CHAPTER 47
One Small Girl Come Back to Life!
MATTHEW 9:18, 23-26 MARK 5:22-24, 35-43 LUKE 8:40-42, 49-56
JESUS RESURRECT JAIRUS PIKIN
Jairus see as Jesus heal the woman wey blood dey flow from im body. And e know sey Jesus go still fit help im pikin. But e dey feel sey e don too late because the pikin don die. (Matthew 9:18) Any hope fit still dey for this small girl?
As Jesus dey talk to the woman wey e heal, some men come from Jairus house and dem tell Jairus sey: “Your daughter don die, why you still dey disturb the Teacher?”—Mark 5:35.
This bad news really break Jairus heart! This man wey get high position and wey people dey respect no go fit do anything. The only pikin wey e get don die. Jesus hear wetin dem tell Jairus. E look Jairus, come tell am something wey go help am get mind. E sey: “No fear, just get faith.”—Mark 5:36.
Jesus follow Jairus go house. When dem reach there, dem hear noise and dem see plenty people wey gather. The people dey shout, dey cry and dem dey use hand nack their body because e pain dem sey the pikin die. Jesus enter the house and e talk something wey surprise the people. E sey: “This pikin never die, but e dey sleep.” (Mark 5:39) When the people hear wetin Jesus talk, dem come dey laugh am because dem know sey the girl really die. But God don give Jesus power to resurrect people wey don die. So Jesus fit show this people sey person wey die, fit come back to life, just as dem fit wake person from deep sleep.
Jesus tell the people wey dey the house make dem go outside. The only people wey remain na Peter, James, John, and the girl papa and mama. Na this five people follow Jesus go where dem put the girl. Jesus hold the girl hand and talk sey: “‘Talʹi·tha cuʹmi,’ if dem translate am, e mean: ‘Small girl, I sey make you “get up!”’” (Mark 5:41) At once, the girl stand up and start to waka. Jairus and im wife really happy for this one! To still show people sey the girl really come back to life, Jesus tell dem sey make dem give the girl food.
Jesus dey always tell people wey e heal sey make dem no tell other people. And na the same thing e still tell the girl papa and mama. But the girl papa and mama and other people happy sotey dem spread the news reach everywhere. (Matthew 9:26) If na your person dem resurrect, you no go tell people about am? This na the second time for Bible wey Jesus resurrect person.