Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • fg lesson 8 ques. 1-5
  • Why God Let Bad Things and Suffer Suffer Dey Happen?

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Why God Let Bad Things and Suffer Suffer Dey Happen?
  • Good News Wey Come From God!
  • Similar Material
  • Why People Dey Suffer?
    Wetin Bible Dey Teach Us?
  • Wetin God Get For Mind for Us?
    Wetin Bible Dey Teach Us?
Good News Wey Come From God!
fg lesson 8 ques. 1-5

LESSON 8

Why God Let Bad Things and Suffer Suffer Dey Happen?

1. How bad thing take start?

1. Adam dey look the fruit wey Jehovah sey make dem no eat; 2. Different different people for government; 3. Scenes of war

The chance wey God don give man don show sey dem no go fit rule theirself, and dem no go fit comot all the problem wey dem get

Na when Satan lie give Eve na im bad thing start. Satan na better angel before, but e no continue to dey God side. (John 8:44) E no want make people dey serve God. Satan want make people dey serve am. Satan lie give Eve, and e come decieve am make e no do wetin God talk. Adam come follow Eve do wetin Satan tell am make e do. Na wetin Adam do dey make us suffer and die today.—Read Genesis 3:​1-6, 19.

When Satan tell Eve sey make e no hear wetin God talk, e show sey Satan want use sense collect the Kingdom for God hand. Many people don join Satan talk sey dem no want make God dey rule dem. Na so Satan come take dey ‘control this world.’—Read John 14:30; 1 John 5:19.

2. Mistake dey for wetin God make?

Everything wey God make no get mistake. If the angel and the people wey God make want do wetin e tell dem, dem for fit do am well. (Deuteronomy 32:​4, 5) God make us make we fit choose whether na good we go do or na bad. This chance wey God give us na to show whether we love God or we no love am.—Read James 1:​13-15; 1 John 5:3.

3. Why God never comot suffer suffer since that time?

Na only small time Jehovah go take let Satan control this world. Why? Na to show sey people no go gain anything for wetin dem dey do if God no support dem. (Ecclesiastes 7:29; 8:⁠9) E don pass 6,000 years wey government for this world don dey try to comot our problem, but dem never fit.—Read Jeremiah 10:23; Romans 9:17.

God government no be like man own. Anybody wey support God government go enjoy. (Isaiah 48:​17, 18) Jehovah go soon comot all the government wey dey for this world. Only people wey let God rule dem go remain for this world.​—Isaiah 11:9.—Read Daniel 2:⁠44.

4. All this time wey God dey wait, wetin e give us chance to do?

Satan talk sey nobody go fit serve Jehovah for nothing. Na true? This time wey God don wait na to show whether we want make God dey rule or make man dey rule. Na the way we live our life go show am.—Read Job 1:​8-12; Proverbs 27:11.

5. How we go take show sey we want make God dey rule us?

People studying the Bible

The way we dey do things go show whether we want make God be our king

We fit show sey na God dey rule us, if we follow wetin Bible talk. (John 4:23) Like Jesus, if we no dey fight war and dey put our hand for politics matter, we dey show sey we no want make Satan dey rule us.—Read John 17:14.

Satan dey use im power dey make the bad bad things wey people dey do be like sey e good. Some of our friend and family member no go happy to see sey we don stop all those things. (1 Peter 4:​3, 4) So make we choose. If we follow people wey love God and follow the law wey God give us for Bible, e go show sey na lie Satan talk when e talk sey nobody go fit serve God when dem dey inside trouble.—Read 1 Corinthians 6:​9, 10; 15:33.

The love wey God get for us don make us dey sure sey nothing go fit stop God make e no comot all this bad bad things and the suffer wey we dey suffer. All the people wey show sey dem believe am go enjoy that paradise.—Read John 3:16.

If you want learn more about this topic, read chapter 11 for this book What Can the Bible Teach Us?

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share