SONG 21
Dey Put God Kingdom First
(Matthew 6:33)
1. God no want make people suffer.
E don promise better life.
E go soon bring im Kingdom come.
Na Jesus e choose as King.
(CHORUS)
Make we do wetin God tell us,
And put am as number one.
Make we fit enter im Kingdom,
No slow down at all at all.
2. You dey worry for tomorrow?
You dey find wetin to chop?
Jesus sey: ‘Put God Kingdom first,
Other things go come from God.’
(CHORUS)
Make we do wetin God tell us,
And put am as number one.
Make we fit enter im Kingdom,
No slow down at all at all.
3. Make we tell people this good news,
Sey this life go sweet for front.
And if dem dey trust Jehovah,
Better life go sure for dem.
(CHORUS)
Make we do wetin God tell us,
And put am as number one.
Make we fit enter im Kingdom,
No slow down at all at all.
(Still check Ps. 27:14; Matt. 6:34; 10:11, 13; 1 Pet. 1:21.)