Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb16 December p. 7
  • Jehovah Knowledge Go Full the Earth

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Jehovah Knowledge Go Full the Earth
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
mwb16 December p. 7

BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | ISAIAH 11-16

Jehovah Knowledge Go Full the Earth

One small pikin dey follow animal wey fit kill person play for paradise

11:6-9

How this thing wey Bible don talk tey tey take concern Israel people

  • As Israel people dey waka come back from Babylon where dem first be slave, dem no need to fear any animal or bad people for road even when dem reach the land wey dem dey go.​—⁠Ezr 8:​21, 22

How this thing wey Bible don talk tey tey take concern us today

  • People don change their bad character because dem don learn about Jehovah. People wey like to dey fight before don be people wey dey make peace. People wey dey learn about Jehovah don dey enjoy peace

How this thing wey Bible don talk tey tey go take happen for front

  • Everywhere for this earth go turn to paradise and peace go dey, na wetin really dey God mind be that. No human being or animal go fit make us fear again

Paul change im bad way when e learn about Jehovah

  • When Paul still be Pharisee, im name na Saul. That time e get wicked character like animal own.—1Ti 1:13

  • Im character change when e learn about Jehovah.—Col 3:8-10

Apostle Paul change im bad character to better one
    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share