CHAPTER 25
E Pity One Leper Come Heal Am
MATTHEW 8:1-4 MARK 1:40-45 LUKE 5:12-16
JESUS HEAL PERSON WEY GET LEPROS0Y
As Jesus and im four disciples come dey preach for “all the synagogue wey dey Galilee,” people just dey talk about all the better things wey e dey do for everywhere. (Mark 1:39) The story come reach one town, wey one man wey get leprosy dey stay. Luke wey be doctor say leprosy full the man body. (Luke 5:12) This bad disease dey spoil some part of person body, when the disease don tey for body.
So this man condition serious no be small and the law sey e no go fit stay with people. Anywhere e dey, when e see people wey dey come, e suppose shout sey e no clean. This one na to protect people so that dem no go come near am and carry this bad sickness. (Leviticus 13:45, 46) Wetin this leper come do? He waka meet Jesus, kneel down for im front, come beg am sey: “Lord, if you just want, you fit make me clean.”—Matthew 8:2.
The man really get faith for Jesus! And this disease go don suffer am well well! But wetin Jesus do? Wetin you for do if you dey there? Jesus pity the man, come stretch im hand touch the man. Jesus tell am sey: “I want do am! Make you dey clean.” (Matthew 8:3) Even though sey e go hard some people to believe, the leprosy wey dey the man body, just vanish.
You no go like am if person like Jesus, wey get soft mind and power, be your king? The way Jesus treat this leper really make us get mind sey when Jesus start to rule the whole earth, e go do wetin Psalm 72:13 talk, e sey: “E go pity for poor people and people wey dey low, and e go save the life of poor people.” That time, Jesus go do wetin e get for mind, to help everybody wey dey suffer.
Remember sey, even before Jesus heal this leper, the things wey e dey do don dey make people happy. Now people go hear again sey e don do another miracle. But Jesus no want make people get faith just because of wetin dem hear. E know wetin God Word talk, sey “e no go make people hear im voice for street.” This one mean sey e no go do notice-me! (Isaiah 42:1, 2) So, Jesus come tell the leper wey don well sey: “Make sure sey you no tell anybody, but go, make the priest see you, and make you give the gift wey Moses command.”—Matthew 8:4.
But as you know, the man happy well well sotey e no fit close mouth. As e comot, e begin tell everybody wetin happen to am. The story come make everybody want know Jesus. E get where the matter reach, Jesus no come fit dey come out for where people dey again. So sometimes, e come dey stay where people no dey. Even with that one, people still find am make e teach dem and heal dem.