CHAPTER 19
Jesus Teach One Woman From Samaria
JOHN 4:3-43
JESUS TEACH ONE SAMARIA WOMAN AND OTHER PEOPLE
WORSHIP WEY GOOD FOR GOD EYE
As Jesus and im disciples comot from Judea dey go Galilee, dem pass inside Samaria. E fit be around twelve, and dem don tire, dem come stop near Sychar so that dem go rest near one well. E fit be sey na Jacob dig the well or e pay people to dig am, many year ago. Till today, this kind well dey near the town wey dem dey call Nablus.
As Jesus dey rest near the well, im disciples come go buy food for one town wey no too far from there. When dem don comot, one Samaritan woman come there, e want fetch water. Jesus come tell am sey: “Give me water drink.”—John 4:7.
Jew and Samaria people no dey normally do things together. E don tey wey e be like that. So e surprise the woman. E come ask Jesus sey: “Why you sey make I give you water drink even though sey you be Jew person, and I be Samaria woman?” Jesus come answer am sey: “If to sey you know about the free gift from God and the person wey tell you sey, ‘Give me water drink,’ you for beg am make e give you living water and e for give you.” Na im the woman tell am sey: “Oga, you no even get bucket to fetch water, and the well deep. So where you want get that living water from? Abi you get power pass our great-great grand papa Jacob, wey make this well for us, and wey im, im children and animals drink from?”—John 4:9-12.
“Jesus come tell am sey: “Anybody wey drink this water go hungry for water again, but anybody wey drink the water wey I give am, e no go ever hungry for water at all, but the water wey I go give am go dey flow go up to give am life wey no dey end.” (John 4:13, 14) Even as Jesus tire reach, e still preach to the woman, so that e go save.
The woman come talk sey: “Oga, give me this water so that I no go hungry for water again or continue to come fetch water for here.” Now, e come be like sey Jesus change the topic. E tell the woman: “Go, call your husband, make una come.” E come tell Jesus sey: “I no get husband.” E go really surprise the woman well well to see sey Jesus know many things about am, as Jesus tell am sey: “You correct when you sey, ‘I no get husband.’ Because you don get five husband before, and the man wey you dey with now no be your husband. Na the truth you really talk.”—John 4:15-18.
The meaning of wetin Jesus tell the woman dey clear to am, e surprise and sey: “Oga, now I know sey you be prophet.” Wetin e come do show sey e dey hungry am to know more about God. How? E come talk sey: “Our papa-papa [Samaria people] dem worship God for this mountain [Mt. Gerizim, wey near there], but una [Jew people] talk sey na Jerusalem people must go worship God.”—John 4:19, 20.
Jesus still explain to am sey no be the place wey person for worship God matter. E sey: “The time dey come when una no go worship the Father again for this mountain or for Jerusalem.” E come tell the woman sey: “The time dey come and e don even reach, when all the people wey dey really worship God go worship am with spirit and truth because na this kind of people God want make dem worship am.”—John 4:21, 23, 24.
Wetin the Father dey check for people wey dey worship am well, no be where dem dey stay worship am, but how dem dey worship am. This one sweet the woman, e come sey: “I know sey Messiah wey be the Christ go come, and when e come e go explain everything to us.”—John 4:25.
Then, Jesus come tell am one important truth. E sey: “Na me, wey dey talk to you be the person.” (John 4:26) Think about am! This na woman wey come fetch water for afternoon. But Jesus still show am special favor. E just tell the woman wetin e never tell anybody before, sey na im be the Messiah.
MANY PEOPLE FROM SAMARIA BELIEVE
Jesus disciples bring food as dem come back from Sychar. Dem see Jesus for Jacob well, where dem leave am, but this time e dey talk with one woman from Samaria. As Jesus disciples reach there, the woman leave the water wey e come fetch and go back to the city.
When e reach Sychar, the woman tell the people all the things wey Jesus tell am. Because the woman really believe, e come tell dem sey: “Make una come see the man wey tell me all the things wey I don do.” To make the people want know more, e come ask dem sey: “Una sure sey no be the Christ be this?” (John 4:29) This question dey important well well, even since the time of Moses, people don dey put mind for this question. (Deuteronomy 18:18) This one make many people from the city go see Jesus by theirself.
For there, im disciples come tell am sey make e chop the food wey dem buy come. But e tell dem sey: “I get food wey I go chop, but una no know about am.” Wetin e talk surprise dem, so dem come start to dey ask each other sey: “Anybody don come give am food?” Wetin Jesus tell dem na wetin all im disciples fit learn from. E sey: “My food na to do wetin the Person wey send me want and to finish im work.”—John 4:32-34.
So the work wey Jesus dey talk about no be the wheat harvest, wey go happen around four month time. But when Jesus tell dem sey: “Make una look the farm, e don reach to harvest. Already dem don dey pay the people wey dey harvest am, and dem don dey gather the fruit for life wey no dey end. So the people wey plant and the people wey harvest, go happy together.” E dey talk about to dey help people come serve Jehovah.—John 4:35, 36.
Maybe Jesus don know the result wey go come as e preach to the woman from Samaria. Many people from Sychar get faith for Jesus because of wetin the woman tell dem. E tell dem sey: “E tell me all the this wey I don do.” (John 4:39) So, when the people from Sychar reach the well, dem sey make Jesus stay with dem and tell dem more. Jesus gree, and e stay Samaria for two days.
As Samaria people dey listen to Jesus, many of dem come believe am. Dem tell the woman sey: “No be just because of wetin you talk make us believe, now we don hear am by ourself, and we know sey na this man really be the person wey go save this world.” (John 4:42) The truth be sey the woman from Samaria don teach us better example of how to preach about the Christ, and to make wetin we talk sweet the people wey dey listen, so that dem go like to hear more.
Remember sey na four month remain before barley harvest go reach—the time wey dem go harvest. For this area, na after cold season this harvest dey happen. The period now na around November or December. So e mean sey, after the Passover for 30 C.E., Jesus and im disciples don spend about eight months for Judea, dey teach and baptize people. As dem comot from here, na their town for Galilee dem dey go. Wetin go happen to dem for there?