Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • jy chap. 46 p. 116-p. 117 par. 9
  • E Well Because E Touch Jesus Cloth

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • E Well Because E Touch Jesus Cloth
  • Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Similar Material
  • Jesus Do Many Miracle
    Lesson Wey You Fit Learn From Bible
  • One Small Girl Come Back to Life!
    Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
  • Word Wey Get Better Meaning!
    Watchtower Wey Dey Talk About Jehovah Kingdom (The One Wey We Dey Study)—2016
Jesus—Na the Road, the Truth, and the Life
jy chap. 46 p. 116-p. 117 par. 9

CHAPTER 46

E Well Because E Touch Jesus Cloth

MATTHEW 9:18-22 MARK 5:21-34 LUKE 8:40-48

  • ONE WOMAN SICKNESS CURE WHEN E TOUCH JESUS CLOTH

The people wey dey stay for the northwest side of the Sea of Galilee hear sey Jesus don come back from the Decapolis. Many of dem fit don hear how Jesus take stop the strong breeze and the wave for sea. And some fit don hear the story about the man wey Jesus drive demons from im body. Because of this one, plenty people come gather near the sea to welcome Jesus. E be like sey na for Capernaum area this people gather. (Mark 5:21) As Jesus dey come down from the boat, the people come dey hungry to see the things wey e go do.

E get one man wey still dey wait to see Jesus. Na big man e be for synagogue, im name na Jairus. E kneel down for Jesus front and e come beg am plenty times sey: “My daughter dey sick well well. Abeg come put your hand ontop am make e well again, make e no die.” (Mark 5:23) Jairus really love this im daughter wey dey 12 years. And na im be the only pikin wey e get. Jesus go listen to this man and help the pikin?—Luke 8:42.

As Jesus dey go Jairus house, e come see another thing wey touch am. Many of the people wey dey follow Jesus dey hungry to see if Jesus go do any miracle for their front. But one woman among dem dey think about the bad sickness wey e get.

This woman na Jew person, and for 12 good years, blood dey flow from im body. E don meet many doctors, and e don spend all im money for different medicine. But instead of am to dey well, the sickness “come bad pass before.”—Mark 5:26.

This kind thing no go only make the woman body weak. Shame go still dey catch am because of im condition. This kind thing no be wetin person go like to talk about for where many people dey. And for the Law wey Jehovah give Moses, when blood dey flow from woman body, the woman no go dey clean for some time. And if anybody touch the woman or the cloth wey the blood stain, that person must wash im body, and e no go dey clean till evening.—Leviticus 15:25-27.

This woman don hear many things about Jesus, and e want meet am. But the woman no want make people notice am because of im sickness. So e come dey pass inside the crowd small small so that dem no go notice am, and e tell imself sey if e just touch Jesus outer garment, e go well. As e touch the corner of Jesus cloth, the woman come notice sey the flow of blood don stop! This bad sickness don go—Mark 5:27-29.

Jesus come sey; “Who touch me?” How you think sey the woman feel when e hear wetin Jesus talk? Peter come tell Jesus sey: “People surround you and gather you.” But why Jesus dey find who touch am? Jesus talk sey: “Somebody touch me, because I know sey power comot from my body.” (Luke 8:45, 46) True true, as the woman heal, e draw Jesus power.

As the woman know sey Jesus notice wetin happen, e come kneel down for Jesus front, dey shake because of fear. E start to talk the truth about im sickness for everybody front, and sey the sickness don go. Jesus tell the woman wetin go make im mind come down. E tell am sey: ‘My daughter, your faith don make you well. Go, no worry and make your bad sickness no disturb you again.’—Mark 5:34.

E clear sey Jesus wey God choose to rule this earth na person wey get love and soft mind for people. Jesus no only dey care about people, but e still get power to help dem!

  • Why people gather to welcome Jesus as e dey come back to Capernaum area?

  • Which kind problem one woman get, and why e want make Jesus help am?

  • How the woman take heal, and wetin Jesus tell am wey make im mind come down?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share