Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w18 April pp. 13-14
  • Elders and Ministerial Servants—Make Una Learn From Timothy

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Elders and Ministerial Servants—Make Una Learn From Timothy
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • COPY TIMOTHY EXAMPLE
  • VALUE THE WORK WEY JEHOVAH GIVE YOU
  • Timothy Like to Dey Help People
    Teach Your Pikin
  • Paul and Timothy
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2018
w18 April pp. 13-14
Timothy

Elders And Ministerial Servants Make Una Learn From Timothy

LAST year, dem make many brothers elder and ministerial servant for Jehovah organization. If you be one of dem, know sey we love you well well. This new work wey Jehovah give you, don really make you happy.

Na true sey e fit put fear for your body small. One young elder wey im name na Jason, talk sey: “When dem make me elder, I feel sey the work too much for me.” The same thing happen to Moses and Jeremiah. When Jehovah give dem new assignment, dem come dey feel sey dem no reach to do am. (Ex. 4:10; Jer. 1:6) If na so you dey feel, wetin go help you stop to feel like that, and continue to do more for Jehovah? Make we see wetin we fit learn from Timothy.​—Acts 16:1-3.

COPY TIMOTHY EXAMPLE

E fit be sey Timothy dey around 20 years when apostle Paul invite am make e dey travel with am go do Jehovah work for different different place. Because Timothy still dey young, e fit no get mind and e fit dey fear whether e fit do the new work wey dem give am. (1 Tim. 4:11, 12; 2 Tim. 1:1, 2, 7) But after ten years, Paul tell the congregation wey dey Philippi sey: “I dey hope for the Lord Jesus sey I go soon send Timothy to una . . . Because I no get anybody wey get better character like im own.”​—Phil. 2:19, 20.

Wetin make Timothy be better elder? Make we talk about six things wey we fit learn from Timothy example.

Timothy dey give one sister gift

1. E really care for people. Paul tell the brothers for the congregation wey dey Philippi sey: “[Timothy] go really care for una matter well well.” (Phil. 2:20) Yes, Timothy care about people. E really want make dem near Jehovah, and e use all im mind help dem.

Try make you no be like one bus driver wey the only thing wey dey im mind na to quick reach the bus stop than to carry passengers. William na elder, and e don pass 20 years since when e don be elder. E advice new elders and ministerial servants sey: “Love the brothers. No just dey think about how to do your work for congregation. Instead, put mind for how you go fit help dem.”

Timothy dey read Bible give one man

2. The preaching work na number one thing to am. Paul talk sey: “All the other people dey find only wetin good for dem, no be wetin Jesus want.” (Phil. 2:21) Paul dey Rome when e write wetin dey that Bible verse. E see sey the brothers for there dey only put their own matter for mind. Dem no too dey put mind for the preaching work. But Timothy example no be like that. When the opportunity to preach the good news come, e do like prophet Isaiah, wey talk sey: “I dey here! Send me!”​—Isa. 6:8.

How you go take balance your own work and Jehovah work? Number one, know the one wey dey important pass. Paul advice us sey make we ‘make sure sey we dey do the things wey dey important pass.’ (Phil. 1:10) Make sure sey the thing wey you value pass na things wey dey important for God eye. Number two, stop to do anything wey dey chop your time and waste your energy. Paul advice Timothy sey: “Run from all the bad things wey dey hungry young people to do. Instead, do wetin good, get faith, love and peace.”​—2 Tim. 2:22.

Timothy dey give talk for congregation

3. E do God work well well. Paul tell the brothers for the congregation wey dey Philippi sey: “Una know wetin [Timothy] show about imself, sey like pikin wey dey with im papa, e work with me make the good news fit spread.” (Phil. 2:22) Timothy no lazy at all. Timothy follow Paul, and dem work together well well. This one make dem love each other more more.

For this our time, we get plenty work to do for Jehovah organization. And the work na the one wey dey make us happy. E still dey make us near our brothers and sisters pass before. So make sure sey you “always get plenty work wey you dey do for the Lord.”​—1 Cor. 15:58.

Timothy dey learn from apostle Paul

4. E do wetin e learn. Paul tell Timothy for letter sey: “You don follow wetin I teach well well, the way I live my life, wetin I use my life do, my faith, my patience, my love, the way I take endure.” (2 Tim. 3:10) Because Timothy do wetin e learn, e come make am fit get more work to do for Jehovah.​—1 Cor. 4:17.

You get anybody wey dey serve Jehovah well wey you dey follow im example? If you never get, e good make you find one. E get one brother wey don be elder for many years. Im name na Tom. E talk sey: “One brother wey be elder for many years, make me im friend, and train me well. I dey always go meet am for advice and I dey always do wetin e tell me. This one quick make my mind strong.”

Timothy dey prepare wetin to teach

5. E continue to dey train imself. Paul advice Timothy sey: “Dey train yourself with the mind to hold God tight.” (1 Tim. 4:7) Person wey dey do sport fit get coach. But e still need to train imself. Na this one make Paul tell Timothy sey: “Continue to dey put your mind to dey read for public, to dey give advice, to dey teach. . . . Think about all this things; soak yourself inside dem, so that as you dey do well everybody go dey see am.”​—1 Tim. 4:13-15.

Make you still dey train yourself. Dey study Bible and our books well. Make you dey try know the new way wey Jehovah organization sey make we dey do things. Make you no think sey you go fit use your sense handle any problem when you no do research well. To copy Timothy example, make you “dey check how you take dey live your life and wetin you dey teach everytime.”​—1 Tim. 4:16.

Timothy dey pray

6. E trust Jehovah to help am with holy spirit. When Paul dey tell Timothy about im preaching work, e tell am sey: “Protect this fine thing wey you don receive, with the help of the holy spirit wey dey inside us.” (2 Tim. 1:14) To value Jehovah work, Timothy need to put mind for God spirit to help am.

E get one brother wey don be elder for many years. Im name na Donald, and e sey: “Make elders and ministerial servants value their friendship with Jehovah. And if dem do like that, dem go dey strong more more as dem dey serve Jehovah. Make dem pray make Jehovah give dem holy spirit, and make dem try get the character wey holy spirit dey help person get. If dem do this one, dem go be blessing for congregation.”​—Ps. 84:7; 1 Pet. 4:11.

VALUE THE WORK WEY JEHOVAH GIVE YOU

Many new elder and ministerial servant, like you, dey allow Jehovah use dem well. This one dey make us happy well well. Brother Jason wey we don first talk about talk sey: “Since when dem make me elder come reach now, I don learn many things and e don help me dey strong. Now, I dey enjoy the work wey I dey do for congregation and I dey see am as big favor.”

You go continue to dey allow Jehovah use you? Make you learn from Timothy, and you self go be blessing to Jehovah people.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share