MEK WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
God Kingdom—100 Years Don Pass and Time Still Dey Count
People wey want live for God kingdom go learn everything wey dem fit learn about the kingdom and wetin the kingdom don do. Why? E go make their faith strong well well sey God Kingdom dey rule and e go still move dem make dem fit tell other people the good news about God Kingdom. (Ps 45:1; 49:3) As you dey watch this video wey be The Kingdom—100 Years and Counting, find the answer for all this question:
Why e be sey “Photo-Drama of Creation” na blessing to people wey see am?
How dem take use radio tell people the good news
Which other different different way we don take preach the good news, and wetin be the result?
How the way wey dem take dey train us to sabi preach dey better as time dey pass?
How dem take dey train people wey go Gilead School before to help dem preach well?
When e reach to dey teach Jehovah people, which work convention don do?
Wetin make you believe sey God Kingdom dey rule?
How we go take show sey we dey support God Kingdom?