SONG 5
God Work Good Finish
(Psalm 139)
1. My God Jehovah na you know me.
Na you dey see ev’rything I dey do.
As I dey sleep, as I dey wake for morning,
You dey see ev’rything wey dey
inside my mind.
Even before my mama born me,
Jehovah you don know me since that time.
You see as I dey grow for belle small small,
I go dey praise your name Jehovah,
ev’ry time.
The things you make dey move me make I dey sing.
You be my God, your power no dey fail.
No matter who or wetin I fit dey face,
Since you dey help me, I no go dey fear.
I ready to serve you Jehovah.
I no fit run go anywhere go hide.
For deep water, even if na inside grave,
Your eye go see me anywhere,
I no fit hide.
(Still check Ps. 66:3; 94:19; Jer. 17:10.)