SONG 27
We Go Know the Sons of God
(Romans 8:19)
1. Jehovah God choose some people,
With im holy spirit.
Dem go dey heaven with Jesus
To rule as king and priest.
(CHORUS)
The sons of God go rule this earth
With Jesus Christ their Lord.
And we go know this sons of God,
Na small time wey remain.
2. The ones wey still dey for this earth,
Jesus go soon call dem.
The King wey big pass other King
Go gather all of dem.
(CHORUS)
The sons of God go rule this earth
With Jesus Christ their Lord.
And we go know this sons of God,
Na small time wey remain.
(BRIDGE)
Na all of dem go join Jesus
Fight for Armageddon.
As Bible talk, na dem go stay
With Jesus for heaven.
(CHORUS)
The sons of God go rule this earth
With Jesus Christ their Lord.
And we go know this sons of God,
Na small time wey remain.
(Still check Dan. 2:34, 35; 1 Cor. 15:51, 52; 1 Thess. 4:15-17.)