Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • bhs chap. 8 pp. 83-93
  • Wetin Be God Kingdom?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin Be God Kingdom?
  • Wetin Bible Dey Teach Us?
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • WETIN BE GOD KINGDOM?
  • WETIN GOD KINGDOM GO DO?
  • WHICH TIME GOD MAKE JESUS KING?
  • Wetin Be God Kingdom?
    Good News Wey Come From God!
  • Wetin We Fit Gain as Jesus Die for Us?
    Listen to God Make You Live Forever
Wetin Bible Dey Teach Us?
bhs chap. 8 pp. 83-93

CHAPTER EIGHT

Wetin Be God Kingdom?

1. Which prayer we go talk about?

MANY people know the prayer wey dem dey call Our Father, or the Lord’s Prayer. Na this prayer Jesus take teach im disciples how to pray. Wetin e pray for? And why this prayer dey important to us for this our time?

2. Wetin be the three things wey Jesus sey make we dey pray for?

2 For the prayer, Jesus talk sey: ‘Na like this una go dey pray: Our Father wey dey heaven, make your name dey holy. Make your Kingdom come. Make wetin you get for mind for this earth happen as e dey happen for heaven.’ (Read Matthew 6:9-13.) Why Jesus teach us sey make we dey pray for this three things?​—Check Endnote 20.

3. Wetin we go learn about God Kingdom?

3 We don learn sey God name na Jehovah. We don still talk about wetin God get for mind for human being and this earth. But wetin Jesus mean when e sey: ‘Make your Kingdom come’? We go talk about wetin God Kingdom be, wetin e go do, and how e go take make God name holy.

WETIN BE GOD KINGDOM?

4. Wetin be God Kingdom, and who be the King?

4 Jehovah form im government for heaven, e come choose Jesus to be the King. Bible call this government, God Kingdom. Na Jesus be the ‘King of people wey dey rule as king and the Lord of people wey dey rule as lord.’ (1 Timothy 6:15) Jesus get the power to do better better things wey any government for this world no fit do, and if dem gather all government for this world together, Jesus power pass their own.

5. God Kingdom go rule from where? Where e go rule over?

5 Jesus go back to heaven forty days after Jehovah bring am come back to life. After, Jehovah come make am King for the Kingdom. (Acts 2:33) God Kingdom go dey rule this earth from heaven. (Revelation 11:15) Na im make Bible call am Kingdom wey dey heaven.​—2 Timothy 4:18.

6, 7. Why we fit talk sey na Jesus be the best King?

6 Bible talk sey Jesus high pass any human being wey dey rule, because na im be the ‘only person wey no fit die.’ (1 Timothy 6:16) Any human being wey dey rule go die one day, but Jesus no go ever die. All the better things wey Jesus go do for us go last forever.

7 Bible don talk am sey Jesus go be King wey no dey do partial, and wey dey pity for people well well. E sey: ‘Jehovah spirit go dey on top am, spirit wey dey give sense and understanding, spirit wey dey give advice and power, spirit wey dey make person know something and dey fear Jehovah. And e go happy to do wetin Jehovah want. E no go judge with wetin im eye see, or correct person with only wetin e hear.’ (Isaiah 11:2-4) You no go like to get that kind king?

8. How we take know sey no be only Jesus go rule for the Kingdom?

8 Jehovah don choose some people from this earth wey go follow Jesus rule for that government wey dey heaven. For example, apostle Paul tell Timothy sey: ‘If we continue to dey endure, we go rule together as king.’ (2 Timothy 2:12) How many people go follow Jesus rule?

9. How many people go follow Jesus rule? Which time Jehovah start to choose dem?

9 We learn for Chapter 7 sey apostle John see vision. For the vision, e see Jesus when e be king for heaven with 144,000 people wey still be king. Who be this 144,000 people? John talk sey: ‘Dem write im name and im Father name for front of their head.’ E still talk sey: ‘Dem be people wey dey follow the lamb no matter where e go.’ God choose dem from this earth. (Read Revelation 14:1, 4.) The 144,000 people na Christians wey serve God well, and God don choose dem to follow Jesus ‘rule this earth as king.’ When dem die, God go bring dem come back to life as spirit before e carry dem go heaven. (Revelation 5:10) Na since the time of the apostles, Jehovah start to dey choose this 144,000 people wey go join Jesus rule as king.

10. As Jehovah choose 144,000 people make dem follow Jesus rule, how that one take show sey Jehovah love us?

10 Jehovah dey care for us well well, na im make am choose human being to follow Jesus rule. Jesus go be better King because e understand us. E know how we dey feel and wetin e be like to suffer. Paul talk for Bible sey Jesus dey feel for us, e ‘fit beg for us,’ and sey ‘dem don test am for all area.’ (Hebrews 4:15; 5:8) The 144,000 people still know wetin human being dey face. When dem dey this earth, dem dey make mistake like all of us and dem still suffer from sickness, so dem know how e dey be for body. So make we get am for mind sey Jesus and the 144,000 go understand how we dey feel and the problem wey we dey face.

WETIN GOD KINGDOM GO DO?

11. Why Jesus teach im disciples sey make dem pray make things dey happen for heaven the way God want?

11 Jesus teach im disciples sey make dem pray make things dey happen for heaven as God want. Why? For Chapter 3 we learn sey Satan turn against Jehovah. Jehovah no pursue Satan and im demon comot from heaven, e leave dem make dem stay for sometime. So, no be all of dem for heaven come dey do wetin God want. We go learn more about Satan and the demons for Chapter 10.

12. Wetin be the two things wey Revelation 12:10 talk sey go happen?

12 Bible talk sey after God don make Jesus King of God Kingdom, e go fight war with Satan. (Read Revelation 12:7-10.) Bible still tell us two things wey go happen. God Kingdom go start to dey rule and na Jesus Christ go be the King, and dem go pursue Satan comot from heaven come this earth. As we don learn, this things don already happen.

13. Wetin happen for heaven after dem pursue Satan comot?

13 Bible talk about how the angels for heaven come dey happy after dem don pursue Satan and all im demons comot. E talk sey: ‘Make heaven and all of una wey dey inside dey happy!’ (Revelation 12:12) Now, peace dey heaven and all of dem get one mind because dem dey do wetin God want.

Where bad things don happen like war, fight and black smoke dey go up

Since the time wey Jesus pursue Satan come this earth, wahala don plenty for this earth no be small. All this wahala go soon end

14. Wetin Satan dey do since dem pursue am come this earth?

14 But for this earth, life no easy. Na so so bad things dey happen to people ‘because Satan don come down’ and ‘e dey vex well well because e know sey na small time remain for am.’ (Revelation 12:12) Satan eye dey red because dem don pursue am comot from heaven, and e know sey na small time remain before God go destroy am. E dey use all im power do wetin e fit do to cause wahala, pain and suffer suffer for the whole world.

15. Wetin God get for mind for this earth?

15 But wetin God get for mind for this earth never change. E still want make people wey perfect get life wey no go end for paradise. (Psalm 37:29) So how God Kingdom go take make am happen like that?

16, 17. Wetin Daniel 2:44 teach us about God Kingdom?

16 For Daniel 2:44, Bible talk sey: ‘When those king dey rule, God wey dey heaven go start one kingdom wey nothing go fit scatter. And no other kingdom go fit collect am. E go destroy other government wey dey and na only the kingdom go stand forever.’ Wetin this one teach us about God Kingdom?

17 Number one, e teach us sey God Kingdom go start to rule ‘when those king dey rule.’ This one mean sey other government go still dey rule for this earth when God Kingdom go start to rule. Number two, e tell us sey God Kingdom go last forever, and no other ­government go fit comot am. And number three, God Kingdom go fight war with all this government for this world. God Kingdom go win dem, e go come be the only government for this world. Na that time we go get the best government wey we dey find.

18. Which war God go take destroy all the king for this earth?

18 How God Kingdom go take start to rule this earth? Before God Kingdom go start to rule this earth, God go first use Armageddon destroy all the king for the whole earth. Demons don deceive all this king, and dem don gather dem dey wait for the war wey God wey get power pass go fight for im great day. And all this government go fight God Kingdom.​—Revelation 16:14, 16; check Endnote 10.

19, 20. Why we need God Kingdom?

19 Why we need God Kingdom? E reach three reason why we need am. Number one, we dey sin, na im make we dey sick and we dey die. Bible talk sey for God ­Kingdom, we no go die again. John 3:​16 talk sey: ‘God love this world well well sotey e come send im only special Son, so that anybody wey continue to get faith for am no go die, but e go get life wey no go end.’

20 Number two reason why we need God Kingdom na because wicked people full everywhere. Many people dey lie, dey do partial, and dey live life wey no clean for God eye. We no get power to comot dem, but na God get the power to comot dem and e go do am. People wey no gree stop to dey do bad things go die for Armageddon. (Read Psalm 37:10.) Number three reason why we need God Kingdom na because, government for this world dey weak, dem bad well well, and dem dey play wayo. E no dey their mind to help people do wetin God want. Bible talk sey ‘man don control man enter wahala.’

21. How God go take use im Kingdom make wetin e want dey happen for this earth?

21 After Armageddon, God go use im Kingdom take make things dey happen for this earth the way e want. For example, e go use im Kingdom comot Satan and im demons. (Revelation 20:1-3) And people no go dey sick or die again. Because of Jesus sacrifice, everybody wey serve Jehovah well go get life wey no go end for paradise. (Revelation 22:1-3) The Kingdom go make God name holy. Wetin this one mean? E mean sey when God Kingdom rule this earth, everybody wey go dey this earth that time go dey serve only Jehovah.​—Check Endnote 21.

WHICH TIME GOD MAKE JESUS KING?

22. How we take know sey God no make Jesus King as e just dey reach heaven?

22 Jesus teach im disciple make dem pray sey: ‘Make your kingdom come.’ So, e dey clear sey God Kingdom go come. Jehovah go make im Kingdom start to dey rule, and e go make Jesus the King. You think sey na as Jesus reach heaven God make am King? No, e wait small! Apostle Peter and Paul explain wetin happen after God don bring Jesus come back to life. Dem talk sey wetin dey Psalm 110:1 na about Jesus. Jehovah talk for that verse sey: ‘Sitdown for my right side until I put your enemy like stool under your leg.’ (Acts 2:32-35; Hebrews 10:12, 13) E go tey before Jehovah go make Jesus King for im Kingdom?

God go use im Kingdom make wetin e want dey happen for this earth

23. (a) When Jehovah make Jesus the King of im Kingdom? (b) Wetin we go learn for the next chapter?

23 Many years before 1914, one small group of Christian wey dey study Bible come know sey 1914 go be important year. Things wey don happen since 1914 don show sey dem correct. Na that year Jesus start to dey rule. (Psalm 110:2) E no tey after Jesus start to dey rule, e come pursue Satan come this earth and now ‘na small time remain for Satan.’ (Revelation 12:12) For the next chapter, we go learn wetin show sey we dey live for the last days. We go still learn sey God go use im Kingdom comot all the bad people and bad things wey dey this earth.​—Check Endnote 22.

WETIN WE LEARN

TRUTH 1: GOD KINGDOM NA REAL GOVERNMENT

‘Make your kingdom come. Make wetin you get for mind for this earth happen as e dey happen for heaven.’​—Matthew 6:9-13

Wetin be God Kingdom?

  • Revelation 11:15

    God Kingdom, or government, go rule this earth from heaven.

  • 1 Timothy 6:15

    Na Jesus be the King of God Kingdom.

  • Revelation 14:1, 4

    144,000 people go join Jesus rule for heaven.

  • Hebrews 4:15; 5:8

    Jesus and the 144,000 people know how we dey feel and the problem wey we dey face.

TRUTH 2: NA JESUS BE THE KING

‘E no go do partial when e dey judge common people [or, poor people].’​—Isaiah 11:4

Why Jehovah choose Jesus to be the King for im Kingdom?

  • 1 Timothy 6:16

    Any human being wey dey rule go die one day, but Jesus no go ever die again. All the better things wey Jesus go do for us go last forever.

  • Isaiah 11:2-4

    Jesus get the power to do better better things wey any government for this world no fit do, and if dem gather all government for this world together, Jesus power pass their own. Jesus no dey do partial, and e dey pity for people well well.

TRUTH 3: GOD GO USE IM KINGDOM TAKE MAKE THINGS DEY HAPPEN FOR THIS EARTH THE WAY E WANT

‘God wey dey heaven go start one kingdom wey nothing go fit scatter.’​—Daniel 2:44

Wetin God Kingdom don already do? Wetin e go do for front?

  • Revelation 12:7-12

    After Jesus start to dey rule for 1914, e pursue Satan comot from heaven come this earth. Na im make wahala, pain and suffer suffer full this world.

  • Ecclesiastes 8:9; Revelation 16:16

    Government wey dey this world dey weak, dem bad well well, and dem dey play wayo, God Kingdom go destroy all of dem for Armageddon.

  • Psalm 37:10

    God go destroy people wey no gree stop to dey do bad things.

  • Revelation 22:1-3

    When God Kingdom go dey rule this earth, nobody go sick or die again, everybody wey dey this earth go dey serve only Jehovah.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share