Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • w17 January pp. 17-21
  • Know Where You Suppose Do Reach

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Know Where You Suppose Do Reach
  • Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Small Topic Dem
  • Similar Material
  • WHY E GOOD TO KNOW WHERE WE SUPPOSE DO REACH?
  • WETIN GO SHOW SEY WE KNOW WHERE WE SUPPOSE DO REACH?
  • HAPPY WITH WETIN YOU DEY DO FOR JEHOVAH
  • WETIN OVERSABI NO BE
  • You Fit Know Where to Do Reach Even When E Hard
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
w17 January pp. 17-21
Samuel correct King Saul

Know Where You Suppose Do Reach

‘People wey get better sense know where dem suppose do reach.’​—PROV. 11:2.

SONG: 38, 69

YOU GO FIT EXPLAIN?

  • Why e good to know where we suppose do reach?

  • How e be sey na almost the same thing for person to know where e suppose do reach and to carry body down?

  • How we fit take dey enjoy any work wey dem give us for Jehovah organization?

1, 2. Why God vex for Saul wey first be better person? (Check the first picture.)

WHEN King Saul start to rule for Israel, e no overdo and people respect am. (1 Sam. 9:1, 2, 21; 10:20-24) But e no tey after dem make am king, e come dey do things wey e no suppose do. When prophet Samuel no come Gilgal when e suppose come, Saul no fit wait again. Why? Because that time Philistia people want fight Israel people, and many Israel people don leave Saul. This one fit don make Saul think sey, ‘Make I do something quick quick.’ So e come do the sacrifice wey Samuel suppose do. But, Jehovah no like wetin e do.​—1 Sam. 13:5-9.

2 When Samuel reach Gilgal, e correct Saul for wetin e do. But instead wey Saul go take the correction, e start to blame other people. E come dey talk like sey wetin e do no too bad. (1 Sam. 13:10-14) From there, Saul come dey do other things wey Jehovah no like sotey im cup full. Jehovah come comot am as king. (1 Sam. 15:22, 23) Even though sey Saul start well, e no end well at all!​—1 Sam. 31:1-6.

3. (a) Why many people feel sey dem no need to know where dem suppose do reach? (b) Which question dem we go talk about?

3 Today, everybody want make am. Na im make many people think sey before person fit make am, e go ready to do anything even if e mean sey e go overdo. For example, one man wey dey act film and wey be politician talk sey: ‘Which one be, “Make person know where e suppose do reach?” That one no concern me at all, and I feel sey e no go ever concern me.’ But, why e good for Jehovah people to know where dem suppose do reach, or to know sey dem no suppose do oversabi? Wetin e mean for person to know where e suppose do reach, and wetin e no mean? Wetin go help us no do oversabi even when e no easy, or when other people dey push us to overdo? For this topic, we go answer the first two question. And for the next topic, we go answer the third one.

WHY E GOOD TO KNOW WHERE WE SUPPOSE DO REACH?

4. Wetin e mean for person to overdo something?

4 Bible tell us sey na good thing to know where person suppose do reach, but na bad thing to overdo. (Read Proverbs 11:2.) David beg Jehovah sey, make e ‘no let am overdo things.’ (Ps. 19:13) Wetin David mean? E dey talk about person wey do wetin e no suppose do, because e no dey patient or e dey carry body up. But, we dey do like that sometimes because of sin wey dey our body. Saul example show us sey, if e dey our character to dey do oversabi, one day one day we go do wetin God no like. Psalm 119:21 talk about Jehovah sey: ‘You no dey hide how you dey vex reach for people wey dey overdo things.’ Why e be like that?

5. Why e be sey to overdo things na serious matter?

5 To overdo things na serious matter. E worse pass to do something by mistake. Why? (1) When we overdo, we no dey show sey na Jehovah dey rule us. (2) If we do wetin we no suppose do, we fit get problem with other people. (Prov. 13:10) And (3) when people see sey we dey overdo things, shame go catch us. (Luke 14:8, 9) To dey overdo things no dey end well at all. But Bible tell us sey, na better thing for person to always know where e suppose do reach.

WETIN GO SHOW SEY WE KNOW WHERE WE SUPPOSE DO REACH?

6, 7. How person wey dey carry body down dey behave, and how e take be almost the same thing with person wey know where e suppose do reach?

6 For Bible, na almost the same thing for person to know where e suppose do reach and to carry body down. (Phil. 2:3, ftn.) Many times, if person dey carry imself down, e dey know where e suppose do reach, know wetin e fit do, gree sey e do mistake, ready to take advice and learn. People wey no dey carry shoulder up dey make Jehovah happy well well.

7 Bible show sey person wey no dey overdo, know wetin e suppose do and wetin e no suppose do. E know wetin e fit do and wetin e no fit do. This one go help the person know how to treat other people well. And e fit be sey na wetin the Greek language wey dem take write some part for Bible mean.

8. Wetin be some things wey fit help person know sey e don dey overdo?

8 How person fit know sey e don dey overdo? Make we see some things wey fit help us know. We fit dey feel sey we better pass other people or sey our work for Jehovah organization better pass their own. (Rom. 12:16) We fit start to dey do things to make people notice us and respect us. (1 Tim. 2:9, 10) We fit even start to tell other people wetin dem go do and wetin dem no go do because of who we be, the kind people wey we know or wetin we think. (1 Cor. 4:6) Many times, when person start to do this things, e fit no know sey e don dey overdo.

9. Wetin make some people start to overdo? Which example dey Bible?

9 Anybody fit start to overdo if e let the sin wey dey im body start to control am. Many people don overdo because dem get long throat, jealousy, and dem dey vex anyhow. Some people for Bible like, Absalom, Uzziah, and Nebuchadnezzar let the sin wey dey their body control dem. But Jehovah make dem know sey dem suppose carry theirself down instead of dem to overdo.​—2 Sam. 15:1-6; 18:9-17; 2 Chron. 26:16-21; Dan. 5:18-21.

10. Why e no good to judge other people? Which example dey Bible?

10 But e still get other things wey fit make person overdo. For example, think about the people wey Bible talk about for Genesis 20:2-7 and Matthew 26:31-35. Na because Abimelech and Peter let the sin wey dey their body control dem, na im make e be like sey dem overdo? Or na because dem no know everything wey dem suppose know, or dem no think well before dem do wetin dem do? As we no fit know wetin dey people mind, make we no dey judge dem. E go show sey we get sense and we love dem.​—Read James 4:12.

HAPPY WITH WETIN YOU DEY DO FOR JEHOVAH

11. If we know where we suppose do reach, how e go take make us know our work for Jehovah organization?

11 Person wey know where e suppose do reach go know the work wey God give am for im organization. Jehovah na God wey dey arrange things. So, e give everybody for im organization work. Even if all of us no dey do the same work, Jehovah like wetin we dey do. Dem born us with different different gift and na Jehovah use dem bless us, even though we no reach to get am. Make we use this gift praise am and help people. (Rom. 12:4-8) Jehovah don give us this work because e trust us. E believe sey we fit do am and use am praise im name.​—Read 1 Peter 4:10.

Jesus follow im Father make things, dem born am as human being, dey teach im disciples, sacrifice im life, and e dey rule as King for God Kingdom

How Jesus example fit help us when dem give us another work for congregation? (Check paragraph 12-14)

12, 13. Why we no go surprise if our work for Jehovah organization change?

12 Our work for Jehovah organization fit change anytime. Na wetin happen to Jesus be that. Only am first dey with Jehovah for heaven. (Prov. 8:22) After, e come follow Jehovah make other things for heaven and earth. (Col. 1:16) Later, dem born am as baby for this earth; e come grow to be man. (Phil. 2:7) After Jesus die for our sin, e go back to heaven as spirit. For there, e come be King of God Kingdom for 1914. (Heb. 2:9) And no be there e end, im work go still change. E go rule for one thousand years for God Kingdom. After, e go give the Kingdom back to Jehovah so that ‘God go come be everything to everybody.’​—1 Cor. 15:28.

13 Make we self know sey our work for Jehovah organization fit change. Many times, na because of the plan wey we get. For example, some wey never marry, fit marry. Some wey never born, fit born. Some wey no be regular pioneer, fit come be regular pioneer. True true, our plan dey change our life. Anytime wey things change for us, e fit make our work plenty or small. You dey young or you don old? Your body strong or e no too strong? Jehovah know wetin you fit do for am. E want make we do wetin we fit do, and anything wey we do dey make am happy.​—Heb. 6:10.

14. If we know where we suppose do reach, how e fit help us enjoy anything wey we dey do for Jehovah?

14 Jesus happy for all the work wey e do for Jehovah, and we self fit happy for our own. (Prov. 8:30, 31) Person wey know where e suppose do reach, dey happy with im work for congregation. E no dey worry about work wey dem never give am or work wey other people dey enjoy. Instead, e dey put mind for wetin e dey do. E dey use all im power do am because e know sey na Jehovah give am. E dey respect and support other people wey Jehovah give work for congregation. Na so things go be if we know where we suppose do reach.​—Rom. 12:10.

WETIN OVERSABI NO BE

15. Wetin we fit learn from wetin Gideon do?

15 Gideon na one correct person wey no do oversabi. Jehovah angel tell am to go save Israel people from Midian people hand. Gideon no waste time tell am sey na im small pass for im papa house and na im family small pass for Manasseh. (Judg. 6:15) But Gideon later do the work because e trust sey Jehovah go help am. And e do everything wey e fit do to really understand wetin Jehovah want make e do. (Judg. 6:36-40) Gideon get strong mind, but that one no make am do anyhow. E get better sense and e use am well. (Judg. 6:11, 27) E no use the work wey God give am do oga, so that people go know am. Instead, as e do the work finish, e go back to im house.​—Judg. 8:22, 23, 29.

16, 17. Wetin person wey no dey do oversabi go first put for mind before e gree do another work for congregation?

16 If person want do more work for Jehovah organization, that one no mean sey na oversabi. Bible advise us sey make we dey do well for God work. (1 Tim. 4:13-15) But na only when dem give us new work for Jehovah organization we go talk sey we dey do well? No be so. Jehovah fit help us dey do well for the work wey we dey do for am now. Make we continue to dey help other people and serve God with the gift wey e don take bless us.

17 Before person wey no dey do oversabi go gree do another work, e go first know wetin dem want make e do. E fit ask imself some question to know whether e go fit. For example, ‘If I do another work join my own, I fit still do other things wey I suppose do? Other people fit do my work, so that I fit get chance do another work?’ E good make we look the matter well and pray about am to know whether we fit do the new work. If we see sey we no fit, and another person dey wey fit do the new work, person wey no dey do oversabi go sey no.

18. (a) If we know where we suppose do reach, how e go take help us when we get new work? (b) Wetin Romans 12:3 talk about oversabi?

18 Anytime wey we get new work for congregation, make we remember Gideon example. Im example teach us sey na only if Jehovah help and bless us we go fit do the work well. Na wetin make Bible sey make we ‘know where we suppose do reach as we dey follow our God waka!’ (Mic. 6:8) So, anytime wey dem give us new work for congregation, make we pray about am and think well about wetin Jehovah dey use Bible and im organization teach us. Like papa wey dey teach im pikin how to waka, Jehovah dey teach us how to do the work wey e give us. So, make we follow as Jehovah dey direct us. Make we no forget sey no be our power we take dey do the work well. Na Jehovah dey help us do am well because e no dey carry shoulder up. (Ps. 18:35) If we know where we suppose do reach as we dey follow Jehovah waka, e go make us no think about ourself pass the way we suppose.​—Read Romans 12:3.

19. Why e good to know where we suppose do reach?

19 Person wey know where e suppose do reach go praise Jehovah because na im make us and na im high pass. (Rev. 4:11) E dey happy with any work wey dem give am for congregation, and e dey do am well. If we know where we suppose do reach, we no go do wetin go vex other people for congregation, and this one go make congregation get one mind. E go make us dey put people matter before our own, and we go dey sofri do things so that we no go do serious mistake. We don see sey as people wey dey serve God, we must know where we suppose do reach. Jehovah really value people wey no dey overdo things. But what if some things make am hard for us to know where we suppose do reach? The next topic go help us know wetin we go do.

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share