MEK WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Wetin We Go Do to Make How We Dey Preach Better—Dey Use Video Teach People
WHY E GOOD:
Video dey touch people mind because the picture dey catch their eye as dem dey hear am. As person dey watch video, e no go quick comot mind and e go dey easy to remember wetin e learn. Jehovah don show us the best example of how we fit use wetin we dey see take teach.—Ac 10:9-16; Re 1:1.
Dem don add this three video: Does God Have a Name?, Who Is the Author of the Bible?, and How Can We Be Sure the Bible Is True? join lesson 2 and 3 for inside Good News brochure. Why E Good Make We Learn Bible?, How We Dey Help People Learn Bible?, and Wetin Dey Happen for Our Kingdom Hall? na video wey dey move people to study Bible with us or to come our meeting for Kingdom Hall. We fit still use some of our long video take teach people wey we dey help learn Bible.—km 5/13 3.
HOW YOU GO DO AM:
Download the video wey you go like use
Prepare one or two question wey the video answer, wey you go like ask the person
Watch the video with the person
Make una talk about the main point
YOU FIT TRY THIS ONE:
Check the back of one of our tract, and show am the code wey go carry you go where Why E Good Make We Learn Bible video dey
Show the person this video: How Can We Be Sure the Bible Is True? Give am Good News brochure, and talk about lesson 3