BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | ISAIAH 63-66
New Heaven and New Earth Go Make Everybody Happy
Wetin God promise for Isaiah chapter 65 na promise wey go happen, na im make Jehovah talk am like sey e don already dey happen.
Jehovah make new heaven and new earth, for there, we no go remember the things wey don happen before
65:17
Wetin be the new heaven?
Na new government wey go make wetin God want dey happen for this earth
God form the government, when e make Jesus the King of im Kingdom for 1914
Wetin be the new earth?
Na people from all the country and language for this earth wey allow the new government for heaven dey rule dem
When Bible talk sey we no go remember the things wey don happen before, wetin e mean?
We no go remember all the things wey dey make us cry, for example sickness, death and other wahala
People wey serve Jehovah go enjoy life well and all the things wey happen everyday go be wetin go sweet dem to remember