SONG 29
Make We Dey Do Wetin Go Praise God Name
(Isaiah 43:10-12)
1. O God Jehovah, the God wey get power,
You no dey fail, and na truth you dey like.
Nobody get sense like you, O Jehovah.
We dey happy sey you give us your name.
Na you Jehovah our God, we go worship,
And we go preach sey your Kingdom dey come.
(CHORUS)
Thank you Jehovah sey we be your Witness,
We go dey do wetin go praise your name.
2. When we dey serve you as brothers and sisters,
Our love dey grow for ourself and for you.
When people change as we teach dem about you,
We dey happy when dem give you their life.
Our God you do well for this work you give us
To teach the truth and tell people your name.
(CHORUS)
Thank you Jehovah sey we be your Witness,
We go dey do wetin go praise your name.
(Still check Deut. 32:4; Ps. 43:3; Dan. 2:20, 21.)