Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • ll part 13 pp. 28-29
  • Wetin We Go Do If We Want Make God Happy?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin We Go Do If We Want Make God Happy?
  • Listen to God Make You Live Forever
  • Similar Material
  • The Correct Way to Serve God
    Wetin Bible Dey Teach Us?
Listen to God Make You Live Forever
ll part 13 pp. 28-29

PART 13

Wetin We Go Do If We Want Make God Happy?

No put hand for bad thing. 1 Corinthians 6:9, 10

Things wey God hate—to theif, to drink too much, smoke cigar, igbo or take snuff, fight, pray to image, worship juju

If we love Jehovah, we no go do wetin e no like.

Jehovah no want make we dey thief, make we dey drink too much or make we dey smoke cigar, smoke igbo or even take snuff.

Na bad thing to kill or comot belle. E still be bad thing for man to dey sleep with man or for woman to dey sleep with woman, because God hate am. Jehovah no want make we dey put eye for wetin no be our own and e no want make we dey fight.

E no good to dey do juju. Na only Jehovah you go worship, make you no worship any other thing.

Bad people no go enter Paradise.

  • Wetin God talk about magic?—Deuteronomy 18:10-12.

  • Why e be sey e no good to serve juju?—Isaiah 44:15-20.

Dey do wetin good. Matthew 7:12

Things wey God like—to love other people, talk true, and to dey forgive

If we want make God happy with us, we must try to dey do like am.

To show sey we love people, we go dey do wetin go make dem happy.

Make we dey talk true.

Make you dey forgive.

Two Jehovah Witness dey preach to one man

Tell people the kind person wey Jehovah be.—Isaiah 43:10.

  • Do as Jehovah dey do.—1 Peter 1:14-16.

  • Show people sey you love dem.—1 John 4:7, 8, 11.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share