BETTER THINGS WEY DEY INSIDE BIBLE | PSALMS 135-141
The Way God Make Us Good Finish
As David dey look the things wey God make, e dey think about the better better character wey God get. E get strong mind and e use im life serve Jehovah.
When David think about the things wey Jehovah make, this one move am to praise Jehovah more more:
139:14
‘I praise you because the way wey you make me good finish, e dey surprise me sotey I fear’
139:15
when I dey grow for secret, when dem weave me for the place wey dey down down inside the earth’
139:16
‘Your eye even see me when I just dey form inside belle; dem write all the part inside your book’