‘Give Men Wey You Fit Trust’
‘Carry this things give men wey you fit trust, wey go fit still teach other people.’—2 TIM. 2:2.
1, 2. Wetin many people think about the work wey dem dey do?
MANY people feel sey na their work go make people respect dem. For some place, if dem see person wey dem no know before, one of the first thing wey dem go ask am na, “Which work you dey do?”
2 Sometimes, Bible dey use the work wey people do take talk about dem. E talk about ‘Matthew wey be tax collector’; ‘Simon wey dey make leather’; and ‘Luke, the doctor wey dem love.’ (Matt. 10:3; Acts 10:6; Col. 4:14) E still use the work wey people dey do for Jehovah talk about dem. For example, e talk about King David, prophet Elijah, and apostle Paul. This people no play with the work wey dem do for Jehovah. If we get work wey we dey do for Jehovah, make we self value am.
3. Why people wey don dey old need to train young men? (Check the first picture.)
3 Many of us like the work wey we dey do for Jehovah and we fit no want stop am. But since Adam time, as people dey old and dey die go, other people dey come. (Eccl. 1:4) As things dey change like that, e fit make some things hard for Jehovah people today. Because Jehovah dey bless our preaching work, the way we dey do am dey change. We dey use technology dey do some things for the work and new technology dey come out every day. This one fit make am hard for some old people to learn the new way we take dey do things. (Luke 5:39) Even if no be so e be for all the old people, young people get power pass old people. (Prov. 20:29) So, the love wey people wey don dey old get, suppose make dem dey train young men to do more work for congregation.—Read Psalm 71:18.
4. Why e hard for some people to leave work for young people? (Check the box “Why Some People No Dey Gree Train Other People.”)
4 E fit no easy for people to leave work wey dem don dey do for young people. Dem no want leave the work because dem like am well well. Other people feel sey if dem no fit direct the work, the young men no go fit. And other people still feel sey dem no get time to train people. Even if e be like that, make young men for congregation dey patient if dem never give dem more work.
5. Which question dem we go talk about for this topic?
5 Make we look the matter from two side. (1) How people wey don dey old go take help young people do more work for congregation, and why this one good? (2 Tim. 2:2) (2) Why e good make young men for congregation behave well as dem dey help the old brothers, and why e good to learn from dem? Make we first talk about how King David take help im pikin ready to do one big work.
DAVID HELP SOLOMON READY
6. Wetin David want do, but wetin Jehovah get for mind?
6 For many years David no get house to stay, e dey stay for anywhere wey e see. After, e come dey stay for better house when e don be king. But im mind come dey worry am sey Jehovah no get “house,” or temple. This one make am want build temple for Jehovah. E come tell Nathan sey: ‘See, I dey stay for house wey dem use cedar do, but the ark of Jehovah agreement dey for house wey dem use tent cloth make.’ Nathan come tell am sey: ‘Do wetin dey your mind, because the true God dey with you.’ But, Jehovah get another thing for mind. E tell Nathan make e tell David sey: ‘No be you go build the house wey I go stay.’ Jehovah tell David sey e no go stop to bless am because of how e love David reach. But na Solomon im pikin go build the temple. Wetin David come do?—1 Chron. 17:1-4, 8, 11, 12; 29:1.
7. Wetin David do about wetin Jehovah talk?
7 Even though sey no be David go build the temple, e no let am pain am sotey e no come support Solomon. True true, people come know Solomon as the person wey build the temple, no be David. E fit don pain David sey e no do wetin e get for mind, but e still use everything support the work. E use all im mind arrange people wey go do the work and e gather iron, copper, silver, gold, and cedar wood. E come still tell Solomon sey: ‘Now, my pikin, make Jehovah dey with you, and make you fit build the house for Jehovah your God, just as e don talk about you.’—1 Chron. 22:11, 14-16.
8. Wetin make David fit dey think sey Solomon no go fit direct the work, but wetin David do?
8 Read 1 Chronicles 22:5. David fit dey think sey Solomon no go fit direct that kind big work. Why? Because that time, Solomon ‘still young and e never do that kind work before’ and the temple suppose ‘big and fine well well.’ But David know sey, Jehovah go help Solomon do the work wey E give am. So David do everything wey e fit do to support the work. Na im make e arrange many things down for the work.
YOU GO HAPPY IF YOU DEY TRAIN PEOPLE
E dey sweet us as young men for congregation dey do more work for Jehovah (Check paragraph 9)
9. Wetin go make body sweet old brothers sey young men don dey do the work wey dem first do? Give example.
9 When time reach, make e no pain brothers wey don dey old sey dem want leave their work for young men. Instead, make dem remember sey to train young men go make the work go front. Make body dey sweet dem sey, the young men wey dem train, don dey do the work. To make us understand well, make we use example of papa wey dey teach im pikin how to drive motor. When the pikin still small, e go dey look im papa as e dey drive. But when e don big small, the papa go dey tell am wetin e dey do. Then when the pikin don reach age to drive, e go start to drive the motor and im papa go still dey tell am other things wey e need to do. Sometimes, dem fit dey drive the motor turn by turn. But as time dey go, na the pikin go dey drive am pass im papa, because the papa don dey old. And e fit reach time wey only the pikin go dey drive. Papa wey get sense, go happy sey na im pikin dey drive now, no be am again. Na so e still be with old brothers for congregation. E dey sweet dem sey dem don train young men for congregation wey go dey do the work for Jehovah organization.
10. How Moses take show sey no be only imself e dey think about?
10 If we don dey old, make we no let jealousy enter our mind. You fit learn from wetin Moses do when other people for Israel come dey behave like prophet. (Read Numbers 11:24-29.) Joshua, wey dey help Moses, want stop dem. E fit dey think sey if this people continue to do like prophet, Israel people fit no dey respect Moses again. But Moses tell am sey: ‘You dey jealous dem because of me? No be so. If e fit happen, I want make everybody wey dey serve Jehovah be prophet and make Jehovah put im spirit on top dem!’ Moses see Jehovah hand for the matter. Moses want make other people still enjoy to do this kind work for Jehovah, no be only am. Like Moses, e dey sweet us sey dem give another person the work wey we think sey na we dem suppose give?
11. How one brother feel when one young brother come dey do the work wey im dey do before?
11 For our time, we get many example of brothers wey don use all their power do Jehovah work for many years. And dem don still train other people to fit do more work. For example, e pass 74 years wey one brother wey im name na Peter don dey do full-time work for Jehovah. For inside this 74 years, e use 35 years work for one branch office for Europe. Before, na im be the overseer for the Service Department for that branch. But now na Paul, one young brother wey dey work with am before, come be the overseer. How Peter feel about wetin happen? E sey: ‘I happy well well sey we get brothers wey dem don train to fit do more work, and wey dey do the work well.’
VALUE OLD PEOPLE WEY DEY CONGREGATION
12. Wetin we learn from Rehoboam story?
12 After Solomon die, na im pikin Rehoboam come be king. When Rehoboam want advice about how e go take do im work as king, na people wey senior am e first go meet. But e trowey their advice! Instead, na advice of the young people wey dey around im age and wey dey work for am, e follow. Wetin come happen? Things scatter! (2 Chron. 10:6-11, 19) Wetin we learn? E go make sense if we go meet old people wey don do the work before for advice, and think about wetin dem talk. But make young people no feel sey dem must do the work the way dem meet am. And e still good make dem no quick talk sey the advice of this our old brothers no go work.
13. How young men for congregation fit work well with the old brothers?
13 Some young men for congregation fit come dey direct how the old brothers go dey do the work. Even if na so, make dem hear wetin the old brothers go talk before dem do things. E good make dem dey learn from this old brothers. Paul, wey we talk about, wey come dey do the work wey Peter dey do before, talk sey, ‘I dey go meet Peter for advice, and I tell other brothers for the department make dem dey go meet am too.’
14. Wetin we learn from the way apostle Paul and Timothy take work together?
14 Timothy work with apostle Paul for many years, even though sey Paul senior am. (Read Philippians 2:20-22.) Paul write letter give the congregation wey dey Corinth sey: ‘I dey send Timothy come meet una, because na my pikin wey I love and wey dey follow wetin the Lord talk. E go help una remember the different different way I take dey teach, like Jesus, as I dey teach for all the congregation for everywhere.’ (1 Cor. 4:17) Wetin Paul talk for this verse show sey im and Timothy na tight friend and dem work well together. Paul take time teach Timothy the ‘different different way e take dey teach, like Jesus.’ Timothy learn wetin Paul teach am well and Paul come like Timothy. E dey sure sey Timothy fit teach the brothers and sisters for Corinth wetin go make their faith strong. Like Paul, make elders for congregation dey train other brothers wey go later direct the work!
ALL OF US GET WETIN WE FIT DO
15. How Romans 12:3-5 fit help us if our work for Jehovah change?
15 Many things dey happen for Jehovah organization now. Jehovah dey bless im organization and many people dey come serve am. This one dey make how we dey do things for Jehovah organization change. So even if our work change, make we continue to carry ourself down. And make we remember sey na wetin Jehovah want we suppose do, no be our own. This one go make us dey do things with one mind. Paul write give Christians wey dey Rome, sey: ‘I tell everybody wey dey with una sey, make e no dey think about imself pass the way e suppose think, but make e dey think about how e go get better mind, everybody as God take give am faith. Because as we take get many part for one body, but all the part no dey do the same work, na so we, even though we many, be one body with Christ.’—Rom. 12:3-5.
16. Wetin old brothers, young men and their wife fit do make Jehovah organization dey get peace and one mind?
16 So, no matter the kind work wey we dey do for Jehovah, make all of us do wetin we fit do to support Jehovah Kingdom. Old brothers, make una train young men for congregation to fit do una work. Young brothers, make una no run from work, no do oversabi, and dey respect the old brothers. Una wey be wife, make una dey support una husband as Priscilla take support Aquila im husband, even as things change for dem.—Acts 18:2.
17. Wetin Jesus trust im disciples sey dem fit do, and wetin e train dem to do?
17 Na Jesus example of how to train other people to do more work better pass. E know sey im preaching work for this world go finish one day and other people go continue the work. Im disciples dey do mistake. But e still trust dem sey dem go fit do the work and dem go do pass am. (John 14:12) Because e train dem well, dem come fit preach the good news for everywhere for their time.—Col. 1:23.
18. Which better work dey front, but which work we fit do now?
18 After Jesus die for us, God resurrect am go heaven where e give am more work. God make am King and e give am power wey pass other power. (Eph. 1:19-21) If we serve God well and we die before Armageddon, God go resurrect us enter paradise. For there, we go get plenty better work to do. But today, we dey do one big work—we dey preach the good news so that people go come serve Jehovah. Make all of us, whether we young or old, continue to ‘get plenty work wey we dey do’ for Jehovah.—1 Cor. 15:58.