-
E Vex Kill Im BrotherLesson Wey You Fit Learn From Bible
-
-
LESSON 4
E Vex Kill Im Brother
After Adam and Eve comot for the garden of Eden, dem come born many pikin. Their first pikin name na Cain and na farmer, their second pikin name na Abel, e dey take care of sheep.
One day Cain and Abel give Jehovah sacrifice. You know wetin sacrifice mean? Sacrifice na special gift. Jehovah like the one wey Abel give but e no like the one wey Cain give. That one come make Cain vex well well. Jehovah warn Cain sey the way e dey vex go make am do bad thing. But Cain no hear word.
Instead wey Cain go follow wetin God talk, e tell Abel sey: ‘Come make we go farm.’ When only their two dey there, e use something nack Abel head. Abel come die! Wetin you think sey Jehovah go do Cain? Jehovah punish Cain, e tell am sey make e go far from im family. E no go allow Cain come back again.
Wetin we learn from wetin happen? We learn sey we fit start to dey vex if things no happen the way we think sey e suppose happen. If we see sey we dey vex for our mind or another person come tell us because e see sey we dey vex, make we quick quick control ourself before we go do bad thing.
As e be sey Abel do wetin Jehovah like, Jehovah go always remember am. God go bring Abel come back to life when e make this earth paradise.
‘First go settle with am, before you go comegive God the thing.’—Matthew 5:24
-
-
Noah ArkLesson Wey You Fit Learn From Bible
-
-
LESSON 5
Noah Ark
As time dey go, people come many for the earth. But many of dem dey do bad things. Even self, some angel for heaven come dey do bad things. Dem comot from heaven come this earth. You know wetin make dem come? Dem come this earth so that dem go fit change their body to human being own and marry wife.
Dem come born pikin. The pikin wey dem born get power well well like giant and dem come dey cause wahala for other people. Jehovah no fit let all this bad things continue to dey happen. So, e sey e go use heavy rain destroy dem.
But e get one man wey no dey do like dem. The man love Jehovah. Im name na Noah. E get one wife and three pikin, the three pikin name na Shem, Ham, and Japheth and dem don marry. Jehovah tell Noah sey make e build big ark so that im and im family no go die when e go use heavy rain destroy bad bad people. Ark be like big boat wey dey float for water. Jehovah still tell Noah sey make e carry different different animal enter the ark make dem for no die.
Noah no waste time at all, e start to dey work. Noah and im family use like 50 years take build the ark finish. Dem build am the way Jehovah tell dem. That time, Noah still warn people about the heavy rain. But nobody listen to am.
As e come be, e don reach time wey dem go enter the ark. Make we see wetin come happen.
‘As e be for Noah time, na so e go be when Son of man dey around.’—Matthew 24:37
-