Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 November pp. 14-18
  • You Value Bible Well Well?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • You Value Bible Well Well?
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • BIBLE TEACH US HOW TO CONTROL OUR TEMPER
  • NO FORGET SEY NA JEHOVAH DEY LEAD US
  • JEHOVAH ORGANIZATION DEY MOVE!
  • HOLD JEHOVAH TIGHT AND SUPPORT IM ORGANIZATION
  • Jehovah Dey Arrange Im People as Bible Talk
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 November pp. 14-18
As Euodia and Syntyche dey talk to people for congregation, na so dem dey eye each other, dey vex for each other

You Value Bible Well Well?

‘When una hear God Word, una believe am as e really be; as God word.’​—1 THESS. 2:13.

SONG: 114, 113

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • Which advice Bible give wey fit help us control how we dey feel?

  • Why we fit talk sey Jehovah organization dey move?

  • How you go take show sey you dey use all your mind support Jehovah organization?

1-3. Which example we fit use take explain wetin cause Euodia and Syntyche quarrel, and wetin we fit do make that kind thing no happen? (Check the first picture.)

JEHOVAH people value Bible well well because dem know sey na God holy book. Because we dey make mistake sometimes, dem dey use Bible correct us. If dem correct us wetin we go do? See wetin happen to Euodia and Syntyche for apostle time. This two anointed sisters get serious quarrel. Wetin cause am? Bible no tell us. But make we use example show wetin fit cause that kind quarrel.

2 Think am sey Euodia invite some brothers and sisters come get together for im house and e no invite Syntyche. But Syntyche hear sey everybody wey go enjoy theirself well well. Syntyche fit talk sey: ‘Na wa o! I no believe sey Euodia go do get together e no invite me, I think sey we be tight friend.’ Because e dey vex, e no come trust Euodia again. Na im Syntyche come arrange im own get together, invite the same people wey Euodia invite but e no invite Euodia. The quarrel wey this two sisters get fit don cause big problem for the congregation. Bible no tell us how the matter take end, but we dey sure sey this sisters follow apostle Paul advice.​—Phil. 4:2, 3.

3 Today, that kind thing dey cause problem for congregation sometimes. But if we follow wetin Bible talk, we fit settle the problem or e no go happen at all. If we value Bible well well, we go let wetin e talk direct our life.​—Ps. 27:11.

BIBLE TEACH US HOW TO CONTROL OUR TEMPER

4, 5. Which advice Bible give wey fit help us control how we dey feel?

4 If person curse us, or do wetin pain us, e no easy for us to control ourself make we no vex. E dey pain well well if people dey treat us anyhow because of our tribe, skin color, or because we no be like dem. Where that kind thing for dey pain pass na, if na brother or sister for congregation do us. Bible give us any advice wey fit help us if this kind thing happen?

5 Since when Jehovah make us, e dey see how people dey treat each other. E know how we dey feel and e dey see wetin we dey do. The things wey we dey think, fit make us talk or do wetin we go later regret especially if we dey vex. So na better thing to follow wetin Bible talk when e sey make we dey control our temper and make we no dey quick vex. (Read Proverbs 16:32; Ecclesiastes 7:⁠9.) The truth be sey, all of us need to learn how to control how we dey feel and we need to dey quick forgive. To Jehovah and Jesus, to dey forgive na serious matter. (Matt. 6:14, 15) Ask yourself, ‘I ready to dey forgive and control how I dey feel?’

6. Why e good make we no dey vex anyhow?

6 Many times, people wey dey vex anyhow no dey gree forgive. Because of this one, people go dey run from dem. Person wey get this kind character fit cause big problem for congregation. Even if e try hide how e dey feel, brothers for im congregation go still know. (Prov. 26:24-26) But elders fit help the person see sey to dey vex anyhow, hate people or to carry wetin dem do am for mind, no be wetin Jehovah organization support. Bible explain this matter well. (Lev. 19:17, 18; Rom. 3:11-18) You see am like that?

NO FORGET SEY NA JEHOVAH DEY LEAD US

7, 8. (a) How Jehovah take dey lead im organization wey dey this earth? (b) Wetin be some of the things wey Bible sey make we do, and why e good make we do dem?

7 Jehovah dey use ‘the better slave wey get sense and wey dem fit trust’ lead and teach im organization for earth. This slave dey under Jesus Christ wey be the ‘head for the congregation.’ (Matt. 24:45-47; Eph. 5:23) Like the governing body for apostle dem time, this slave believe sey everything wey dey Bible na God Word or message and dem value am well well. (Read 1 Thessalonians 2:13.) Wetin be some of the things wey Bible sey make we do?

8 Bible tell us sey make we no dey miss our meeting. (Heb. 10:24, 25) E tell us sey make all of us dey believe the same thing. (1 Cor. 1:10) For Bible, we learn sey make we put God Kingdom first for our life. (Matt. 6:33) Bible still dey help us know why we suppose dey preach from house to house, for open place, and anywhere wey people dey. (Matt. 28:19, 20; Acts 5:42; 17:17; 20:20) Bible tell elders sey make dem no let anything spoil Jehovah organization. (1 Cor. 5:1-5, 13; 1 Tim. 5:19-21) And Jehovah don talk sey everybody wey dey im organization must dey clean for body and comot hand for things wey e no like.​—2 Cor. 7:1.

9. Who Jesus give the work to dey help us sabi wetin dey Bible?

9 Some people fit think sey dem fit explain the meaning of wetin dey Bible by theirself. But the thing be sey, na only the ‘better slave wey dem fit trust,’ Jesus don give the work to dey teach us. Since 1919, our king Jesus Christ don dey use this slave help im people sabi wetin dey Bible and to dey do am. If we do wetin Bible talk, we dey join to make congregation clean, get peace and one mind. E go good make we ask ourself, ‘I dey support the people wey Jesus dey use teach us today?’

JEHOVAH ORGANIZATION DEY MOVE!

10. For Bible, how Ezekiel take explain Jehovah organization wey dey heaven?

10 Bible help us know how Jehovah organization for heaven be. For example, for one vision, Jehovah show prophet Ezekiel how im organization for heaven take be like chariot. (Ezek. 1:4-28) Na Jehovah dey ride this chariot and na anywhere im spirit want, the chariot dey go. The organization wey dey heaven dey control the one wey dey earth. And e don tey wey this chariot dey move! Think about many things wey don change for our organization since the last ten years. Get am for mind sey na Jehovah dey make all this change happen. As e be sey Jesus Christ and im holy angels go soon comot this wicked world, Jehovah chariot dey move fast fast to show sey na Jehovah get right to rule and to clean im holy name.

One brother wey dey join build where we for dey worship Jehovah

We dey thank Jehovah for the many brothers and sisters wey dey use all their power build where we dey worship Jehovah! (Check paragraph 11)

11, 12. Wetin be some things wey Jehovah organization don do?

11 Make we come talk about the things wey Jehovah organization for this earth dey do for this our time. We dey build. Plenty people dey work well well for our new headquarter wey dey Warwick, for U.S.A. The Worldwide Design/Construction Department dey direct plenty people for the whole world wey dey build Kingdom Hall and branch office. We dey thank Jehovah for all this plenty brothers and sisters wey dey use all their power for this work. No forget sey Jehovah dey bless people for the whole earth wey dey use all their mind contribute so that this work go go well.​—Luke 21:1-4.

12 We dey teach. Think about the plenty school wey Jehovah take dey teach im people. (Isa. 2:2, 3) We get Pioneer Service School, School for Kingdom Evangelizers, Gilead School, Bethel Entrants School, School for Circuit Overseer and Their Wife, School for Congregation Elders, Kingdom Ministry School, and School for Branch Committee Members and Their Wife. Jehovah dey happy to teach im people well well! For jw.org, you go still see wetin Bible dey teach and our book dem for many language. This website get special part for small small pikin, for family and for things wey dey happen around the world. You dey use jw.org for preaching?

HOLD JEHOVAH TIGHT AND SUPPORT IM ORGANIZATION

13. Wetin dey our hand to do as we don know wetin Jehovah want from us?

13 We happy for the chance wey Jehovah give us to dey part of im organization. As we don know wetin God want from us, wetin e like and wetin e no like, na our hand e dey to do the correct thing and to show sey na im get right to rule. As the bad things wey dey happen for this world dey plenty more more, make we ‘hate wetin bad’ the way Jehovah hate am. (Ps. 97:10) We no be like people for this world wey dey talk sey ‘good na bad and bad na good.’ (Isa. 5:20) Because we want do wetin go make God happy, we dey try make we dey clean for body, run from sex matter wey no clean for God eye, and comot hand for lie lie religion. (1 Cor. 6:9-11) We love Jehovah and we trust am. As we dey follow wetin Bible talk for our life, we dey show sey we hold Jehovah tight. We dey do everything wey we fit do to obey Jehovah for anywhere we dey. Whether na for house, congregation, work or school. (Prov. 15:3) Make we see other way to take show sey we hold Jehovah tight.

14. How papa and mama wey dey serve Jehovah go take show sey dem hold Jehovah tight?

14 We dey train our pikin. Papa and mama wey dey serve Jehovah dey show sey dem hold Jehovah tight if dem dey use Bible train their pikin. Dem no dey train their pikin like people wey no know God. And dem no go let the bad character wey people for this world get, affect their family. (Eph. 2:2) Papa no go talk sey, ‘For our country, na woman dey train pikin.’ Wetin Bible talk about this matter dey clear. E talk sey: ‘Papa, make una dey use Jehovah way correct [una pikin] and dey teach dem.’ (Eph. 6:4; ftn.) Papa and mama wey dey serve Jehovah well, want make their pikin be like Samuel wey Jehovah support as e dey grow.​—1 Sam. 3:⁠19.

15. How we go take show sey we hold Jehovah tight if we want choose wetin we go do?

15 When we dey choose wetin we go do. One way to show sey we hold Jehovah tight, na to follow wetin Bible and Jehovah organization talk if we want choose wetin go really affect our life. To show why we no suppose take am play, see one serious matter wey concern some papa and mama. When some people wey go abroad born pikin, dem dey like send the pikin go house make their family people train am for dem. Dem dey do am so that dem go fit continue to dey work and make money for the country wey dem dey. Na true sey na you go choose wetin you go do, but make we no forget sey God go judge us for wetin we do. (Read Romans 14:12.) You think sey e good to choose wetin we want do before we check wetin Bible talk? No! We need Jehovah help because we no go fit help ourself.​—Jer. 10:23.

16. When one woman born pikin, wetin e want do, but wetin help am do the correct thing?

16 One woman wey born boy when e dey abroad, want send the pikin go back to im country make im husband papa and mama train am. The time wey e born the pikin, one Jehovah Witness person come dey study Bible with am. As e dey try do wetin e dey learn, e come see sey to train im pikin to serve Jehovah, na the work wey God don give am. (Ps. 127:3; Prov. 22:6) The woman come tell Jehovah everything wey dey worry am for mind as Bible sey make we do. (Ps. 62:7, 8) E still tell the person wey dey teach am Bible and other people for congregation. Even though sey im family people and im friends dey tell am sey make e send the pikin go back, e make up im mind sey that kind thing no good. The way the congregation help the woman and im pikin sweet im husband well well. This one come make am start to dey study Bible and dey go meeting with dem. E really clear for the woman eye sey Jehovah answer im prayer.

17. Wetin dem don tell us about our Bible student?

17 We dey do wetin God talk. One better way we take dey show sey we hold Jehovah tight na to dey do wetin im organization tell us. For example, see wetin dem tell us about our Bible student. Dem tell us sey small time after we start to study the book What Does the Bible Really Teach? with person, make we use some minute tell am about Jehovah organization everytime wey we study with am but e go be after we study finish. We go fit use the video Wetin Dey Happen for Our Kingdom Hall? and the brochure Which People dey Do Wetin Jehovah Want Today? Dem sey if we don study Bible Teach book with am finish, make we study “Keep Yourselves in God’s Love” with am even though sey e don baptize. Jehovah organization don tell us make we do am like that so that the person go know the truth well. (Col. 2:7) You dey do am the way Jehovah organization tell us?

18, 19. Why we suppose dey thank Jehovah?

18 We get plenty reason to dey thank Jehovah. Na im give us life, and if no be because of am, we for no dey alive or even fit waka. (Acts 17:27, 28) E don give us one special gift wey be im book, the Bible. Like Christians for Thessalonica, we dey happy, and we believe sey Bible na God word.​—1 Thess. 2:13.

19 As God Word dey our hand, e don make us fit near God and God don near us. (Jas. 4:8) Our Papa wey dey heaven don give us better chance to join im organization. We really happy for this gift? The way the person wey write psalm 136 talk am, sweet well well. E talk sey: ‘Thank Jehovah, because e good; im love wey no dey fail, no dey ever end.’ (Ps. 136:⁠1) For Psalm 136, na twenty six times dem write the word: ‘Im love wey no dey fail, no dey ever end.’ If we hold Jehovah and im organization tight, we go see sey that word na true, because Jehovah go give us life wey no go end!

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share