BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | JEREMIAH 51-52
Everything Wey Jehovah Talk Dey Happen
Jehovah talk exactly wetin go happen for front
Person wey sabi shoot arrow dey guard Persia people palace
‘Sharp the arrow’
51:11, 28
Media and Persia people sabi shoot arrow well well, na arrow be the main thing wey dem take dey fight war. Dem dey settle down sharp their arrow so that when dem use am shoot person, e go enter inside im body well well
‘Babylon soldier don stop to fight’
51:30
One stone wey dem write something put (the Nabonidus Chronicle) talk sey: “Cyrus and im army no fight war before dem fit enter Babylon.” This one agree with wetin Jehovah use Jeremiah talk. Cyrus army and Babylon army no fight war
Nabonidus Chronicle
‘Babylon go turn to where stone full and nobody go ever stay there again’
51:37, 62
Na 539 B.C.E. Babylon start to dey loose im respect. Alexander the Great be get am for mind to make Babylon im main city, but e come die before e fit do am. For the apostles time, some Jew people still dey stay for Babylon, na im make apostle Peter travel go there. But around 400 C.E., Babylon don scatter reach ground, till today nobody dey stay there