‘You Love Me Pass This Things?’
‘Simon, John pikin, you love me pass this things?’—JOHN 21:15.
1, 2. After Peter don try to catch fish for the whole night, wetin come happen?
FOR the whole night, seven of Jesus disciple don dey try catch fish for Sea of Galilee, but dem no fit catch anything. Jesus stand near the Sea dey look dem. So, e tell dem sey: ‘“Throw the net go the right side for the boat. Una go see some catch.” Dem come throw am, but dem no fit drag am enter the boat because the fish plenty well well.’—John 21:1-6.
2 After Jesus arrange morning food for dem, e face Simon Peter come ask am sey: ‘Simon, John pikin, you love me pass this things?’ Wetin Jesus dey talk about? Peter like im fish business well well. So, e fit be sey Jesus dey ask Peter about wetin e really like pass. Na the fish and the business e like pass, or na Jesus and the things wey Jesus teach? Peter answer Jesus sey: ‘Yes, Lord, you know sey I love you.’ (John 21:15) Peter really mean wetin e talk. From that time, the way e take put all im body for the preaching work, show sey e love Jesus. E come be better example for congregation for apostle time.
3. Which problem suppose make us put eye down?
3 Wetin we fit learn from wetin Jesus tell Peter? If person no put eye down well, e fit stop to love Jesus Christ and start to comot mind for God work small small. No let this kind thing happen to you. Jesus know sey things no go easy for us for Satan world. E know sey problem go dey. For the story about the farmer, Jesus talk sey some people go hear ‘the word about the Kingdom.’ Dem go first dey do well, but ‘the wahala wey dey this world and the way money fit deceive people,’ no go ‘let the word grow.’ (Matt. 13:19-22; Mark 4:19) True true, if we no put eye down, problem for this world fit make us start to comot mind for God work. Na im make Jesus warn im disciple dem sey: ‘But make una put eye for una body, so that too much food, too much drink, and wahala for life no go make una tire.’—Luke 21:34.
4. Wetin go help us know whether we really get love for Jesus Christ? (Go check the first picture.)
4 Like Peter, make we put the work wey Jesus don give us as the main thing for life, to show sey we really love Jesus. Wetin we suppose do to make sure sey we continue to put the work as number one thing for life? Make we dey always ask ourself sey: ‘Wetin I like pass for life? Na Jehovah work dey give me joy pass, or na other things?’ So that we fit answer this question, make we talk about three things wey fit make us no get strong love for Jesus again, and wey fit make us start to comot mind from things wey concern God. The three things na: work, enjoyment, and money.
NO LET YOUR WORK BE NUMBER ONE THING
5. Which work Jehovah give papa for family?
5 Peter no just dey enjoy to catch fish. But na wetin e take dey feed im family. Papa for family today know sey na dem Jehovah don give the work to take care of their family. (1 Tim. 5:8) Dem go need to work well well to fit take care of their family. But for this last days, the stress wey work get no be small.
6. Which kind stress dey many work today?
6 People wey dey find work plenty pass work wey dey. Sometimes, people feel sey dem need to do overtime, even if the money no reach anything. Some company dey produce plenty things pass before, even though sey people wey dey work for dem no many. This one dey cause stress and fit make workers sick. Many people feel sey if dem no do everything wey their oga talk, dem fit sack dem.
7, 8. (a) Who we suppose obey pass? (b) Wetin one brother for Thailand learn about im work?
7 As Jehovah people, na wetin Jehovah talk we go first do, before our oga own. (Luke 10:27) We dey work so that we fit get money to take care of ourself and support our preaching work. But if we no use sense, our work fit come be number one thing for life instead of Jehovah work. For example, one brother for Thailand talk sey: ‘My work na to repair computer. I like the work well well, but I dey use too much time do the work. Because of this one, I no come too dey get time for God work. I come see sey I need to change my work so that I fit put God own first, even though sey na from there I dey chop.’ Wetin this brother do?
8 E talk sey: ‘After about one year wey I don think about wetin to do and I don save money, I come dey sell ice cream for street. When I start, I no too see money and the work tire me. Anytime wey I see my former workmate, dem dey laugh me. Dem dey ask me why I think sey to sell ice cream better pass to do computer work for inside air-condition. I pray to Jehovah. I tell am sey make e help me so that I fit get more time do im work. E no tey, things come dey get head small small. I come know the kind ice cream wey my customers dey like and I come sabi do ice cream well. Small time, I come dey use one day sell all my ice cream finish. The truth be sey, I come even dey see money pass when I dey repair computer. I happy pass before, because I no get the kind stress and worry wey I get for my former work. The one wey sweet me pass be sey, I don near Jehovah well well.’—Read Matthew 5:3, 6.
9. Wetin fit help us know whether we don dey put our work as number one thing for life?
9 E no good make we lazy. Jehovah like make we dey work, and when we work we dey gain better thing. (Prov. 12:14) But, like wetin that brother for Thailand learn, make we no let our work be number one thing for life. Jesus talk sey: ‘Make una put God Kingdom, and dey do wetin God want first for una life, and God go give una all this things wey una need.’ (Matt. 6:33) But how we go take know whether we don dey put our work for front instead of Jehovah work? E good make we ask ourself: ‘Na my work dey sweet me pass Jehovah work? Which kind mind I take dey do Jehovah work? Na the kind mind wey dey think sey, “make I just do am, make e no be sey I no do am?”’ When we think about this question dem, e go help us know wetin we like pass for life.
10. Wetin Jesus teach about wetin we suppose put as number one thing?
10 Jesus teach us wetin suppose be the main thing for life. E get one time, wey Jesus go visit Mary and im sister wey im name na Martha for their house. As Martha dey busy dey prepare food, Mary go sitdown near Jesus to listen to wetin e want teach. When Martha complain sey Mary no dey help am prepare food, Jesus come tell Martha sey: ‘The thing wey Mary choose na im good pass, and nobody go fit collect am from am.’ (Luke 10:38-42) Na better thing Jesus teach Martha. Make we dey show sey we love Jesus, and make we no let anything comot our mind from God work. For that one to happen, we go continue to choose ‘the thing wey good pass.’ This one mean sey, we go put Jehovah work as the main thing for our life.
WHICH KIND EYE WE TAKE DEY LOOK ENJOYMENT?
11. Wetin Bible talk about time to rest and relax?
11 Because we get many things wey we dey do, we need to find time relax and rest well. Bible talk sey: ‘Nothing better pass for person to chop, drink, and enjoy the work wey e dey do.’ (Eccl. 2:24) Jesus know sey rest good sometimes. For example, e get one time wey im disciples preach well well. After dem preach finish, e come tell dem sey: ‘Make una come, make only us go one corner go rest small.’—Mark 6:31, 32.
12. Wetin we need to put for mind about enjoyment? Give example.
12 The truth be sey, enjoyment good for body. But, make we sofri so that enjoyment no go come be the main thing for our life. For apostle time, many people get the mind sey: ‘Make we chop and drink, because tomorrow we go die.’ (1 Cor. 15:32) Many people dey behave like that today. For example, e get one time wey one young man for Western Europe dey go our meeting. But, e come like enjoyment sotey e stop to come meeting. But after, e come see sey that kind life dey only give am problem and e no really make am happy. So e come start to study Bible again. As time dey go, e come be publisher. After e baptize, e talk sey: ‘I waste my time well well before I come know sey to serve Jehovah na im dey make person happy pass, no be to dey do things wey people for this world dey call enjoyment. Na the only thing wey I regret be that.’
13. (a) Which example show sey enjoyment fit give us problem? (b) Wetin fit help us know whether enjoyment don be number one thing for our life?
13 Anything wey we dey enjoy, suppose make us rest well and fit get power again. So, how many hours go good to take enjoy? Make we think am like this. Many people like to chop cake and sweet sometimes. But, if na only cake and sweet dem dey always chop, e fit make dem sick. So, we need to chop food wey really good for body. Na so e still be with enjoyment. If na only enjoyment we sabi, our love for Jehovah fit no strong again. So that this kind thing no go happen, make we dey always do things wey concern God work. Wetin fit help us know whether we don dey put enjoyment as number one thing for our life? For one week, we fit write how many hours we take do things wey concern Jehovah work. Things like, meeting, preaching, personal Bible study and family worship. Then, for that same week, make we still write how many hours we take enjoy ourself with other things like, sport, television, or video game. When you look the two of dem, which one many pass? If e be sey na time for enjoyment plenty pass, you no think sey you suppose do something about am?—Read Ephesians 5:15, 16.
14. Wetin fit help us choose better enjoyment?
14 Na we go choose the kind enjoyment wey we like, and papa fit still choose for family. But make we make sure sey Bible support wetin we choose.a Better enjoyment ‘na gift wey God give us.’ (Eccl. 3:12, 13) Na true sey no be the same thing all of us dey do to relax. (Gal. 6:4, 5) But, anyone wey we choose, make we make sure sey e no come be number one thing for our life. Jesus talk sey: ‘Where your property dey, na there your mind go still dey.’ (Matt. 6:21) So, make the love wey we get for Jesus, make us dey think, talk, and do things wey go show sey na God Kingdom be number one thing for us instead of other things for life.—Phil. 1:9, 10.
NO LET MONEY CHANCE GOD WORK
15, 16. (a) How money and property fit be trap for us? (b) Which better advice Jesus give about money and property?
15 Many people today want make sure sey dem buy wetin dey reign like, cloth, phone, or other things. So, e good make all of us dey ask ourself this kind question: ‘Wetin be number one thing for my life? I don like property sotey I come dey use plenty time dey find the motor or cloth wey dey reign? I don dey use plenty time dey think about this things pass the time wey I dey use prepare for meeting? Other things for life don take my time sotey I no come dey too get time to pray and read Bible?’ If we see sey money and property don dey chance the love wey we get for Jesus, make we remember wetin Jesus talk. E sey: ‘Make sure sey una no get long throat at all.’ (Luke 12:15) Wetin make Jesus talk like that?
16 Jesus talk sey ‘nobody fit serve two oga.’ E still sey: ‘Una no fit serve God and money.’ Na so because we no fit use all our mind serve only Jehovah and come still pursue money. Jesus talk sey we ‘go hate one and love the other one’ or we ‘go hold one tight and leave the other one.’ (Matt. 6:24) Our body fit want make we dey pursue money and gather property. Because dem born all of us with sin, make we no stop to do everything wey we fit do to make sure sey we no do the bad thing wey ‘our body want.’—Eph. 2:3.
17. (a) Why e hard for people wey dey think of only theirself to put God work as number one thing for life? (b) Wetin fit help us if we no want make money and property chance God work for our life?
17 Many people dey put their mind for only the things wey dem want and like. E dey hard this kind people to put God work as number one thing for their life. Why? Because things about God no dey make sense to dem. (Read 1 Corinthians 2:14.) E dey hard dem to know the correct thing to do because dem no dey think well. (Heb. 5:11-14) Na im make some people no dey fit control the longthroat wey dem get for money and property. Even when dem get, dem still want more. (Eccl. 5:10) We thank Jehovah sey e don give us Bible to help us cure this kind sickness. Make we dey always read am. (1 Pet. 2:2) Jesus no fall for Satan because e continue to think about wetin Jehovah teach am. So if we no want make money and property chance God work for our life, make we dey follow wetin Jehovah dey teach us. (Matt. 4:8-10) This one go make Jesus know sey we love am pass money or property.
Wetin be number one thing for your life? (Check paragraph 18)
18. Wetin you don ready to do?
18 When Jesus ask Peter sey, ‘You love me pass this things?’ e dey tell Peter sey make e put things wey concern God as number one thing for life. Peter name mean ‘Stone.’ And im character really show sey e be like stone wey nothing dey quick shake. (Acts 4:5-20) Today, we self ready to do anything to make sure sey nothing fit shake our love for Jesus. Make we no let our work, enjoyment, and money to be number one thing for life. We go come fit be like Peter wey talk sey: ‘Lord, you know sey I love you.’
a Check the topic “Is Your Recreation Beneficial?” wey dey October 15, 2011 Watchtower, pp. 9-12, pars. 6-15 (for English).