Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w16 December pp. 8-12
  • God Use Favor Release Una

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • God Use Favor Release Una
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • NA IM FAVOR MAKE AM FORGIVE US
  • DEY THANK GOD FOR IM FAVOR
  • YOU FIT WIN
  • We Thank God for Im Favor
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
  • Tell People the Good News About God Favor
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
w16 December pp. 8-12
Apostle Paul dey preach for Rome

God Use Favor Release Una

‘Make sin no be una oga, because na favor dey control una.’​—ROM. 6:14.

SONG: 2, 61

WETIN BE YOUR ANSWER?

  • Why e be sey na favor God show us as e send Jesus come die for us?

  • Why we fit talk sey we don ‘die leave sin’?

  • If we want really thank God for im favor, which kind sin we go still comot hand from?

1, 2. Why e good make we talk about wetin dey Romans 5:12?

THINK am sey you want talk about some Bible verse wey we sabi and wey we dey use well well. Romans 5:12 fit dey among the one wey go first come your mind? Think about wetin the verse talk, when e sey: ‘Na from one man sin enter this world, and na sin cause death, na im make everybody dey die because all of dem don sin.’

2 The book wey dem dey call What Does the Bible Really Teach? talk about that verse well well. If you dey study this book with your pikin or Bible student, you go see sey chapter 3, 5, and 6 talk about am. You fit don use am talk about why God make the earth, wetin the ransom be, and wetin dey happen to person wey don die. But you don ever think how Romans 5:12 fit help you know whether you dey do wetin Jehovah like? And, how e fit help you continue to dey put mind for the better things wey God don promise us?

3. Which truth about us go always dey our mind?

3 The truth be sey all of us na sinner. Na every day we dey make mistake. But we dey sure sey God no forget sey dem born us inside sin. So e ready to forgive us. (Ps. 103:13, 14) Jesus talk about am for the prayer wey dem dey call The Lord’s Prayer. E talk sey: ‘Forgive us our sin.’ (Luke 11:2-4) So, nothing suppose make us dey think about sin wey God don forgive. But, e still good make we talk about how e take forgive us.

NA IM FAVOR MAKE AM FORGIVE US

4, 5. (a) Wetin go help us understand Romans 5:12? (b) Wetin be the ‘favor’ wey Romans 3:24 talk about?

4 The other chapter dem wey dey the book of Romans, especially chapter 6, go help us understand wetin apostle Paul talk for Romans 5:12. We go come understand how Jehovah take forgive our sin. Apostle Paul talk for chapter 3 sey: ‘Everybody don sin and na free gift dem get when dem talk sey dem dey righteous because of im favor wey e take release dem with the ransom wey Jesus Christ pay.’ (Rom. 3:23, 24) Wetin the Greek word for ‘favor’ mean? One book talk sey, na when person use all im mind do good thing for us and e no collect anything, even when wetin e do no suppose reach our hand.

5 One man wey study language well well, wey e name na John Parkhurst talk sey: ‘Many times, when the favor na from God or Jesus Christ, e dey talk about the good thing wey dem do to take save human being from sin.’ So, the way we translate am for New World Translation dey correct. But how God take show favor to people? How e fit help you dey do wetin God like and dey put mind for wetin e promise? Make we talk about am.

6. Which better things God favor fit make people get?

6 Na Adam be the man wey make sin dey this world and wey make people dey die. So, na because of ‘one person sin, death come dey rule as king.’ Paul come talk sey na still ‘one person, Jesus Christ’ make people see the ‘surplus favor’ wey God get. (Rom. 5:12, 15, 17) That favor wey God show bring better things for everybody. Bible talk sey: ‘Another man [Jesus] wey obey God go make many people righteous.’ Another thing be sey, God favor fit make people get ‘life wey no get end,’ because Jesus Christ die for us.​—Rom. 5:19, 21.

7. Why we talk sey as God allow Jesus die for us, na better thing from God wey no suppose reach our hand?

7 Jehovah use im mind send im Son come die for us. Apart from that one, because of our sin we no reach to get wetin God and Jesus do for us to make us clean. So na good thing God do as e forgive our sin and give us life wey no go end. True true, no be wetin suppose reach our hand. So, make the way we dey live our life everyday show sey we value this better thing wey God do for us.

DEY THANK GOD FOR IM FAVOR

8. Which mistake some people dey make about God favor?

8 Because we get sin from Adam, to do bad dey always dey our mind. But make God favor no come make person dey think sey: ‘E no matter if I sin. Jehovah go still forgive me.’ For the apostle time, some people for congregation think like that. (Read Jude 4.) We fit no talk this kind thing come out, but e fit dey our mind or person fit make us dey think like that.

9, 10. How God take free Paul and other people from sin and death?

9 Paul talk sey make we no ever come dey think sey: ‘No worry, God understand, e go forgive.’ Why e talk like that? Because the Christians for im time ‘don die leave sin.’ (Read Romans 6:1, 2.) Why e talk sey dem ‘don die leave sin’ when dem still dey alive?

10 God use Jesus death take forgive Paul and other Christian for im time. E come use im holy spirit take choose dem to be im children. Na im make dem get hope to go heaven. If dem continue to do wetin Jehovah like, dem go stay for heaven and go rule with Jesus. But Paul talk sey dem ‘don die leave sin’ even when dem still dey alive dey serve God. E use wetin happen to Jesus take explain wetin e mean. Jesus die as human being and after, God come resurrect am go heaven as spirit wey no fit die again. Na the same thing with people wey go rule with am for heaven. Dem ‘don die leave sin but dem dey alive for God matter because of Jesus Christ.’ (Rom. 6:9, 11) The way dem dey live their life don change. Dem no dey do the bad things wey their body or mind want make dem do. Na wetin Paul mean when e sey dem die leave sin but dem dey alive for God matter.

11. Why we fit talk sey people wey dey serve Jehovah ‘don die leave sin’?

11 What of us? Before we come serve Jehovah we fit dey sin and we no know sey God no like wetin we dey do. That time we be like ‘slave for things wey no clean and things wey no dey law.’ So we fit sey, that time, we be ‘sin slave.’ (Rom. 6:19, 20) After we come learn the truth wey dey Bible, we change the way we dey live our life, we tell God for prayer sey we don give am our life, and we come baptize. Since that time, ‘e come from our mind to follow’ wetin dey Bible. This one mean sey, we ‘don free from sin’ and we don ‘be slave to wetin dey right.’ (Rom. 6:17, 18) So we fit sey, we ‘don die leave sin.’

12. Wetin dey our hand to choose?

12 Think am sey na you Paul dey talk to, when e sey: ‘No let sin continue to rule as king for your body make you no come dey do the things wey your body want.’ (Rom. 6:12) We fit ‘let sin continue to rule’ us if we dey do anything wey our body wey get sin want make we do. E dey our hand to choose whether we go ‘let’ sin rule or we no go let am rule. Na im make we suppose know whether e really dey our mind to let sin rule us. So, make we ask ourself: ‘I dey allow my body or my mind dey make me do bad thing? I don die leave sin? Or I dey alive for God matter?’ If we really want show sey we thank God for im favor wey make am forgive our sin, we go do wetin e like.

YOU FIT WIN

13. Wetin make us dey sure sey we fit stop to do bad things?

13 Jehovah people don stop to do the bad things wey dem dey do before dem come learn about am, come love am, and dey serve am. E fit be things wey ‘fit make dem shame now’ and wey fit make dem no get life. (Rom. 6:21) But, dem come change. Na the same thing happen to many of Jehovah servant wey Paul write about for 1 Corinthians 6:9-11. Before, some of dem dey serve juju, dey sleep with person wey no be their husband or wife, man dey play love with man, dem dey thief, dem dey over drink, and do other bad things. But God come ‘wash dem clean’ and ‘make dem dey holy.’ (1 Cor. 6:9-11) E be like sey na so some people for the congregation wey dey Rome still be. God use Paul tell dem sey: ‘Make una no dey give una body to sin make e come be something to use do wetin no good, but make una give una self to God as people wey don wake up from death, and give una body to God as something to use do wetin good.’ (Rom. 6:13) Paul dey sure sey dem go continue to do wetin good and dem go dey gain from the favor wey God dey show.

14, 15. Which question we go ask ourself about small sin?

14 Na so e still be today. Before, some brothers and sisters fit be like the brothers wey Paul talk about for first Corinthians. But dem still change. Dem stop the bad things wey dem dey do before and God come ‘wash dem clean.’ Many of us stop to do the bad things wey we dey do before, so that Jehovah go happy with us. But what of now? Now wey be sey Jehovah dey forgive our sin because of im favor, you want continue to dey ‘give your body to sin’? Or, you go give yourself to God as person wey don comot hand from sin?

15 This one mean sey we no go dey put hand for serious sin wey some brothers do for apostle Paul time. Na wetin we must do be that if we want make God show us favor and if we no want make sin be our oga. But, we dey try do everything wey we fit do to comot hand from small sin as some people dey call am? If we do am, we dey show sey ‘e dey come from our mind to follow’ wetin Bible talk.​—Rom. 6:14, 17.

16. How we take know sey no be only the bad things wey 1 Corinthians 6:9-11 talk about we need to comot hand from?

16 Make we talk about apostle Paul again. We dey sure sey e no put hand for the bad things wey e talk about for 1 Corinthians 6:9-11. But e still talk sey e dey sin. E talk sey: ‘I be person wey get flesh, wey dem sell give sin. I no understand wetin I dey do. Because I no dey do wetin I want do, but na wetin I hate I dey do.’ (Rom. 7:14, 15) This one show sey e get some other things wey Paul see as sin. And e talk for Bible sey e still dey fight this bad things wey e see as sin. (Read Romans 7:21-23.) Make we do like Paul. Make we do everything wey we fit do to do wetin Jehovah want.

17. Why you no suppose lie?

17 For example, Bible talk sey make Jehovah servant no dey lie. (Read Proverbs 14:5; Ephesians 4:25.) Devil na ‘papa of lie.’ And make we no forget sey Ananias and im wife die because dem lie. We no want copy dem, so we no dey lie. (John 8:44; Acts 5:1-11) But what of some other things wey some people no dey see as lie? If we really want thank God for the favor wey e show us, we go still comot hand from dem.

18, 19. Na true sey person fit talk wetin no be lie and e no go still be true? How?

18 For person to lie, e don talk wetin no be true. But, sometimes person fit talk wetin no be straight lie to deceive another person. But no be wetin Jehovah want be that. E advise Israel people sey: ‘Make una dey holy, because me, Jehovah una God, dey holy.’ E come tell dem some things wey dem go dey do to show sey dem dey holy. Part of the things wey e talk na: ‘Make una no thief, make una no deceive person, and make una no lie give each other.’ (Lev. 19:2, 11) Person fit no lie but e fit come dey deceive other people, dey tell dem wetin no be true.

One brother dey talk to im oga and other people wey e dey work with dey listen

We dey try make we no lie and make we no deceive people? (Check paragraph 19)

19 For example, person fit tell im oga or people wey dey work with am sey e go quick close for work or sey e no go come the next day because e want go take ‘treatment.’ But e fit be sey no be for hospital e really want go take ‘treatment.’ E just want buy medicine for chemist store. The main thing wey make am no go work na because e want travel or e want carry im family go jolly. E fit be like sey “small truth” dey wetin the person talk because e talk sey e want go take ‘treatment.’ But you go talk sey the person talk true? No be deceive e deceive people? You fit still remember other example wey be like this one. E fit be sey person talk wetin no be true because e no want enter trouble or e want gain something make other people lose. Even if e no lie, what of wetin God talk when e sey: ‘No deceive person’? No forget wetin still dey for Romans 6:​19, wey talk sey: ‘Make una give all the part for una body as slave to do wetin good, wey go bring wetin dey holy.’

20, 21. If we want really thank God for im favor, which kind sin we go still comot hand from?

20 Wetin we dey talk be sey, if we want really thank God for im favor, we no go only comot hand from the sin wey 1 Corinthians 6:​9-11 talk about. For example, we no go only comot hand from all sex matter wey no clean for God eye but we go still try make we no watch any film wey dey show this kind thing. We no go drink till we dey drunk, but we go still try make we no drink sotey we come nearly dey drunk. To comot hand from all this sin be like fight. E fit no easy, but if we try we fit win the fight.

21 We go try make we no put hand for any kind sin, even if people think sey na small sin. Na true sey we no go fit comot hand finish but, make we try as Paul take try. E tell brothers and sisters for congregation sey: ‘Make una no let sin continue to rule as king for una body make una no come dey do the things wey una body want.’ (Rom. 6:12; 7:18-20) As we dey try fight any kind sin, we dey show sey we thank God for the favor wey e use Jesus Christ take show us.

22. Wetin people wey dey show sey dem thank God for im favor go gain?

22 Na the favor wey God show us make am forgive our sin and na im go still make am continue to forgive our sin. So make we do everything wey we fit do to comot hand from sin wey people think sey na small sin. Paul tell us wetin we go gain. E sey: ‘Now wey dem don comot una from sin and una don be God slave, una dey produce una fruit wey go bring holy things, and for the end e go bring life wey no go end.’​—Rom. 6:22.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share