SONG 107
Dey Show Love Like Jehovah
(1 John 4:19)
1. We dey feel the love Jehovah dey show us,
Love wey strong, yes e strong.
As e show the way, e good make we follow
This love from God wey dey im Word.
E give us im Son, im Son wey e like pass.
Jesus die for us, e go help us fit pass
The test wey dey come, and get life wey sweet pass.
We like this love, yes na better love.
2. When we don dey try to love like Jehovah,
This love go just dey grow.
We go want dey help, and care for our brothers.
Give dem support, no run comot.
If we no dey love, we no love Jehovah.
We go show our love if we dey remember
To forgive our friends, because na Jehovah
Dey show us love, so make we show love.
3. Yes, e good to love, na this love dey help us
Make we be family.
Jehovah our God, dey sofri dey tell us:
“Come make you see how love dey be.”
Come join feel the love, the love wey dey guide us.
Na the Word of God we get wey dey teach us.
Our brothers and friends, dem still dey remind us
Sey God love us, Jehovah love us.
(Still check Rom. 12:10; Eph. 4:3; 2 Pet. 1:7.)