Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 21 p. 56-p. 57 par. 6
  • Wetin Happen for the Synagogue Wey Dey Nazareth

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Wetin Happen for the Synagogue Wey Dey Nazareth
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • E Do Many Miracle, But Im Town People Reject Am
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Jesus Do Many Miracle for Capernaum
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 21 p. 56-p. 57 par. 6
Jesus stand inside the synagogue dey read Isaiah scroll

CHAPTER 21

Wetin Happen for the Synagogue Wey Dey Nazareth

LUKE 4:16-31

  • JESUS READ FROM PROPHET ISAIAH SCROLL

  • NAZARETH PEOPLE TRY KILL JESUS

Body just dey sweet everybody for Nazareth. Before Jesus go meet John make e baptize am, everybody know Jesus as carpenter, but now, the people know am as person wey dey do miracle. The people just dey wait to see Jesus do miracle make dem see.

Jesus enter the synagogue as e dey do before. Everybody want see wetin e go do. For synagogue that time on Sabbath day, dem go pray and read the books wey Moses write. (Acts 15:21) Dem still dey read some of the book wey the prophets write. As Jesus stand up to read, e fit dey remember some of the people wey e know all the years wey e dey come the synagogue. Dem give am prophet Isaiah scroll make e read. He come open am go where dem talk about the person wey Jehovah anoint. Now, the place na Isaiah 61:1, 2.

Jesus come dey read about how the person wey God anoint, go take preach freedom to people wey dey bondage, how people wey blind go see and about Jehovah year of favor wey dey come. When Jesus read am finish, e give the scroll to one person wey dey work for there. As e sit down, everybody come dey look am. And e start to tell them many things. One of the things wey e tell dem na, “today, this things wey una hear don happen.”—Luke 4:21.

The people surprise because of “the better better word wey dey come out from im mouth.” Dem come dey talk to each other sey: “This na Joseph pikin, abi no be im?” As Jesus know sey dem dey wait for am to do miracle like the one wey dem hear sey e do before, Jesus come talk sey: “Una go surely tell me sey, ‘Doctor, cure yourself; make you do for your hometown the things wey we dey hear sey you dey do for Capernaum.’” (Luke 4:22, 23) Im former neighbors fit dey feel sey Jesus go start to do miracle for im hometown so that im people go be the first to gain from am. So dem come dey feel sey Jesus no respect dem.

As Jesus know wetin dey their mind, e tell dem some things wey don happen to Israel people. For Elijah time, many women wey their husband don die dey Israel, but God no send Elijah go meet any of dem. Na the one wey no be Israel person, wey dey Zarephath—one town wey near Sidon—Elijah do miracle for. (1 Kings 17:8-16) For Elisha time, many leper still dey Israel but na only Naaman wey be Syria person Elisha cure.—2 Kings 5:1, 8-14.

People for the synagogue carry Jesus go the part of the mountain wey high pass

Wetin the people do when dem see sey Jesus story no favor dem, but e dey show sey dem dey selfish and dem no get faith? The people wey dey the synagogue come vex, dem carry Jesus outside the town, for the corner of the mountain wey Nazareth dey ontop—the part wey high pass—so that dem go push am down. But Jesus escape from their hand and nothing do am. After, Jesus travel go Capernaum wey dey the northwest side of the Sea of Galilee.

  • Why body dey sweet everybody for Nazareth?

  • Wetin the people do when dem hear wetin Jesus talk, but why dem vex?

  • Wetin Nazareth people try do to Jesus?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share