Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 32 p. 78-p. 79 par. 7
  • Wetin Person Fit Do On Sabbath Day?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin Person Fit Do On Sabbath Day?
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • The Disciples Pluck Wheat On Sabbath Day
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Jesus Heal People on Sabbath Day
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2018
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 32 p. 78-p. 79 par. 7
Jesus want heal one man wey im hand paralyze

CHAPTER 32

Wetin Person Fit Do On Sabbath Day?

MATTHEW 12:9-14 MARK 3:1-6 LUKE 6:6-11

  • ON SABBATH DAY JESUS HEAL ONE MAN WEY IM HAND PARALYZE

For another Sabbath day, Jesus go one synagogue. E be like sey na the one wey dey Galilee. For there, e see one man wey im right hand paralyze. (Luke 6:6) The scribes and the Pharisees come dey watch Jesus. Why dem dey watch am? The question wey dem ask am show wetin dey their mind. Dem sey: “The Law support to cure person for Sabbath day?”—Matthew 12:10.

The people wey dey lead for Jew religion, believe sey na only if the sickness serious reach to kill person na im dem fit heal am. Na im make dem put law sey make people no set bone or treat dislocation on Sabbath day. Dem feel sey e no go kill anybody. So, e clear sey dem no ask this question because dem dey pity for the man. Dem just dey find wetin dem go take hold Jesus.

But Jesus know the kind cunning mind wey dem get. E know sey dem don add their own law join wetin God Word talk about Sabbath day. (Exodus 20:8-10) No be the first time wey dem dey talk bad about the miracle wey Jesus dey do. Now, Jesus come do wetin go make dem even talk more. E tell the man wey im hand paralyze sey: “Stand up and come center.”—Mark 3:3.

Jesus look the scribes and Pharisees. E sey: “If you get one sheep, and the sheep come fall inside hole on Sabbath day, e get any of una wey no go bring am come out?” (Matthew 12:11) Sheep na wetin dey give person money, so dem no go leave am for the pit till the next day; because e fit die and dem go lose money. After all, God Word don talk sey: “Righteous person dey care for e animal.”—Proverbs 12:10.

Jesus use sense connect the story, e sey: “As e be sey human being get value well well pass sheep, so the Law support to do wetin good on Sabbath day.” (Matthew 12:12) So Jesus no break the Sabbath law as e heal the man. The leaders for Jew religion no fit follow Jesus argue because wetin Jesus talk na true and e show sey e get pity for people. Dem no come fit talk again.

Jesus vex for the way dem dey think. And e pain Jesus because dem don miss road. E come tell the man sey: “Stretch your hand.” (Matthew 12:13) As the man stretch the hand, e come heal. This one make the man happy well well. But how the people wey dey try to set trap for Jesus feel?

Pharisee and Sadducee people dey plan to kill Jesus

Instead make the Pharisees happy sey the man hand don better, quick quick, dem “come begin do meeting with the people wey dey support Herod, about how to kill Jesus.” (Mark 3:6) The Sadducees still join dem. Normally, the Sadducees and the Pharisees no dey agree, but now dem join hand to fight Jesus.

  • Describe wetin happen between Jesus and the Pharisee and Sadducee people.

  • Wetin the Pharisee and Sadducee people think about the Sabbath law wey no correct?

  • How Jesus take use sense correct dem?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share