Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • lfb lesson 103 p. 238-p. 239 par. 2
  • ‘Make Your Kingdom Come’

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • ‘Make Your Kingdom Come’
  • Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • Similar Material
  • Wetin God Get For Mind for Us?
    Wetin Bible Dey Teach Us?
  • Wetin God Get for Mind for This Earth?
    Good News Wey Come From God!
Lesson Wey You Fit Learn From Bible
lfb lesson 103 p. 238-p. 239 par. 2
Big people and small children dey enjoy life for Paradise

LESSON 103

‘Make Your Kingdom Come’

Jehovah don promise sey: ‘I go dry all the water wey dey comot from una eye. Una no go feel pain, sick or die again. Una go forget all this bad bad things.’

When Jehovah make Adam and Eve, e put dem for the garden of Eden make dem enjoy life. Jehovah want make dem worship am and born pikin full the earth. Dem no do wetin God tell dem, but that one no change wetin God get for mind. For this book, we don learn sey anything wey God talk must happen. God Kingdom go bring better better things come this earth, as e promise Abraham.

Big people, small children, and different different animal dey play together for Paradise

E no go tey, Satan and im demon, and all the bad bad people go die. People wey dey alive go worship Jehovah. Nobody go sick or die. Everyday we go wake up with strong body and we go dey happy. The earth go fine well well. Better house and food go dey for everybody. People go love theirself. Nobody go dey cause wahala. We and all the animal go be friend. Animal no go dey fear us and we no go fear any animal, even lion.

We go happy well well when Jehovah go bring people wey don die come back to life. We go welcome people wey don die tey tey like Abel, Noah, Abraham, Sarah, Moses, Ruth, Esther and David. Dem go join hand with us make the earth paradise. Better better work go dey.

Jehovah want make you enter paradise. You go come know many many things about Jehovah wey you never know before. So make we near Jehovah, and make we no stop to be im friend.

‘Jehovah our God, na only you reach to get all the power, praise and respect because na you make everything.’​—Revelation 4:11

Question: How God Kingdom go take change life for earth? For all the people wey you read about for this book, which one you go like ask question for Paradise?

Revelation 21:3, 4; Job 33:25; Proverbs 2:21, 22; Isaiah 11:2-10; 33:24; 65:21; Matthew 6:9, 10; John 5:28, 29; 17:3

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share