SONG 18
Jesus Sacrifice Na Special Gift
(Luke 22:20)
1. Jehovah God, we want
come tell you sey thank you,
Because nobody fit show
this kind love wey you show.
How e for be if Jesus
no come die for us?
This sacrifice don show us sey
you really love us.
(CHORUS)
If no be you, where we for dey?
You give us hope and you save us.
We no go stop
to dey use all our mind, to sey thank you.
2. Jesus no sin, e no do bad,
why e come die?
Na because im love for us
no dey fail, na strong love.
We no get any hope until
e come save us.
Now we get hope sey life go sweet,
Paradise dey come.
(CHORUS)
If no be you, where we for dey?
You give us hope and you save us.
We no go stop
to dey use all our mind, to sey thank you.
(Still check Heb. 9:13, 14; 1 Pet. 1:18, 19.)