Jehovah no only talk wetin dey this verse because e want tell us who Jesus be. Wetin e talk and the holy spirit wey e give Jesus show sey (1) e don choose Jesus again to come back to heaven as im special Son; (2) Jesus go be the High Priest and King of im Kingdom for heaven.—Check wetin dey Joh 3:3-6; 6:51; Lu 1:31-33; Heb 2:17; 5:1, 4-10; 7:1-3.
you dey make me happy well well: Or “your matter dey sweet me for mind.” Dem talk this same thing for Mt 12:1, wey dem quote from Isa 42:1 about the Messiah. Wetin Jehovah talk and the holy spirit wey e give Jesus, make am clear sey na Jesus be the Messiah wey Bible talk about.—Check study note for Mt 3:17; 12:18.
(Mark 2:27, 28) Then e come tell dem sey: “Dem make Sabbath because of man, but dem no make man because of Sabbath. 28 Even self, na the Son of man be the Lord of the Sabbath.”
nwtsty study note for Mr 2:28
Lord of the Sabbath: Jesus talk sey na im be the Lord of the Sabbath. (Mt 12:8; Lu 6:5) This one show sey Jesus fit do the work wey im Father don give am, even for Sabbath day. (Check wetin dey Joh 5:19; 10:37, 38.) Na Sabbath day Jesus do some of the miracle wey surprise people pass. (Lu 13:10-13; Joh 5:5-9; 9:1-14) This one dey show the kind rest of mind wey people go get when Jesus start to rule this earth. E go just be like the kind rest wey dem dey rest for Sabbath day.—Heb 10:1.
Bible Reading
(Mark 1:1-15) The beginning of the good news about Jesus Christ wey be God Son: 2 Just as prophet Isaiah write, sey: “(See! I dey send my messenger go your front, and e go prepare the way for you.) 3 One voice dey shout from wilderness sey: ‘Prepare Jehovah way! Make im road straight.’” 4 John the Baptizer preach for wilderness sey make people baptize to show sey dem don repent, so that dem go get forgiveness for their sin. 5 And all the people for Judea and Jerusalem come dey go meet am, and e baptize dem for River Jordan as dem dey confess their sin for public. 6 Now John wear cloth wey dem make with camel hair and e wear leather belt for waist, and na locust and bush honey e dey chop. 7 And e come dey preach sey: “The person wey dey come after me strong pass me, and I no reach to bend down loose the rope wey dey im sandals. 8 Na water I use baptize una, but e go baptize una with holy spirit.” 9 Around that time, Jesus come from Nazareth wey dey Galilee and John come baptize am. 10 As e just dey come out from the water, e see as heaven open and holy spirit dey come ontop am like dove. 11 And one voice from heaven come talk sey: “You be my Son, wey I love; you dey make me happy well well.” 12 At once the spirit come move am to enter wilderness. 13 So, e stay for wilderness reach 40 days, and Satan come tempt am. E dey where wild animals dey but the angels come dey serve am. 14 Now after dem arrest John, Jesus come enter Galilee dey preach the good news of God. 15 E sey: “The time wey dem choose don reach, and the Kingdom of God don near. Repent, and believe the good news.”
APRIL 23-29
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MARK 3-4
“Jesus Heal People On Sabbath Day”
(Mark 3:1, 2) E enter one synagogue again, and for there, e see one man wey im hand paralyze. 2 So dem come dey watch am to see whether e go cure the man for Sabbath day, so that dem go see wetin dem go take hold am.
Wetin Person Fit Do On Sabbath Day?
For another Sabbath day, Jesus go one synagogue. E be like sey na the one wey dey Galilee. For there, e see one man wey im right hand paralyze. (Luke 6:6) The scribes and the Pharisees come dey watch Jesus. Why dem dey watch am? The question wey dem ask am show wetin dey their mind. Dem sey: “The Law support to cure person on Sabbath day?”—Matthew 12:10.
The people wey dey lead for Jew religion, believe sey na only if the sickness serious reach to kill person na im dem fit heal am. Na im make dem put law sey make people no set bone wey break or treat dislocation on Sabbath day. Dem feel sey this one no go kill anybody. So, e clear sey dem no ask this question because dem dey pity for the man. Dem just dey find wetin dem go take hold Jesus.
(Mark 3:3, 4) E come tell the man wey im hand paralyze sey: “Stand up and come center.” Then, e come ask dem sey: “Law support to do good or bad, to save life or kill, on Sabbath day?” But dem no answer am.
Wetin Person Fit Do On Sabbath Day?
But Jesus know the kind cunning mind wey dem get. E know sey dem don add their own law join wetin God Word talk about Sabbath day. (Exodus 20:8-10) No be the first time wey dem dey talk bad about the miracle wey Jesus dey do. Now Jesus come do wetin go make dem even talk more. E tell the man wey im hand paralyze sey: “Stand up and come center.”—Mark 3:3.
(Mark 3:5) After Jesus don vex look all of dem, because e pain am well well sey dem get wicked heart, e come tell the man sey: “Stretch your hand.” E come stretch am, and the hand come good.
nwtsty study note for Mr 3:5
Jesus . . . vex look all of dem, because e pain am well well: Matthew and Luke write about wetin happen for here for their own Bible book. But na only Mark write how Jesus feel when e see sey the scribes and Pharisees get wicked heart. (Mt 12:13; Lu 6:10) Peter na person wey sabi feel for people, e fit be sey na im tell Mark how Jesus feel, when this thing happen.—Go check the video “Wetin dey the book of Mark.”
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well
(Mark 3: 29) But dem no go ever forgive anybody wey talk bad thing about the holy spirit, because e don commit everlasting sin.”
nwtsty study note for Mr 3:29
anybody wey talk bad thing about the holy spirit: E fit still mean to curse God or to talk anyhow about holy things. Since na holy spirit, God dey use do im work, anybody wey talk bad about the work wey that spirit dey do, dey curse God. Mt 12:24, 28 and Mr 3:22 show sey na wetin the scribes and Pharisees do be that. Dem know sey na God spirit Jesus use do miracle but dem talk sey na Devil give am power.
don commit everlasting sin: E be like sey this place dey talk about sin wey person open eye do. This kind sin dey make person be God enemy forever. Jesus sacrifice no go fit cover this sin.—Check study note for anybody wey talk bad thing about the holy spirit. Still check Mt 12:31 wey talk this same thing.
(Mark 4:26-29) “Na im e come talk sey: “The same way, the Kingdom of God just be like when one man throw plenty seed for farm. 27 E sleep for night, and wake up for day time, and the seed don germinate come grow well well, but e no know how e take happen. 28 Small small, the ground produce fruit by imself, first the stick, then the head, finally the complete fruit for the head. 29 As the fruit just mature, e go use the knife wey dem take dey harvest, harvest am because the harvest season don reach.”
w14 12/15 12-13 ¶6-8
You “understand am”?
6 Wetin we fit learn from this story? The first thing be sey, we suppose know sey whether our Bible student go serve Jehovah or e no go serve am, no dey our hand. So, make we know where we suppose do reach. Make we no force dem to baptize. Instead, make we try our best to help dem. But the point be sey na im go choose whether e go give Jehovah im life. Dem no dey force person do this one, e must come from im heart. And na the love wey e get for God, go move am. Jehovah no go accept person wey dem force worship am.—Ps. 51:12; 54:6; 110:3.
7 The second thing be sey, if we understand the message wey dey this story, we no go tire to preach. Even if e be like sey our work no dey produce fruit, we no go stop. We must dey patient. (Jas. 5:7, 8) Make we do our best to help our Bible student. But if e no come serve Jehovah, e no mean sey we no do our work well. Jehovah dey allow the seed of truth, grow for the heart of person wey dey carry body down and wey ready to change. (Matt. 13:23) So, make we no think sey if we no fit help person come serve Jehovah, we no dey try. Jehovah no dey use the number of people wey we don help come serve am, take measure if we dey do im work well. The truth be sey, Jehovah value our work well well, even if we no fit help anybody come serve am.—Read Luke 10:17-20; 1 Corinthians 3:8.
8 The third thing be sey, no be everytime we dey know sey our Bible student dey do wetin dem dey learn. For example, the husband and wife wey one missionary dey study with, tell am sey dem want become unbaptized publisher. E come remind dem sey to qualify, dem must stop to dey smoke. E really surprise am when dem talk sey dem don already stop. Why dem stop? Na because dem come understand sey even if dem hide smoke, Jehovah go see dem. And Jehovah hate people wey dey pretend. Because of this one, dem come tell theirself sey if dem no fit smoke for front of the missionary, dem no go smoke at all. Na the love wey dem get for Jehovah, help dem choose the right thing. Their love for God don really help dem change, even though sey the missionary no know.
Bible Reading
(Mark 3:1-19a) E enter one synagogue again, and for there, e see one man wey im hand paralyze. 2 So dem come dey watch am to see whether e go cure the man for Sabbath day, so that dem go see wetin dem go take hold am. 3 E come tell the man wey im hand paralyze sey: “Stand up and come center.” 4 Then, e come ask dem sey: “Law support to do good or bad, to save life or kill, for Sabbath day? But dem no answer am. 5 After Jesus don vex look all of dem, because e pain am well well sey dem get wicked heart, e come tell the man sey: “Stretch your hand.” E come stretch am, and the hand come good. 6 At once the Pharisees comot, come begin do meeting with the people wey dey support Herod, about how to kill am. 7 But Jesus and im disciples come go the sea, plenty people from Gal′i·lee and Ju·de′a come follow am. 8 Plenty other people still come meet am because dem hear many things wey e dey do. Dem come from Jerusalem, Id·u·me′a, across Jordan, from around Tyre, and Si′don. 9 E come tell im disciple to arrange one small boat for am so that the people no go dey push am anyhow. 10 Because e cure many people, all the people wey get serious sickness come dey gather am so that dem go fit touch am. 11 Even self, anytime wey the wicked spirit see am, dem go bow down to am and shout sey: “You be God Son.” 12 But many times, e go warn dem well well sey make dem no let people know who e be. 13 E climb one mountain, come call the people wey e want, and dem come meet am. 14 E come choose 12 people and call dem apostles. Na dem go dey follow am and e go send dem go preach 15 and to get the power to pursue demons comot. 16 Na the 12 people wey e choose be this; Simon, the one wey e still call Peter, 17 James wey be Zeb′e·dee son and im brother John (e still call dem Bo·a·ner′ges, wey mean “Thunder Children”), 18 Andrew, Philip, Bar·thol′o·mew, Matthew, Thomas, James wey be Al·phae′us son, Thad·dae′us, Simon the Ca·na·nae′an, 19 and Judas Is·car′i·ot, wey later betray am.
APRIL 30–MAY 6
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MARK 5-6
“Jesus Get the Power to Wake Our People Wey Don Die”
(Mark 5:38) So dem come the house of the oga of the people wey dey lead for synagogue, e come see sey confusion full the place and people serious dey cry.
(Mark 5:39-41) After e enter the house, e tell dem sey: “Why una dey cry and dey cause confusion? The pikin never die, but e dey sleep.” 40 Na im dem come start to laugh am and take am do yeye. But after e don send all of dem go outside, e come carry the pikin papa and mama with the people wey dey with am, go where the pikin dey. 41 And as e hold the pikin hand, e come tell am sey: “Tal′i·tha cu′mi,” if dem translate am, e mean: “Small girl, I sey make you get up!”
nwtsty study note for Mr 5:39
The pikin never die, but e dey sleep: Many time for Bible, dem compare death to sleep. (Ps 13:3; Joh 11:11-14; Ac 7:60; 1Co 7:39; 15:51; 1Th 4:13) Wetin dey Jesus mind na to bring the girl back to life. So e talk this thing because e want show sey just as person wey dey deep sleep fit wake up, person wey don die fit come back to life. Na the power wey Jehovah give Jesus, e take wake the girl from death. Because na im fit “make people wey don die come back to life; and wey dey call the things wey no dey like sey dem dey.”—Ro 4:17.
(Mark 5:42) At once, the girl stand up and start to waka. (Na 12 years e dey.) Na so all of dem come start to happy well well.
Jesus Bring One Young Girl Come Back to Life!
The other time wey Jesus do miracle, e tell the people wey e heal sey make dem no tell people about am. Na the same thing e tell the girl papa and mama. But because the girl papa, mama, and other people happy well well, dem come tell people “for the whole region.” (Matthew 9:26) If na your person wey don die dem resurrect, you no go happy to tell people about am? This na the second time wey Jesus bring person come back to life.
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well
(Mark 5:19, 20) But e no gree, e tell am sey: “Go meet your people for house and tell dem all the things wey Jehovah don do for you and the way e take pity you. 20 The man comot, come start to tell people for De·cap′o·lis all the things wey Jesus don do for am. And e surprise all the people.
nwtsty study note for Mr 5:19
tell dem: Normally, when Jesus do miracle, e go tell the people sey make dem no tell people about am. (Mr 1:44; 3:12; 7:36) But wetin Jesus tell the man different, e tell am sey make e tell im people wetin happen to am. E fit be sey na because dem tell to Jesus comot for the area. As Jesus no go fit preach for the area, the things wey the man go tell the people go help dem well well. E go make dem see sey the bad things wey dem fit dey talk about Jesus, and wetin happen to the pigs no correct.
(Mark 6:11) And anywhere wey dem no gree make una enter or listen to una, as una dey comot, make una dust una leg as sign for dem.”
nwtsty study note for Mr 6:11
make una dust una leg: The disciples use this one show sey their hand no dey for the things wey God go do the people wey no listen to their preaching. Dem talk this kind thing for Mt 10:14 and Lu 9:5. For the book of Mark and Luke, dem add as sign for (or “against”) dem. Paul and Barnabas do the same thing for one place wey dem dey call Pisidian Antioch. (Ac 13:51) For Corinth, apostle Paul do this kind thing. E shake im cloth and talk sey: “Make una blood dey una own head. My hand clean.” (Ac 18:6) This kind thing no be new thing to Jesus disciples. E get wetin some Jews wey think sey dem too holy dey do. When dem dey comot from the country of people wey no be Jew, dem go first shake the dust wey dey their sandals comot, before dem enter their city. But no be this kind thing wey Jew people dey do, Jesus dey talk about.
Bible Reading
(Mark 6:1-13) E comot from there, come enter im village, and im disciples follow am. 2 When Sabbath day reach, e come start to dey teach for synagogue and many of the people wey hear am, come surprise, dey ask sey: “Where this man learn all this things? Why dem come give am this kind sense, and why e come be sey na im dey do all this miracle? 3 No be the carpenter be this? No be Mary be im mama? And no be Joseph, Judas, and Simon be im brothers? No be im sisters dey with us for here?” So the people no gree accept am. 4 But Jesus tell dem sey: “People dey respect prophet well well, but na for only im village, im family and im own house dem no dey respect am.” 5 So e no come do any miracle for there apart from to cure some sick people for there. 6 E really surprise am sey dem no get faith. E come waka round the village wey dey that area, dey teach dem. 7 E call the twelve disciples come arrange dem two two, and send dem comot. E give dem power to fit handle wicked spirit. 8 E still command dem sey make dem no carry anything apart from rod—make dem no carry bread, food bag, or money for their waist bag— 9 but make dem wear sandals and no wear extra garment. 10 E come still tell dem sey: “Any house wey una enter, make una stay there until una comot for the place. 11 And anywhere wey dem no gree make una enter or listen to una, as una dey comot, make una dust una leg as sign for dem.” 12 Na im dem comot go dey preach sey make people repent. 13 Dem pursue many demon comot, rub many sick people with oil and cure dem.