Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb17 April p. 2
  • Welcome People Well

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Welcome People Well
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
  • Similar Material
  • How You Go Take Enjoy Your New Congregation?
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2017
  • Dey Welcome People Well
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Wetin We Go Do to Make How We Dey Preach Better—Encourage People Wey Like Wetin We Dey Preach to Dey Come Meeting
    Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book (2016)
  • ‘Dey Treat Stranger Well’
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
mwb17 April p. 2

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

Welcome People Well

Who be the people wey we go welcome well? Anybody wey come our Kingdom Hall, both people wey start to dey come our Kingdom Hall newly and people wey be don stop to dey come Kingdom Hall. (Ro 15:7; Heb 13:2) E fit even be our brother or sister wey come from another country or person wey be inactive. Just think am sey na you be that person, you no go like am if dem treat you well? (Mt 7:12) So before meeting start and after e end, e go good make we dey waka round greet people. This one dey add join the peace and love wey all of us get as Jehovah people and e dey make Jehovah happy. (Mt 5:16) Even if we no fit greet everybody for Kingdom Hall, e good make we try do everything wey we fit do to dey greet people because e go make dem happy and know sey we really like dem.a

No be only for Memorial we dey welcome people, we need to dey do am everytime. And when new people wey come our Kingdom Hall see the kind love wey we get, e fit make dem come join us dey worship Jehovah.​—Joh 13:35.

a But when person wey dem disfellowship come Kingdom Hall, we no go greet am because of wetin Bible talk.​—1Co 5:11; 2Jo 10.

One brother dey greet new people wey come Kingdom Hall

WETIN WE GO DO WHEN NEW PERSON COME OUR KINGDOM HALL

  • Greet the person, tell am your name and ask am im name

  • You fit tell am sey make e come sitdown near you

  • Share your Bible and songbook with am

  • When meeting finish, you fit ask am whether e get any question

  • Tell am sey you go like to dey teach am Bible

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share