Watchtower ONLINE LIBRARY
Watchtower
ONLINE LIBRARY
Nigerian Pidgin
  • BIBLE
  • PUBLICATION DEM
  • MEETINGS
  • sjj song 7
  • Na Jehovah Dey Give Us Power

No video available for this selection.

Sorry, there was an error loading the video.

  • Na Jehovah Dey Give Us Power
  • “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Similar Material
  • Abeg Jehovah, Hear My Prayer
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Turn to Jehovah, E Go Save You
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
  • Make We Dey Do Wetin Go Praise God Name
    “Use All Your Heart Sing” to Jehovah
“Use All Your Heart Sing” to Jehovah
sjj song 7

SONG 7

Na Jehovah Dey Give Us Power

(Isaiah 12:2)

  1. 1. Great God Jehovah, na you wey high pass.

    We bow for you because na you big pass.

    We be your people and you be our God.

    We go dey preach to tell people your Word.

    (CHORUS)

    Jehovah our God, dey give us power.

    For Bible e talk sey e no far.

    When we face problem, na im we go trust.

    Jehovah God na you fit come save us.

  2. 2. We dey happy as you dey teach us well.

    Truth for your Word dey make everything clear.

    We don ready to do wetin you talk.

    Yes, we go serve you Jehovah our Rock.

    (CHORUS)

    Jehovah our God, dey give us power.

    For Bible e talk sey e no far.

    When we face problem, na im we go trust.

    Jehovah God na you fit come save us.

  3. 3. Satan dey vex, e dey try make us fear.

    Satan go lose because my God dey there.

    I no go fear because God dey my side.

    Till I go die, na im side I go hide.

    (CHORUS)

    Jehovah our God, dey give us power.

    For Bible e talk sey e no far.

    When we face problem, na im we go trust.

    Jehovah God na you fit come save us.

(Still check 2 Sam. 22:3; Ps. 18:2; Isa. 43:12.)

    Publication for Nigerian Pidgin (2014-2018)
    Log Out
    Log In
    • Nigerian Pidgin
    • Share
    • Set Am How You Like
    • Copyright © 2025 Watch Tower Bible and Tract Society of Pennsylvania
    • How to Use Am
    • Privacy Policy
    • Privacy Settings
    • JW.ORG
    • Log In
    Share