To Serve Jehovah Fit Cause Katakata for Family
‘No think sey I carry peace come the earth. Na sword I carry come, no be peace.’—MATT. 10:34.
1, 2. (a) Which peace we get now? (b) Wetin fit cause trouble for us as we dey serve Jehovah? (Check the first picture.)
NOBODY like wahala for im life. All of us like peace of mind. And we happy sey we get ‘the peace wey God dey give.’ This peace dey make our mind come down. E no dey make things worry us for mind. (Phil. 4:6, 7) Because we don give Jehovah our life, we still dey enjoy wetin Bible call ‘peace with God.’ This one mean sey we and Jehovah na friend.—Rom. 5:1.
2 But the time wey Jehovah go make peace full everywhere never come. Bible tell us sey problem go full everywhere for last days. E still talk sey many people go sabi make trouble well well. (2 Tim. 3:1-4) Satan dey teach people lie lie. As people wey dey serve God, we need to stand well make we no fall for Satan trap. (2 Cor. 10:4, 5) The main thing wey fit cause trouble for us na people for our family wey no dey serve Jehovah. Some of dem fit dey use wetin we believe take dey do yeye. Dem fit talk sey we dey cause katakata for family. Dem fit even tell us sey dem go pursue us comot for house if we no stop to serve Jehovah. Wetin we need to know about this wahala? And wetin fit help us if we dey face this kind wahala?
WETIN WE NEED TO KNOW ABOUT THIS WAHALA
3, 4. (a) Which kind problem people wey dey follow Jesus go face? (b) Wetin fit make am hard to follow Jesus?
3 Jesus know sey people for our family fit cause trouble for us as we dey follow wetin e teach. This one fit scatter the peace wey dey our family. We need to get mind to fit face this kind wahala. Jesus talk sey: ‘No think sey I carry peace come the earth. Na sword I carry come, no be peace. I come cause trouble. Man go get trouble with im papa. Daughter go get trouble with im mama. And daughter-in-law go get trouble with im mother-in-law. The truth be sey, person enemy go come from im own family.’—Matt. 10:34-36.
4 Wetin Jesus mean when e talk sey ‘No think sey I carry peace come?’ Na wetin e mean be this: People wey dey follow am go face wahala. Wetin e teach fit even make peace no dey their family again. Jesus no teach people God message to cause wahala for family. (John 18:37) But people wey dey follow am need to know sey things no go easy for dem. Why? Because people for their family and their friend fit no like wetin dem dey learn.
5. Wetin people wey dey follow Jesus face?
5 Jesus talk about the wahala wey people wey dey follow am go bear. One of dem na family wahala. (Matt. 10:38) Dem go bear am if people for their family dey laugh dem or pursue dem comot for house. This one go make Jesus happy with dem. But wetin dem gain pass the things wey dem suffer.—Read Mark 10:29, 30.
6. Wetin we go remember if people for our family dey give us problem?
6 We no go stop to love people for our family even if dem dey worry us. But make we remember sey na the love wey we get for Jehovah and Jesus suppose strong pass. (Matt. 10:37) We know sey Satan fit use the love wey we get for our family to make us stop to dey serve Jehovah. We go talk about some of the things wey our family people fit do to stop us. And wetin we fit do to bear the wahala.
WHEN OUR HUSBAND OR WIFE NO DEY SERVE JEHOVAH
7. Wetin e good make you do if your husband or wife no dey serve Jehovah?
7 Bible tell us sey ‘people wey marry go get problem.’ (1 Cor. 7:28) But your problem fit be double if your husband or wife no dey serve Jehovah. If you dey this kind condition, e good make you do wetin Jehovah want make you do. Jehovah no want make you park leave your husband or wife because e no gree join you serve am. E no want make you scatter your marriage because of that one. (1 Cor. 7:12-16) If your husband no dey serve Jehovah, e no go fit teach the family about Jehovah. But that one no mean sey make you no respect am. Na im still be head for family. What if na your wife no dey serve Jehovah? E still good make you love am and dey treat am well.—Eph. 5:22, 23, 28, 29.
8. Wetin be some question wey you fit ask yourself if your husband or wife no want make you dey serve Jehovah the way you want?
8 Your husband or wife wey no dey serve Jehovah fit no want make you serve Jehovah the way you like. For example, e get one sister wey im husband no be Jehovah Witness. E get some days wey the husband choose for am to dey go preaching. If this kind thing dey happen to you, ask yourself sey: ‘This one mean sey my husband no want make I serve Jehovah again? If no be wetin e mean be that, I fit do wetin e talk?’ If you dey think like this, e go make una no dey quarrel for wetin no reach anything.—Phil. 4:5.
9. Wetin you fit do to help your children respect your husband or wife wey no dey serve Jehovah?
9 E no easy to train your children if your husband or wife no dey serve Jehovah. For example, you need to teach your children to do wetin Bible talk when e sey make children dey obey their ‘papa and mama.’ (Eph. 6:1-3) But what if your husband or wife no dey do wetin Bible talk? Make you show your children better example. How? Make you still dey respect am. Put eye for the better character wey e get. And thank am for the better things wey e dey do. No use mouth finish your husband or wife for where your children dey. Help your children know sey God no dey force anybody to serve am. The good character of your children fit make your husband or wife come serve Jehovah.
Teach your pikin about Jehovah when any chance come (Check paragraph 10)
10. How you go take teach your children about Jehovah if your husband or wife no dey serve Jehovah?
10 Sometimes, your husband or wife wey no dey serve Jehovah fit want teach una pikin wetin no dey Bible. E fit want make dem do things like Christmas, or New Year. The husband fit still sey make the wife no teach the children Bible. Even if na so, the woman go still try teach the children Bible. (Acts 16:1; 2 Tim. 3:14, 15) For example, the husband fit no want make the wife study with the children, or carry dem go meeting. The woman fit follow wetin the man talk. But, when any chance come, e fit tell dem about Jehovah. This one go help the children learn about Jehovah and the things wey e want make dem do. (Acts 4:19, 20) Later, na the children go choose if dem go like to serve Jehovah.—Deut. 30:19, 20.a
IF YOUR FAMILY PEOPLE NO LIKE JEHOVAH WITNESS
11. Wetin fit make our family people dey give us wahala?
11 E fit be sey when you first start to study Bible with Jehovah Witness, you no tell your people. But as you continue, your faith come dey strong. You come tell dem sey you want be Jehovah Witness. (Mark 8:38) Because you no want leave Jehovah, your family people fit dey give you wahala. E get things wey you fit do make the wahala no too much and still dey serve Jehovah. Make we talk about dem.
12. Wetin be some things wey fit make our family people give us problem? But how we fit show sey we dey feel for dem?
12 Try to understand wetin dey their mind. Na true sey the truth wey we don learn from Bible dey sweet us. But our family people fit talk sey dem don deceive us, or we don join secret cult. Our people fit think sey we no love dem again because we no dey do things like Christmas with dem. Dem fit dey fear sey God go punish us when we die. E good make we try understand wetin dey their mind, and listen to dem when dem dey talk. This one go show sey we dey feel for dem, and we go know wetin dey their mind. (Prov. 20:5) Apostle Paul try preach to different kind of people. Why? Because e try understand dem. If we do like Paul, we go know how to help our family people learn Bible.—1 Cor. 9:19-23.
13. How we go take talk to our family people?
13 Sofri talk with dem. Bible talk sey: ‘Make better word dey always come out from una mouth.’ (Col. 4:6) Make we beg Jehovah to give us holy spirit so that we fit talk with our family people well. Jehovah holy spirit go help us get better character. Dem go talk many things wey no dey Bible. But no be everytime we go answer dem. If dem talk wetin pain us or do wetin vex us, make we do like Jesus apostles. Apostle Paul talk sey: ‘When dem curse us, we dey bless dem. When dem suffer us, we dey sofri bear am. When dem talk bad things about us, we dey use better word answer dem.’—1 Cor. 4:12, 13.
14. Which better thing fit come out if we get good character?
14 Get good character. Na true sey e good to talk well when we dey talk to our people wey no dey serve Jehovah. But na wetin person do dey carry weight pass wetin e talk. (Read 1 Peter 3:1, 2, 16.) If you dey behave well, your character go help your family people see sey Jehovah Witness people dey enjoy their marriage. Dem go still see sey dem dey take care of their children, dem dey live clean life, dey do things wey God like, and dem dey happy. Even if our people no gree come serve Jehovah, we fit still continue to serve Jehovah well. And we go happy sey we dey make Jehovah happy.
15. Why e good make we plan wetin we go do before quarrel start?
15 Plan wetin you go do. Think of things wey fit cause wahala and plan wetin you go do. (Prov. 12:16, 23) Na wetin one sister for Australia do be that. E sey: “My husband papa no like Jehovah Witness at all. E dey vex for us sometimes. So before we go call am, we dey pray make Jehovah help us make we no vex for am back. We dey prepare wetin we go talk with am so that quarrel no go start. Since plenty talk fit make us start to argue about Bible, we dey plan the time wey we go use talk with am reach.”
16. Wetin go help you make your mind no judge you?
16 Na true sey you no go fit run kpatakpata from all the quarrel with your family people. When e happen like that, your mind fit dey judge you. Why? Because you love dem and you dey try to do wetin go make dem happy. If e dey do you like that, still try hold Jehovah tight. Remember sey na your love for Jehovah suppose strong pass. This kind mind go make dem know sey you no dey take Jehovah play at all. The truth be sey, you no fit force dem come serve Jehovah. But you fit dey do things wey go make dem see sey e good to follow Jehovah. Na we choose to serve Jehovah. So na dem go still choose by theirself. Na the same chance Jehovah give all of us.—Isa. 48:17, 18.
IF YOUR FAMILY PERSON LEAVE JEHOVAH
17, 18. If your family person leave Jehovah, wetin fit help you bear am?
17 If dem disfellowship our family person, or e comot from Jehovah organization by imself, e dey pain us reach bone. Wetin fit help you bear am?
18 Continue to serve Jehovah. Do things wey go make your faith strong more more. Make you dey always read Bible, dey prepare for meeting, no dey miss meeting, dey go preaching, and dey pray make Jehovah help you fit bear am. (Jude 20, 21) What if you just dey do this things make e no be like sey you no do am? What if you no fit bear the pain again? No tire! As time dey go, you no go dey think am too much, and you go fit control how body dey do you. Na wetin happen to the person wey write Psalm 73 be that. Some kind things dey worry am for mind. E try comot am for mind, but e no fit. Wetin come help am? E go Jehovah temple go worship am. (Ps. 73:16, 17) If you self continue to serve Jehovah well, you go fit bear wetin happen.
19. How we fit show sey we dey support Jehovah if dem disfellowship person?
19 Support Jehovah arrangement. True true, e dey pain well well if dem disfellowship our person. But Jehovah know sey this arrangement go favor everybody, even the person wey dem disfellowship. (Read Hebrews 12:11.) For example, Jehovah talk sey make we stop to do things with person wey dem disfellowship. (1 Cor. 5:11-13) E dey pain and e no easy. But we no go dey do things with am like before, even if na our family person. Things like to call am for phone, to send message for phone or computer, or to write letter give am.
20. Which hope we get?
20 Hope dey. Bible help us know sey person wey get love dey ‘put mind sey everything go better.’ So make we get am for mind sey our person wey dem disfellowship fit come serve Jehovah again. (1 Cor. 13:7) If you see sey the person don dey change, you fit pray make Jehovah help am come back.—Isa. 44:22.
21. Wetin you go do if katakata dey your family because you dey serve Jehovah?
21 Jesus talk sey we no go fit follow am if we love any human being pass am. Jesus know sey people wey dey follow am go suffer from their family people hand. But e know sey dem go fit still stand well for im side and no shake. So if people for your family dey worry you, trust Jehovah sey e go help you fit bear am. (Isa. 41:10, 13) Get am for mind sey Jehovah and Jesus dey happy with you and dem go bless you if you no leave dem.
a If you want learn more about this matter, check “Questions From Readers” wey dey August 15, 2002 Watchtower.