BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | PSALMS 45-51
Jehovah No Go Reject Person Wey Pain Full Im Heart
David write Psalm 51 after prophet Nathan tell am about the big sin wey e commit with Bath-sheba. David mind no come settle, and e bring imself come down to confess im sin.—2Sa 12:1-14.
David don sin but e fit still come back to Jehovah
51:3, 4, 8-12, 17
Before e repent and confess im sin, im mind worry am sotey e no happy at all
As e do wetin God no like, e pain am well well like person wey dem pieces im bone
E really want make Jehovah forgive am, e want come back to serve God well and e want happy as e dey happy before
E carry imself come down to beg Jehovah sey make e help am get mind to follow wetin e talk
E believe sey Jehovah go forgive am