BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | HOSEA 1-7
Like Jehovah, E Dey Sweet You to Show Love Wey No Dey Fail?
Na only when you really get person for mind and hold am tight, your love for am no go fail. Jehovah use wetin happen to Hosea and im wife wey dey follow other men, teach lesson about love wey no dey fail and to dey forgive.—Ho 1:2; 2:7; 3:1-5.
How Gomer take show sey e no get love wey no dey fail?
How Israel people take show sey dem no get love wey no dey fail?
How Hosea take show love wey no dey fail?
How Jehovah take show love wey no dey fail?
THINK ABOUT AM: How I go take show Jehovah sey my love for am no dey fail?