Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • mwb17 July p. 8
  • How to Behave Well for Preaching

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • How to Behave Well for Preaching
  • Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
Life Wey We Dey Live as Christian and How We Dey Preach—Meeting Book—2017
mwb17 July p. 8

MAKE WE DEY LIVE LIKE CHRISTIAN

How to Behave Well for Preaching

Brothers wey stand near door when dem dey preach, for preaching one brother dey look inside person house, one brother dey chop biscuit for near door and another one dey press phone

As Jehovah servant, people dey put eye for our body well well. (1Co 4:9) So when we go preach, make e no surprise us if some of dem dey watch us from their window, or put ear for wetin we dey talk even when dem no come out. Some house get camera. Some still get wetin the owner of the house fit take hear wetin we dey talk or even record am. So how we go take dey behave well for preaching?​—2Co 6:3.

WITH WETIN YOU DEY DO (Php 1:27):

  • No look inside the house to check if person dey when nobody come out. No chop or drink anything when you don near the door. No make call or dey press phone when you want preach to person

WITH WETIN YOU DEY TALK (Eph 4:29):

  • When you don near the door, no talk anything wey you no want make people wey dey the house hear. Some brothers and sisters don see sey e better to leave wetin dem dey talk about, so that dem fit put mind for wetin dem want preach

Two brothers for preaching stand for front of the door and the person wey dey the house dey look dem from the hole wey dey the door

Which other way you fit show sey you dey behave well for preaching?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share