Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 October p. 8
  • You Dey Use Our JW Card Well?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • You Dey Use Our JW Card Well?
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • Similar Material
  • Where We Fit Get Answer to Many Many Question Wey Dey Worry Us for Mind?
    Where We Fit Get Answer to Many Many Question Wey Dey Worry Us for Mind?
  • Wetin You Go See for Our Website?
    Which People Dey Do Wetin Jehovah Want Today?
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 October p. 8

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

You Dey Use Our JW Card Well?

One Jehovah Witness dey give person jw card

As great tribulation don dey near, e dey important well well make we dey preach. (Pr 24:11, 12, 20) We fit use our JW card take help people to see wetin dey inside Bible and our website. One code dey inside the card wey fit carry person go where this video dey: Why E Good Make We Learn Bible? and invitation still dey there wey the person go fit use if e want learn more or if e want make person come dey study Bible with am. Some people no dey like to collect our book, but dem go like check our website. No waste time, give dem our JW card. But no give person wey no listen at all at all.

As you dey do your normal work, you fit start to dey follow person talk, you fit tell am sey: “E get something wey I go like give you. This card go show you one website where you go fit learn many things for free, you go still see many video for there.” (Joh 4:7) As e be sey the JW card small, you fit dey carry some follow body everytime so that you go fit give people wey you meet.

GIVE PERSON JW CARD . . .

  • when you dey preach for anywhere wey you meet people

  • when you dey preach for place wey people dey work

  • when the person listen but e no want collect our book

One jw card dey show Bible wey dey open
The back of jw card
One jw card dey show one Jehovah Witness wey dey study Bible with one family
The back of jw card

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share