BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | MARK 3-4
Jesus Heal People on Sabbath Day
3:1-5
Why the character of the scribes and Pharisees pain Jesus well well? Na because dem add many other law join the Sabbath law. This one come make the Sabbath day be like heavy load for the people. For example, dem sey na bad thing to kill something like mosquito for Sabbath day. Dem still talk sey na only if sickness serious reach to kill person dem fit heal am on Sabbath day. This one mean sey people no go dey set bone wey break or treat dislocation that on Sabbath day. So, e clear sey dem no pity for the man wey im hand paralyze.