Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 June pp. 27-31
  • Show Sey Jehovah Na Your King

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Show Sey Jehovah Na Your King
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • NA JEHOVAH SUPPOSE RULE US
  • THE WAY JEHOVAH DEY RULE NA IM BETTER PASS
  • CONTINUE TO SUPPORT JEHOVAH AS KING
  • No Forget the Main Thing
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 June pp. 27-31
Jehovah throne

Show Sey Jehovah Na Your King

‘Jehovah our God, na only you reach to get all the power, praise and respect because na you make everything.’​—REV. 4:11.

SONG: 112, 133

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • Why e be sey na Jehovah suppose be King for heaven and earth?

  • Why nobody go fit rule like Jehovah?

  • Wetin we go dey do to show sey Jehovah na our King?

1, 2. Why e good to think about how Jehovah dey rule? (Check the first picture.)

FOR the topic before this one, we learn about the lie wey Devil talk about Jehovah. E sey Jehovah no dey rule us well. E still sey our life go better if no be God dey rule us. Wetin Devil talk na true? Think am sey people wey no support Jehovah as King fit live forever. You think sey e go better for dem if God no rule dem? What of you? If you no support Jehovah as King and you fit live forever, you think sey na that time you go happy pass?

2 Nobody go help you answer this question dem. Na your hand e dey to think this matter well. If you think am well, you go really see am sey na Jehovah suppose be King. You go still see sey nobody fit rule like am. This one go make you use all your mind support am. Make we come learn some things for Bible wey go help us see sey, true true, na only Jehovah suppose rule. And we go still see sey the way e dey rule na im better pass.

NA JEHOVAH SUPPOSE RULE US

3. Why e be sey na only Jehovah suppose be King for heaven and earth?

3 Na Jehovah suppose rule us because na im get power pass and na im make everything. (1 Chron. 29:11; Acts 4:24) For one vision, wey dey Revelation 4:​11, the 144,000 wey go follow Jesus rule for heaven talk sey: ‘Jehovah our God, na only you reach to get all the power, praise and respect because na you make everything. Everything dey, because you want am like that.’ So, e clear sey because na Jehovah make everything, na im suppose be King for heaven and earth. Nobody fit drag am with am!

4. If we no dey support Jehovah, we dey use our chance well? Explain.

4 What of Satan? E don fit make anything? For where! So, e no suppose open mouth talk sey e want rule. Because of oversabi, Adam and Eve with Satan, no support Jehovah. (Jer. 10:23) God make dem to fit choose wetin dem want. Dem fit choose whether dem go support God or dem no go support am. But that one no mean sey dem suppose leave God. The chance wey Jehovah give us na to choose better thing, no be to do bad. So, when we do things wey Jehovah hate, we no dey use this chance well. Because na Jehovah give us life, make e be the only Person wey go tell us wetin to do.

5. Wetin make us dey sure sey Jehovah dey always do wetin correct?

5 E still get another thing wey make us fit talk sey na Jehovah suppose rule us. Everything wey e dey do correct finish. E talk for Bible sey: ‘I be Jehovah, the person wey dey show love wey no dey fail. I dey judge well and I dey do wetin correct for the earth. This kind thing dey sweet me well well.’ (Jer. 9:24) Jehovah no need person to write law for am about wetin correct. E dey always do the correct thing. Na this one make am give human being law wey dem go follow. Bible talk sey, Jehovah ‘throne dey on top wetin correct, and e dey rule well.’ This one make us dey sure sey, all the law wey Jehovah give us correct. (Ps. 89:14; 119:128) Satan no be like Jehovah. E sey Jehovah no dey rule well. But how the world wey Satan dey rule be? Many people no dey do wetin good.

6. Wetin be another thing wey make Jehovah be the Person wey suppose rule us?

6 Na only Jehovah get the sense to fit take care of heaven and earth. This one na another thing wey make Jehovah be the Person wey suppose rule us. For example, when Jesus dey this earth, God give am power to cure sickness wey doctor no fit cure. (Matt. 4:23, 24; Mark 5:25-29) For our eye, wetin Jesus do na miracle. But for Jehovah eye, no be miracle. Why? Because e know everything wey dey our body. E still know how e go take cure any sickness. Jehovah get power to bring person wey don die come life again. And e fit stop things like, heavy rain or breeze wey fit kill people or spoil their property.

7. How Jehovah sense take pass the one wey dey this world?

7 For this world wey Satan dey control, peace no dey. Country dey fight country and village dey fight village. Na only Jehovah get the sense to fit bring peace. (Isa. 2:3, 4; 54:13) The more we dey learn about the kind sense wey Jehovah get, we go be like apostle Paul wey talk sey: ‘God blessing many, no be small! E get deep sense and e know things well well! Wetin e get for mind and everything wey e dey do, nobody fit know am finish!’​—Rom. 11:33.

THE WAY JEHOVAH DEY RULE NA IM BETTER PASS

8. Why you like the way Jehovah take dey rule?

8 Bible don help us know sey na only Jehovah go fit rule us. E still show sey the way Jehovah dey rule na im better pass. Why e be like that? One thing be sey, Jehovah dey use love rule us. E dey really sweet us when we see how e take dey rule. Im na ‘God wey get pity and wey dey feel for person. E no dey quick vex, e dey talk true everytime,’ and im love strong well well. (Ex. 34:6) Even though sey im na our God, e still dey respect us. E dey take care of us pass as we fit take care of ourself. Satan talk sey Jehovah no want make better thing reach Im servant hand, but that one na lie. Jehovah dey give us everything wey we need to fit enjoy life. On top that one, e still send im Son make e come die for us, so that we go get life wey no go end.​—Read Psalm 84:11; Romans 8:32.

9. How we take know sey God dey see wetin we dey do one by one?

9 Jehovah no dey only see wetin all im servant dey do. E still dey see wetin we dey do one by one. For example, think about wetin e do for Israel people for olden days. For about three hundred years, Jehovah use people wey dey judge dem take save dem from their enemy. Even as things be that time, Jehovah still see wetin one woman do to fit serve am. The woman name na Ruth, and e no come from Israel. E leave im family and im country because e want serve Jehovah. Jehovah bless am for wetin e do. E give am husband and one pikin. No be only that one! Messiah come from this im pikin family. Jehovah still make sure sey dem write this woman story for Bible. And na the woman name dem dey call that part for Bible. How you think sey Ruth go feel about all this things when Jehovah bring am come life again?​—Ruth 4:13; Matt. 1:5, 16.

10. Why we fit talk sey Jehovah no dey force people do wetin e want?

10 Jehovah no dey force people do wetin e want. This one don make us free and we get joy. (2 Cor. 3:17) David talk sey: ‘Glory and respect dey for where God dey. Power and joy dey im house.’ (1 Chron. 16:7, 27) Another person wey im name na Ethan talk for book of Psalms sey: ‘The people wey dey use their voice and sweet mind praise you, dey happy. The light wey dey come from your face go continue to shine reach dem, O Jehovah. Your name dey always make belle sweet dem well well. The good thing wey you dey do dey make dem praise you.’​—Ps. 89:15, 16.

11. Wetin go help us dey sure sey how Jehovah take dey rule, na im better pass?

11 E good to always think about the better things wey Jehovah dey do for us. E go make us dey sure sey the way Jehovah dey rule us, na im better pass. Body go do us like one person wey talk for Bible sey: ‘One day for inside your temple better pass one thousand days for another place.’ (Ps. 84:10) This one na true talk! Because na Jehovah make us, e know wetin go make us happy. E don even give us pass wetin we need. Anything wey e tell us, na wetin go make life better for us. Even if e no easy for us to do am, na we go happy pass if we do am.​—Read Isaiah 48:17.

12. Wetin be the main thing wey dey make us support Jehovah as King?

12 Bible talk sey after Jesus don rule for one thousand years, some people no go still choose Jehovah as their King. (Rev. 20:7, 8) Wetin go make dem do that kind thing? That time, dem go release Devil from prison, and e go deceive people again. Na im way be that. E fit try to make people believe sey dem fit get life wey no go end, even if dem no follow wetin Jehovah talk. But that one na big lie! E good make we ask ourself: ‘We go believe this kind lie?’ No, we no go believe am. Wetin go help us na to really love Jehovah. Make we serve am because e be better Person and na im suppose rule us. Because Jehovah love us, we want make e rule us.

CONTINUE TO SUPPORT JEHOVAH AS KING

13. Which other thing we fit do to support Jehovah?

13 True true, we suppose use all our mind support Jehovah as King. As we don learn, na only Jehovah suppose be King, and na only am fit rule us well. When we dey do wetin Jehovah talk and we serve am well, we dey show sey we support am. Which other thing we fit do to support Jehovah? One way na to copy how Jehovah take dey do things. If we dey do like am, we dey show sey we like how e take dey rule and we dey support am.​—Read Ephesians 5:1, 2.

14. How papa and elders fit do like Jehovah?

14 We learn for Bible sey, Jehovah dey treat us well because e love us. If papa and elders like how Jehovah dey rule, dem go dey do like am. Dem no go dey force their family do things. One person wey do things like God and Jesus, na apostle Paul. (1 Cor. 11:⁠1) Paul no disgrace people or force dem do wetin correct. Instead, e talk wetin touch dem. (Rom. 12:1; Eph. 4:1; Philem. 8-10) Na so Jehovah dey do things. So, anybody wey support how God dey rule, go treat people well because e love dem.

15. When we respect people wey dey direct us, we dey support Jehovah. How?

15 Make we dey respect people wey dey direct us, whether na for family or for congregation. Na another way wey we fit show sey we like how Jehovah dey rule. When dem don agree to do something, we go support am even if we no understand am well. People for this world no dey do like that. But na so we go do if we want make Jehovah rule us. Na Jehovah dey use this people direct us. (Eph. 5:22, 23; 6:1-3; Heb. 13:17) Remember sey God get you for mind. So if we dey respect people wey dey direct us, e go better for us.

16. How people wey dey support Jehovah take dey choose wetin dem want do?

16 We fit still show sey we dey support Jehovah with wetin we dey choose. Jehovah no give us law for everything. But Bible help us know how e dey look any matter. For example, we no get book wey Jehovah write all the type of cloth wey e want make we wear. But wetin dey Bible show sey, e want make we dey wear better cloth as people wey dey worship am. (1 Tim. 2:9, 10) E still want make we remember sey if we no choose well, we fit spoil other people mind. (1 Cor. 10:31-33) When we want choose, make we let how Jehovah dey think and feel about matter direct us. This one go show sey we love Jehovah and we dey support the way e dey rule.

One young sister dey choose cloth; husband and wife dey talk to each other

Show sey you dey support Jehovah as King, whether for your family or for wetin you dey choose (Check paragraph 16-18)

17, 18. How husband and wife fit show sey dem like how Jehovah dey rule?

17 People wey don marry fit still copy Jehovah to show sey dem like how e dey rule. How? Their marriage fit no be wetin dem get for mind before dem marry. Serious problem fit dey the marriage. If na so e be for you, you go fit learn something from the way Jehovah take treat Israel people. Jehovah talk sey e be like husband to Israel people that time. (Isa. 54:5; 62:4) Many times, dem do wetin Jehovah no like. E come be like marriage wey get serious problem. But Jehovah no rush end the “marriage.” Instead, e forgive dem many times, and e do wetin e promise dem. (Read Psalm 106:43-45.) You no think sey you suppose follow Jehovah example?

18 If husband and wife like how Jehovah dey do things, dem go follow im example. Even if problem dey the marriage, dem no go just end am anyhow. Instead, dem go follow wetin Bible talk about wetin fit make person comot for marriage. Dem know sey na Jehovah arrange marriage. E no want make husband and wife leave each other. Bible sey na only if dem sleep with person wey no be their husband or wife, dem fit end the marriage. And if dem want, dem fit marry another person. (Matt. 19:5, 6, 9) Make dem try do wetin go make their marriage work. This one go show sey dem like how Jehovah dey rule.

19. Wetin we suppose do if we make mistake?

19 Because sin dey our body, we fit do wetin Jehovah no like sometimes. E know this one. Na im make e send Jesus come die for us. So, when we do mistake, make we beg Jehovah to forgive us. (1 John 2:1, 2) Instead of us to dey think about our mistake, make we try learn from wetin happen. If we draw body near Jehovah, e go forgive us. E go help us comot mind from wetin we do. E go still help us continue to serve am well.​—Ps. 103:3.

20. Why e good to show sey we support Jehovah as King now?

20 For paradise, na Jehovah go dey rule everybody. That time, all of us go learn how e dey do things. (Isa. 11:9) But we dey learn some of dem now. Time go soon reach when nobody go dey talk anyhow about how Jehovah dey rule. So, make we dey show sey we support how Jehovah dey rule. Make we dey do wetin e talk, and continue to serve am well. Apart from that one, make we try dey do things like Jehovah.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share