SONG 38
Jehovah Dey Your Back
(1 Peter 5:10)
1. Jehovah see your heart, the good heart wey you get.
You really like to do wetin e want.
E see when you dey pray, with all your heart and mind,
E help you know how life go be for front.
The things you learn come move you to talk sey,
“Jehovah God na you I go obey.”
(CHORUS)
Na God go give you power,
Jesus don die for you.
Jehovah dey your back,
You no go ever lack.
Even when problem shake you,
you go fit still bear am.
Jehovah dey your back,
You no fit ever lack.
2. No matter as e be, Jehovah no go fail.
E go give you the power wey you need,
Na im send Jesus Christ sey make e die for you.
E love you and e know wetin you need.
Just do your best, no tire to dey wait.
E talk sey e go bless you for your faith.
(CHORUS)
Na God go give you power,
Jesus don die for you.
Jehovah dey your back,
You no go ever lack.
Even when problem shake you,
you go fit still bear am.
Jehovah dey your back,
You no fit ever lack.
(Still check Rom. 8:32; 14:8, 9; Heb. 6:10; 1 Pet. 2:9.)