June 12-18
LAMENTATIONS 1-5
Song 128 and Prayer
Wetin Meeting Chairman Go Talk to Start the Meeting (No pass 3 min.)
BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE
“If We Dey Use Better Mind Wait, We Go Fit Endure”: (10 min.)
[Play the video Wetin Dey the Book of Lamentations.]
La 3:20, 21, 24—Jeremiah use better mind wait and e trust Jehovah (w12 6/1 14 ¶3-4; w11 9/15 8 ¶8)
La 3:26, 27—If we fit bear any wahala as we dey serve Jehovah now, we go go fit ready well to bear the one wey dey come for front (w07 6/1 11 ¶4-5)
Better Things Wey Dey Inside Bible—Find Am Well: (8 min.)
La 2:17—Wetin Jehovah talk sey e go do to Jerusalem wey e later do to am? (w07 6/1 9 ¶4)
La 5:7—Na true sey Jehovah dey punish people because of the bad things wey their papa papa do? (w07 6/1 11 ¶1)
Wetin you learn about Jehovah from the place wey we read for Bible this week?
Which other better thing you don see from the place wey we read for Bible this week?
Bible Reading: (No pass 4 min.) La 2:20–3:12
MAKE YOU DEY PREACH WELL
First Time: (No pass 2 min.) g17.3 cover—Tell am wetin una go talk about when you come back.
Return Visit: (No pass 4 min.) g17.3 cover—Invite the person come meeting.
Talk: (No pass 6 min.) w11 9/15 9-10 ¶11-13—Topic: Na Jehovah Be My Share.
MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN
Congregation Matter: (8 min.) Another thing wey una fit do be sey una fit talk about the topic for inside Yearbook wey be “A Letter From the Governing Body.” (yb17 2-5)
Wetin Our Organization Dey Do: (7 min.) Play Wetin Our Organization Dey Do video, June 2017 own.
Congregation Bible Study: (30 min.) kr chap. 13 ¶33-34, and the box “Noteworthy High Court Victories That Advanced Kingdom Preaching,” Question wey go help us remember wetin we learn “How Real Is the Kingdom to You?”
Wetin We Learn and Wetin We Go Learn Next Week? (3 min.)
Song 100 and Prayer