No Stop to Get Love
‘Because bad things dey full everywhere, many people no go get love again.’—MATT. 24:12.
1, 2.(a) Which people Matthew 24:12 first happen to? (b) Wetin the book of Acts talk wey make us know sey many Christian for apostle time no stop to show love? (Check the first picture.)
JESUS talk for Bible sey ‘many people no go get love again.’ Wetin e talk dey among the things wey show sey ‘the end don dey near.’ (Matt. 24:3, 12) Na Jew people for apostle time this thing first happen to. Dem talk sey dem be God people but dem come stop to love God.
2 Many Christian that time no do like the Jew people. Instead, dem continue to ‘preach the good news about Jesus.’ Dem continue to show sey dem love God, other Christians, and people wey no be Christian. (Acts 2:44-47; 5:42) But, some people wey dey follow Jesus that time stop to get love.
3. Wetin make some Christians for apostle time stop to get love?
3 When Jesus don go back to heaven, e talk something about Christians wey dey Ephesus for apostle time. E sey: ‘This na wetin I take hold una, sey una don forget the love wey una first get.’ (Rev. 2:4) Wetin be one thing wey make am talk like that? E fit be sey Christians for Ephesus dey do like people for the world wey dey think about wetin go favor only dem. (Eph. 2:2, 3) As e be for many place today, na bad things and bad character full Ephesus that time. Because money dey the place, wetin dey people mind pass na how to get big big things and live big man life. Many people for there dey put hand for sex matter wey no clean for God eye, and dem no dey respect God law. Wetin dey their mind pass na jolly jolly. Dem no love God and people.
4. (a) How people today don take stop to love God? (b) Wetin we go talk about for this topic?
4 This thing wey Jesus talk about love, still dey happen for our time. People no love God like before, and many people no dey look God side again. Na human being dem dey look to end their problem. No wonder many people for the world don dey stop to love God. But, like brothers and sisters for Ephesus that time, Jehovah servant fit stop to show love. We go use three small topic take talk about (1) how we fit continue to love Jehovah, (2) wetin we fit do to like Bible well well, (3) and why e good to love our brothers.
LOVE JEHOVAH
5. Why e good make we love God?
5 Before Jesus talk sey people go stop to get love, e talk about the love wey big pass. E sey: ‘“Make you use all your mind, all your body and all your sense love Jehovah wey be your God.” Na this command big pass and na im be the first.’ (Matt. 22:37, 38) The truth be sey, if we love God, we go fit do wetin e talk, we fit bear anything, and we go hate wetin bad. (Read Psalm 97:10.) But, Satan and im people want make we stop to love God.
6. Wetin dey happen because people no love God?
6 Instead make people for the world love God, dem ‘love only theirself.’ (2 Tim. 3:2) This world wey Satan dey control dey make people do ‘wetin their body and their eye want,’ and dem dey like to ‘show wetin dem get.’ (1 John 2:16) Apostle Paul warn Christians about wetin fit happen if dem dey do wetin their body want. E sey: ‘To dey put mind for the flesh dey bring death. Na so because, person wey dey put mind for the flesh go be God enemy.’ (Rom. 8:6, 7) True true, people wey dey pursue money or wey dey put mind for sex wey no clean for God eye, dey enter trouble.—1 Cor. 6:18; 1 Tim. 6:9, 10.
7. Wetin fit make Christians today stop to love God?
7 For some country, some people no believe sey God dey, and some believe sey even if e dey, wetin dey happen for this world no concern am. Other people still believe sey no be God make things. This people dey deceive other people to believe wetin dem believe. Dem dey make people believe sey na only mumu and person wey no go school, go believe sey God dey. On top that one, many people respect science people pass God. (Rom. 1:25) If we dey listen to this kind things, we fit start to leave Jehovah small small, and we fit stop to love am.—Heb. 3:12.
8. (a) Wetin be some problem wey many of us dey face? (b) Wetin Psalm 136 talk wey fit make our mind come down?
8 Our faith fit weak and we fit stop to love God because of condition. For this wicked world wey Satan dey control, sometimes we dey face problem wey fit make us no happy. (1 John 5:19) The problem fit be old age, sickness, or when things hard. Or we fit dey feel sey we no fit use our life do better thing, or better thing no fit come out from wetin we dey do for life. But no matter how things be, make we no think sey Jehovah don leave us. Make we dey think about things wey go make us still believe sey Jehovah love us. For example, wetin Psalm 136:23 talk go make your mind come down. E sey: ‘E remember us when we dey down, because e love no dey fail at all.’ True true, the love wey Jehovah get for im servant no dey end. So we dey sure sey ‘when we beg am to help us,’ e go help us.—Ps. 116:1; 136:24-26.
9. Wetin help Paul fit continue to get strong love for Jehovah?
9 When apostle Paul dey think about how Jehovah take dey help am, e come dey love Jehovah more more. Paul write sey: ‘Jehovah dey help me; I no go fear. Wetin person fit do me?’ (Heb. 13:6) Paul believe sey Jehovah love am and e go take care of am. Na im make am fit handle problem for life. E no let the problem make am stop to love Jehovah. Even when Paul dey prison, e write many letter wey help different different congregation. (Eph. 4:1; Phil. 1:7; Philem. 1) Upon all the problem wey Paul face, e still love Jehovah. Wetin help am? E continue to trust Jehovah, the ‘God wey dey make our mind come down anytime wey we dey wahala.’ (2 Cor. 1:3, 4) Like Paul, how we fit make our love for Jehovah strong?
Show Jehovah sey you love am (Check paragraph 10)
10. How we fit make our love for Jehovah strong?
10 Paul talk about one way wey we fit continue to get strong love for Jehovah. E sey: ‘Always dey pray.’ Another time, e come sey: ‘No tire to dey pray.’ (1 Thess. 5:17; Rom. 12:12) When we dey pray, we dey talk to God. Prayer dey make us near God more more. (Ps. 86:3) When we dey tell Jehovah our mind and how we dey feel, e go help us draw body near am. Bible talk sey Jehovah ‘dey hear prayer.’ (Ps. 65:2) Another thing be sey, when we see how Jehovah take dey answer our prayer, we go love am more more. We go come really know sey ‘Jehovah no far from anybody wey dey call am.’ (Ps. 145:18) When we believe sey Jehovah love us and dey care for us, we go fit handle any problem wey we dey face now, or wey dey come for front.
LIKE WETIN YOU DEY LEARN FROM BIBLE
11, 12. Wetin go help us continue to like wetin we dey learn for Bible?
11 All of us like truth, and truth dey Bible. When Jesus dey pray to im Father, e sey: ‘Your word na truth.’ (John 17:17) So, to like the truth wey dey Bible, we go first know wetin dey inside. (Col. 1:10) But, we still need to do pass that one. Psalm 119 tell us wetin we need to do to show sey we like wetin we dey learn from Bible. (Read Psalm 119:97-100.) Make we dey always think well about the things wey we don read for Bible. We fit even think about dem pass once everyday. When we dey think about how our life don take better because we dey do wetin Bible talk, we go like wetin we dey learn more more.
12 Another place for Psalm 119 talk sey: ‘The things wey you dey talk sweet for my tongue no be small! Dem sweet pass honey for my mouth!’ (Ps. 119:103) The book and magazine dem wey Jehovah organization dey give us be like food wey sweet. When we dey eat food wey we like, we dey settle down enjoy am. Na so e suppose be when we dey study Bible. Make we settle down enjoy wetin we dey learn. This one go make us enjoy the ‘sweet word’ wey dey Bible. E go help us remember wetin we read, and we fit use wetin we learn help other people.—Eccl. 12:10.
13. Wetin make Jeremiah like God word, and how the word touch am reach?
13 Prophet Jeremiah like God word. E talk how God word take touch am reach. ‘When your word reach my hand, I chop am. Your word make me happy well well, and my belle sweet me as I dey answer your name, O Jehovah the God wey get army.’ (Jer. 15:16) Like person wey chop food, Jeremiah dey think about God word and e let am enter im body well. This one come make am like the work wey God give am as im servant, to tell other people God word. If we like wetin we dey learn from Bible, e go make us know sey na better thing Jehovah do for us to let us answer im name, and tell people about im Kingdom for this last days.
Show sey you like wetin you dey learn from Bible (Check paragraph 14)
14. Wetin we fit do to like Bible more more?
14 Apart from sey we dey read Bible and our book dem, which other thing fit help us like the truth wey dey Bible more more? We need to dey go meeting everytime. We dey use different different topic wey dey Watchtower take learn Bible every week. Na Watchtower be one of the main things wey Jehovah dey use teach us today. E good make we dey prepare all the topic well before Watchtower Study so that we go understand the topic. One thing wey we fit do to prepare well na to check all the Bible verse. Nowadays, person fit download Watchtower from jw.org website, or e fit see am for JW Library app for many language. Since we get dem for computer, e no dey waste time to open the Bible verse dem wey dey any topic. No matter the pattern wey we want use study any topic, make we no rush read the Bible verse dem and make we dey think about wetin dem talk. This one go make us like wetin we dey learn for Bible more more.—Read Psalm 1:2.
LOVE BROTHERS AND SISTERS
15, 16. (a) Wetin John 13:34, 35 talk sey we suppose dey do? (b) Why e be sey person wey love Jehovah and Bible, suppose love im brothers and sisters?
15 The night before dem kill Jesus, e tell im disciples sey: ‘I dey give una new command, sey make una love unaself; just as I love una, make una love unaself like that. Na wetin people go take know sey una be my disciple, if una get love among unaself.’—John 13:34, 35.
16 We no fit love Jehovah if we no love our brothers and sisters. The truth be sey, we no fit do one leave one. Apostle John write sey: ‘Person wey no love im brother wey e dey see, no fit love God wey e never see.’ (1 John 4:20) Person wey like wetin e dey learn from Bible, go love Jehovah with im brothers and sisters for congregation. Why e be like that? Because Bible talk sey, make we love Jehovah with our brothers and sisters. So, if we really like wetin dey Bible, we go do wetin e talk.—1 Pet. 1:22; 1 John 4:21.
Show brothers and sisters sey you love dem (Check paragraph 17)
17. Wetin be some things wey we fit do to show sey we love our brothers and sisters?
17 Read 1 Thessalonians 4:9, 10. Wetin be some things wey we fit do to show sey we love our brothers and sisters for congregation? Some wey don old fit need who go dey carry dem go meeting and bring dem come back. Sister wey im husband don die fit need person wey go help am repair something for house. (Jas. 1:27) Whether dem young or old, brothers and sisters fit no get joy again because of problem wey dem dey face. Make we dey with dem, dey advise dem, and tell dem better things wey go make their mind come down. (Prov. 12:25; Col. 4:11) Na wetin we talk and do to help our brothers and sisters go show whether we really love dem.—Gal. 6:10.
18. Wetin go help us settle quarrel with brothers and sisters?
18 Bible talk sey for ‘last days,’ people go dey think of only theirself and longthroat go full everywhere. (2 Tim. 3:1, 2) As Jehovah people, e good make we continue to love God, like wetin we dey learn from Bible, and love each other. Sometimes, brother or sister fit do wetin we no like. But, make we no waste time use love settle any quarrel wey we get with our brothers. This one go make Jehovah bless us. (Eph. 4:32; Col. 3:14) So, make we no ever stop to get love! Instead, make we continue to like wetin we dey learn from Bible. And make the love wey we get for Jehovah and our brothers continue to burn like fire!